Author

Topic: 2023 Election: Plans to remove the INEC chairman failed (Read 84 times)

hero member
Activity: 742
Merit: 529
Some pipo dey wey bliv say na Dem get dis con3 4d palm of dia hands, wey Dem go just want mk tins go according to how Dem just want am. I bliv say dis inec chairmo no gree wan to dey do d tins wey dos cabals wan na mk Demtink say Dem go wan use d court tk remuv d man so that Dem go bring in person wey go hep Dem rig di 2023 election for their favor.

The truth b say even dos wey dey insid d APC wey get gud mind for naija Dem don also tire how tins d spoil and hard every day for we con3. But based on say na their party Dem no wan talk out publicly but Dem d try to run tins underground to use bring in beta pipo com 2023. See as court tk trowey d mata sef go show say pipo don tire 4dis govt n Dem need new lidas to tk repair d con3.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
No be small mata like dis o 4 Naija, I even dey hear say dem don pay some people like dis make dem go CBN office go cause trouble. Which way we dey go 4 Najia self?
Lolz... I remember during GEJ regime wey dem pay some persons make them go protest against the administration. One of the old mama wey dem give money carry placard for up with letters upside down. Abi na APC wey hire street urchins as clergymen wey dem just wear their clothes any how during the unveiling of Tinubu's vice presidential candidate Shettima. As one of my friend dey always talk say naija na cruise.


Our senators be the highest paid in the world and Nigeria dey among the poorest nations in the world. What an irony! Dem go just dey create laws wey go favour dem like the wardrobe and other stupid allowances. Make a new president takeover come talk say him want cut cost/slash their salaries, dem go just impeach am.

hero member
Activity: 854
Merit: 539
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Federal Government and it's Ministers


https://twitter.com/MobilePunch/status/1566697921806041097?t=PaOe89CG25p9QYmyQeQ8mQ&s=19

Isn't this the real state of affairs in reality, once it comes to election affairs like this, they take drastic actions against anyone who could stand an hindrance against their ambition being fulfilled, this was done in the same way when the election was close to take place and the chief justice was impeached and replaced by their own candidate they could control few years ago, as a matter of fact corruption is everywhere and not until there's total restructuring and reorientation things may continue to go as it has always been when it comes to leadership and political power.
hero member
Activity: 644
Merit: 592
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Yeah... Dem go don look for fault up and down to use comot am for office and if to say him no declare him asset correctly dem for don remove am bring in another person.
No be small mata like dis o 4 Naija, I even dey hear say dem don pay some people like dis make dem go CBN office go cause trouble. Which way we dey go 4 Najia self? Some group even dey talk am say dem won lay another allegation on Emefiele, but e fit be 4 another court and dem fit don pay dat judge. Dis go fit cause serious trouble 4 Naija like dis as people self ready to fight back now if things dey go like dis.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
The thing be say nobody can be trusted in this country again. E fit be say na politics dem dey try to play with us thinking that they are against each other and before you know their plan don work out.
Your yarning make sense, nothing wey no dey possible for this country. But I find it difficult to be believe say na film wey dem dey act. I think dem really want the man to do their biding or get out of the office.

Thank God say d guy declare in asset wey d court affirm too, dem 4 don use d excuse finish am and put their persin. Wetin dey pain me pass be say all dis people wey dey do dis bad thing dey go scot-free without punishment, how dem no go do am again?
Yeah... Dem go don look for fault up and down to use comot am for office and if to say him no declare him asset correctly dem for don remove am bring in another person.
hero member
Activity: 644
Merit: 592
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no know wetin dis corrupt people won turn Naija into, first na Emefiele of CBN, now na Professor Mahmood Yakubu of INEC. Dem sha won win dis election by force, but kudos to our Judiciary system wey still dey hold tight. Security officials wey suppose dey protect Naija with integrity na dem dem dey use to oppress people wey dey try do good.

Thank God say d guy declare in asset wey d court affirm too, dem 4 don use d excuse finish am and put their persin. Wetin dey pain me pass be say all dis people wey dey do dis bad thing dey go scot-free without punishment, how dem no go do am again?
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
The thing be say nobody can be trusted in this country again. E fit be say na politics dem dey try to play with us thinking that they are against each other and before you know their plan don work out. The best solution to all these sagas na to turn out enmass during election day and cast votes and follow it up till announcement is made. With that, I think the rigging will be difficult for them.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
Naija politicians with their problems tho... Maybe they want the chairman to do what they want not what he suppose to do.
As they see say they no get too get hope for upcoming elections that means these elections wey they come the man go suffer bedat and that's why since from now they want to remove him for office and show him they still have power to remove him for office because na them put him in the position. Make the man they careful sha these coming him go see things
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Quote
The plans to scuttle the 2023 general election by removing the Chairman of the Independent National Electoral Commission (INEC), Prof. Mahmood Yakubu, from office, failed on Wednesday, as the High Court of the Federal Capital Territory (FCT) sitting in Garki, quashed the allegations of false asset declaration against him. The Court went ahead to bar security agencies from investigating Prof. Yakubu over his valid assets declaration. In the Originating Summons marked FCT/HC/GAR/CV/47/2022 by Somadina Uzoabaka against the Attorney General of the Federation (AGF) and Prof. Mahmood Yakubu, the Claimant sought, among other things, an order of mandatory injunction directing and compelling the INEC Chairman to recuse, excuse and exclude himself and or step down as the Chairman of INEC pending the investigation and consideration of the various allegations against him by the various law enforcement agencies. The plaintiff also sought an order of court stopping the INEC Chairman from holding or assuming any public office for a period of 10 years.

Prof. Yakubu, who in his response to the allegations, furnished the court with several exhibits to show the sources of money for the purchase of the properties which the plaintiff alleged were illegally acquired and insisted that his asset declarations were validly done. In the judgment, Justice M. A. Hassan found that the declaration of assets by Prof. Yakubu was lawful, valid and in compliance with the law and that he cannot be investigated by any of the security agencies listed by the Claimant that should all investigate him. The judge declined to grant any of the 14 prayers of the claimant, declaring that the INEC Chairman cannot be removed over fabricated allegations of false asset declaration. The judge, therefore, dismissed the claims of the Claimant and allowed the Counter-claim of the INEC Chairman.

Source: https://leadership.ng/court-stops-dss-police-ccb-from-investigating-inec-chairman-over-asset-declaration/

Omo this election e no go easy ooo. The cabals are bent on doing everything it takes to swing power in their favour but God no go shame us, e go shock them. How una see this matter? Una think say the INEC chairman go frustrate their efforts with the introduction of BVAS in the forth coming election, or maybe dem don try to bribe am and him no gree or dem wan just instill fear in him so that him go dance to their tune? Another one wey dey pain me na DSS and misplaced priorities, wetin concern DSS with investigation and arrest?

Some persons been don kick against the use of the BVAS and dem been don call for the resignation or removal of the INEC chairman from office as dem claim say Nigeria never dey ripe to use the technology. The BVAS machine get the potential to enhance electoral integrity and increase public confidence in electoral process as e go help checkmate many issues like falsification of votes, coalition of false results, snatching of result sheets, computational errors and many more.
Jump to: