Author

Topic: $800m Loan to take pay 5k for six months to Poor Nigerians. Wetin Him dey tink? (Read 130 times)

hero member
Activity: 784
Merit: 589
Our country dey in a very big soup like this because our President don write another letter give Senate make dem fit allow collect $800m loan from the World bank1. Why him need the loan? He talk say him wan use the loan take pay Nigerians wey no get money N5000 every month for the next 6 months. Shey una dey see this format.
No be today our leaders begin whine us. Wetin come dey off me na how e take present the mata to look pitiful like say na presido wey get concern for e citizens. All the oda loans e collect, wetin e take am do? And 5k for each person for the next 6 months, what's the assurance say e go reach everyone if na true thing e wan do.
 One thing these our leaders dey lack nah conscience. Like this e wan run dis contri street before e Japa go the Benin e wan go. Wetin him successor go come do? Like this person go wake up one day discover say e no get contri again.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
Our country dey in a very big soup like this because our President don write another letter give Senate make dem fit allow collect $800m loan from the World bank1. Why him need the loan? He talk say him wan use the loan take pay Nigerians wey no get money N5000 every month for the next 6 months. Shey una dey see this format.
The format be say he dey fine way to carry embezzle enough money wey he @Bubu go carry hold body as he dey leave office go Daura, because I totally see no reason why person go wan take loan of $800million just to carry pay #5k to poor people for 6months, and then after the 6months, what happens next? Abi he go go borrow another $800million, and if so, how long will they continue doing so without harming the image of our beloved country Nigeria. Because this matter for sweet me for body if only the news been say Federal govt wan take loan of $800million so as to empower 500 youths in each of the 774 local govt areas for the country with the sum of $1500 (i.e #1.1million) each to carry start better business. Eh for really make sense.

Because even if na that $1500 shared to 500 youths in each of the 774 local govt area, I bet you plenty change go still remain inside that $800million (i.e $1500 x 500 x 774 = $580million)
hero member
Activity: 1400
Merit: 650
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
This is a serious trouble why would a President want to leave such outrageous debt to the up incoming governor. As a matter of fact the previous once they borrowed hasn't been cleared and they still want to forged ahead taking more loan for who and for what?
Where would 5k Naira go in this country, not even worth to buy Red meat for a family of 5 because I know what I am seeing currently as 3 we are now.
 
Well let me just land to their points, what I sense now is that they want to do their final looting.

Omo see bubu oo him wan pay himself off before him finally tuama for seat and e go better say them stop am because I know say that money no dey go anywhere at all.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
- Is this loan really necessary?
5k is of little benefit to most Nigerians currently seeing how inflation has taken over and the cost of living has increased. This is just a scheme to steal more money before they leave office, and it is not just PMB.

- Why the man wan leave too much debt for him successor?
His successor currently Is BAT (if the Supreme court does not stop the swearing in). Now let us ask ourselves if the administration of BAT will want to focus on clearing the debt from the last administration or will further plunge the nation into more debt.
You knw whatsup, until we naija stp dis our borrow borrow matter e go hard us 2 knw watin we get nd hw 2 use am develop ourcef.
Jst imagin, persn way don dey office 4 8yrs, na nw way e way e suppose commot office en dey realise say, d average Nigerian dey suffer nd 5k na en best means 2 solve d wahala.
Dis our leaders eh... I fit remember hw we carrie hope say na dis guy go end d corruption 4 d country. Hw d pipo belive in d guy 2 com wth som of en military I no send nobodi life bt still, d cartel dem way dey democratic system still influence d guy.
U can imagine d rubbish way e dey do. Lik say na dis one go do am. D matter jst cast!
hero member
Activity: 560
Merit: 624
Diz our countri matar don tire me, make I ask small question oooh, since dem dy always release dat list way dem dy say nah new year budget, like tinx way the countri wan carry money do 4 d next year way dem wan enter, how dem go carry get the moni and how dem go cari spend am, onah don c any were 4 d list were dem say diz part nah to repay back loan way we take 4 d previous year, abi to pay back debt no dy 4 d countri agenda? I just say make I ask.
Diz countri go borrow money till people way dem they owe go look am finished tell d countri mke dem supply dem anything way dem feel say go pain d countri just as China people tell Sri Lanka to carry monkey pay 4 some debt way dem dy owe them.

