Positively in the sense say electoral fraud and malpractice go dey reduce, room no go dey for vote buying and corrupt politicians no go fit rig or influence election results but we to gats reason the negative aspects of this scarcity of new naira notes.
Negatively the scarcity of new naira notes fit make voters violent on election Day because as e stands Nigerians are hungry and e get waiting oyibo people dey talk say HUNGRY MAN NA ANGRY MAN. And Nigerians fit still leave the election, them fit no come out come vote because na who done eat dey get strength to vote, so this cashless policy na good thing and bad thing too for our country naija.
You have a point here brother. But e be like say you dey look the thing from one direction which e no suppose be so. I no go dey surprise say on Election Day money go just dey fall out from different angles, fear these our leaders oo, they can do the undo. All dis money wey CBN say dem dey release to banks daily, where you think say them dey go if not the politicians hands. Na dem get commercial banks and can sack any bank manager that don’t comply on releasing money to them. So don’t be surprised when money falls out on Saturday’s elections.