Oga I no go too blame you because you never too understand how the market they work Na why you dey talk like this. The fact say some person sell their coin to buy again no mean say dem no get sense or no dey use their head. Take for instance this halving, some investors go sell their Bitcoin when the price dey very high and as the price dey dip dey go, dem go come dey buy to accumulate more and when the e price of coin go back to the initial price wey dem been sell, u go see say their profit don increase. Though this strategy Na for those wey don Sabi how the market dey work, because if you go miscalculate you go run on loss.