Me I go just pray make senate dem no approve dat in proposal, but dem fit still approve am sha, cuz dem too go get there own cut inside from the moni if eh be say dem succeed take am.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Our country dey in a very big soup like this because our President don write another letter give Senate make dem fit allow collect $800m loan from the World bank1. Why him need the loan? He talk say him wan use the loan take pay Nigerians wey no get money N5000 every month for the next 6 months. Shey una dey see this format.

Shey una don see am
- Is this loan really necessary?
- Why the man wan leave too much debt for him successor?
- Wetin really be the real worth of N5000 per month for market as at today?
- Who be the enemies of Nigeria wey dey give am this terrible advice?

Bubu wan cashout before him leave office, belike him know Asiwaju plans and him wan cashout because immediately Jagaban enter office. E dun cast for all of them, the man go run the presidency in a way nobody go get choppings unless you loyal to am so bubu wan chop him own now. Joke apart, the loan no make sense at all, why be say na to borrow to spend na wetin Nigerian sabi and this problem no dey for other politics as you go see a man wey just dey start life go go borrow money to do wedding and him go come dey spend the rest of e life dey repay the loan. Why him no borrow dat money use am run one project wey go give people job, dat one no dey their dictionary. E no go better for people wey vote this man into power.

Bubu just waste 8years of Nigerians time. The man carry us go backwards like 100 steps. Him no go fit boost of one thing wey him do for Nigerians. Na only to dey block boarder him sabi so their cartel men go get free hand they import their own things dey make money when others dey suffer. Who go pay back all this loans, him never fit give account for the previous loans wey him collect and just few days to commot office him dun rush go take another one. We need to dey prob our politicians whenever dem step down from office, e no matter the position them dey. Make dem fight themselves and expose the evil wey dem dey do Nigerians, this na the only solution to this problem.
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
Undeads.com - P2E Runner Game
This na daylight robbery, no be the same Buhari way come out last month dey apologize to Nigerians say make them forgive am for bad governance, the same man don dey find way to tiff money before e handover. Wetin happen to the operation “feed school children project” way him been say e dey do for we country, all the Abasha loot way them return to Nigeria we no see wetin this administration use am do. Them still dey borrow money ontop. The best thing person fit do for himself na to hustle get your money make all this their nonsense no too dey affect you because before change go come e go tay.
At times when I read tory about how those government officials dey tiff money the thing dey pain me like mad imagine how we guyz here dey hustle legitimately to earn a decent living and some people wey see opportunity to be in government dey squandered and spend money anyhow, hear dis one wey I read "Taraba Governor Approves ₦2 Billion For Luxury Cars For Himself, Deputy & Wives" Link this is a governor wey don spend 8 years for office o while trying to loot before leaving, but now I no dey pity anybody na we dey cause all this wahala for ourselves by not electing good leaders, the worse part be day a government wey just get few days to go wan borrow $800M wey dem go steal dat money will never reach the poor people wey need am.
member
Activity: 130
Merit: 10
Our country dey in a very big soup like this because our President don write another letter give Senate make dem fit allow collect $800m loan from the World bank1. Why him need the loan? He talk say him wan use the loan take pay Nigerians wey no get money N5000 every month for the next 6 months. Shey una dey see this format.

Back to my first comment. Why I talk say the country dey in a very big soup. See wetin director general, Debt Office of the Federation, Ben Akabueze talk about our nation’s high debt profile:

Quote
Once a country’s debt service ratio exceed 30 per cent, that country is in trouble and we are pushing towards 100 per cent and that tells you how much trouble we are in.

Shey una don see am
- Is this loan really necessary?
- Why the man wan leave too much debt for him successor?
- Wetin really be the real worth of N5000 per month for market as at today?
- Who be the enemies of Nigeria wey dey give am this terrible advice?

