Ogha I no be fool to just see account then start to accuse to be alt. For this forum we don see many alt account from other local boards wey Dem go carry come out local board just to promote scam. And besides this guy own na be say, them create the account on the 1st of March and all the 3 post wey e make before I write mine na just bitget e dey promote, e just be like say e dey waka dey find place wey Dem dey talk about exchange make e for bring bitget as solution so why e nor go dey suspicious. The probability of say this na outsider too high, if to say e don use pidgin before I for understanding but I no go fit watch outsider come dey use our head all in the name of say we dey speak English for here.
I go like make you go back to em previous post( first 3) make you read and see wattin I dey talk.