1. https://leadership.ng/president-muhammadu-buhari-seeks-senates-approval-for-fresh-800m-loan/#:~:text=President%20Muhammadu%20Buhari%20has%20written,the%20trend%20was%20becoming%20unsustainable.
E dey shake mind as we see our country dey waka go enter yawa financial situation nd d loan wey World Bank wan give us dey bring some kain ogbonge questions. Even as we wan help d pipu wey dey suffer for Naija wit money matter, we suppose think wella about wetin go happen for future if we carry all dis money come put for head.
E make sense if we ask ourselves if we really need dis loan cuz me I de see am as avenue to loot funds. We fit reason other ways to help our pipu without making our debt de go overboard. We suppose also think about d way wey our economy nd people go feel if we come carry dis kain debt come put for the next generation head.
As for d matter of N5000 wey dem wan give poor pipu every month, we suppose put our mind for ground look market condition to know if d money go fit help people wey need am.
Las las our priority suppose be say make we manage our money wella so dat all Naija pipu go fit benefit. Dis one go need serious thinking nd planning nd we suppose dey talk true with ourselves so dat we fit find solution wey go benefit all of us for long term.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
Shey una don see am
- Is this loan really necessary?
- Why the man wan leave too much debt for him successor?
- Wetin really be the real worth of N5000 per month for market as at today?
- Who be the enemies of Nigeria wey dey give am this terrible advice?
You know where the matter cast,
En successor no go leave am for where en stop. E go surely borrow en own to push the debt higher.
Just imagine the format? That one na em be investment abi watin... we naija just like do watin our hand never reach, dey seek life way we no fit afford and na why the thing dey always worry us.

Na so other nations way dey pay them citizens minimum wage dey do am? Na from taxes collected I get idea of. Borrowed to spend na just wasted money.

If them really wan make life easy for the poor, make them look at those things way be say, once fixed, e go affect cost through the nation. Things like fuel. Make our refineries dey function and so the little money way citizens dey generate fit dey get better value.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Nawaoo!!! Weti dey happen in dis kwantri? Why Buhari dey do dis kind thing na. Buhari na bi di real enemy 4 dis kwantri ooo. As im come board na so everything just changed from good to bad. APC government is not for di well being of di Nigerians but for suffering for the Nigerians. I no see any reason of taken another when di kwantri debt profile over flowing. Who go come save dis kwantri 4 us again?
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
- Is this loan really necessary?
5k is of little benefit to most Nigerians currently seeing how inflation has taken over and the cost of living has increased. This is just a scheme to steal more money before they leave office, and it is not just PMB.

- Why the man wan leave too much debt for him successor?
His successor currently Is BAT (if the Supreme court does not stop the swearing in). Now let us ask ourselves if the administration of BAT will want to focus on clearing the debt from the last administration or will further plunge the nation into more debt.

- Wetin really be the real worth of N5000 per month for market as at today?
Na to cook one pot of soup then chop am for one month.

- Who be the enemies of Nigeria wey dey give am this terrible advice?
The same set of people that have a strong grip on this country. The same cabals always talked about.

I remember hearing on a radio program a while ago how a government official said that the government spends 999 million naira daily to feed primary school children in the country in the National Home Grown School Feeding Programme. What a Horrible lie!! These are politicians are worse than the devil.
source
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
People wey dey for forum never see anything and them dey talk exit scam. Make dem come see the real Exit Scam  Grin
For we Nigeria, no single politician send you and people wey I they pity na people wey still use the politicians hope. Those guys conscious don die, nothing they reach their body and dem no remember say e get people wey dey find 100 naira for to take sip garri. The life no balance shaa
full member
Activity: 448
Merit: 117
Na one chance Nigeria dey so o. Na wetin we do this politicians Dem sef. Since wey him dey office him no remember to take this loan to pay average Nigerians as him dey want to do now o. Na when him get few days to go naim him want to go collect loan. Anyways make him no bother because because world bank no go reason am at all. E for remain make the use Nigerians as collateral take collect this their loan then.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
This na daylight robbery, no be the same Buhari way come out last month dey apologize to Nigerians say make them forgive am for bad governance, the same man don dey find way to tiff money before e handover. Wetin happen to the operation “feed school children project” way him been say e dey do for we country, all the Abasha loot way them return to Nigeria we no see wetin this administration use am do. Them still dey borrow money ontop. The best thing person fit do for himself na to hustle get your money make all this their nonsense no too dey affect you because before change go come e go tay.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Our country dey in a very big soup like this because our President don write another letter give Senate make dem fit allow collect $800m loan from the World bank1. Why him need the loan? He talk say him wan use the loan take pay Nigerians wey no get money N5000 every month for the next 6 months. Shey una dey see this format.

Six months? for someone who is leaving office in less than two weeks? no be propaganda be this. I read about the loan move, but the reason for it was not properly communicated to the best of my knowledge. That being said, a $800 million loan for someone who is about to leave office sounds crazy, and I doubt the Senate would approve such a decision. There is often news about the country borrowing money. I've never read anything about them repaying outstanding loans. Enough of Buhari; the country is poised to change governments, and I hope the incoming administration is better than the current one.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io

Jump to: