Pages:
Author

Topic: Abeg all this political Mata for different threads don do. - page 2. (Read 275 times)

sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Apart from all the yeye topics wey concern elections wey some kind people dey start, e still get some other kind discussions wey some newbies dey start wey nor just go well kpatakpata, and e dey baffle me. All the yeye topics cun dey cover topics wey dey engaging wey person suppose dey shook mouth. All the senior men for here abeg, for any person wey you dey introduce to forum, try dey make dem know say nor be social media platform wey dem go just taklk anyhow for entertainment, na serious thing we dey do for here, make dem dey try bring up reasonable discussions and topics make e nor be like say na yeye talk we dey always talk for this side, if dem nor get topic, make dem first dey observe, na so fowl dey do when e land for new place, you go first stand with one leg before you go stand with two legs.
Chief na true you talk and some of this niggas really need to take some chill pills and know say life for here no be by speed, even me most times my chairman dey vex say I dey  bother am too much, no be say I no fit run am but for the sake say I no wan too make mistakes na why I dey follow who know road strictly.

I no go blame people wey dey create topics randomly especially the election related ones because right now everybody dey para so since them no see who to use the pressure follow, make dem just bring am come forum but I hope say after this elections we go resume clean up.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
Apart from all the yeye topics wey concern elections wey some kind people dey start, e still get some other kind discussions wey some newbies dey start wey nor just go well kpatakpata, and e dey baffle me. All the yeye topics cun dey cover topics wey dey engaging wey person suppose dey shook mouth. All the senior men for here abeg, for any person wey you dey introduce to forum, try dey make dem know say nor be social media platform wey dem go just taklk anyhow for entertainment, na serious thing we dey do for here, make dem dey try bring up reasonable discussions and topics make e nor be like say na yeye talk we dey always talk for this side, if dem nor get topic, make dem first dey observe, na so fowl dey do when e land for new place, you go first stand with one leg before you go stand with two legs.
sr. member
Activity: 714
Merit: 421
MetaWin.com
Comrade you this thing you talk like this don dey me to talk since. As you see this our kocak board, them don spam the board too much with election and naira swap matter too much so tey me myself I don tire.  How person go see topic wey dey closely related to wetin him want to post instead of commenting on the thread the person go open or create another thread for topic wey din already dey in discussion. The mata sef don tire person. If e go dey possible wey Dem go assign moderator to our local board immediately so that our board go dey well coordinated this spamming don too much. Make we to dey coordinate ourselves for here to dey atleast look into topics to know say this topic match with wetin we want to post then make our post for that thread instead of to dey open another thread for similar topics.
hero member
Activity: 658
Merit: 519
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Anyway sha make we just tolerant the election thread dem because na very critical condition Nigeria dey now and so many people won talk about the election. But the area of spamming na e no come make sense because na same old talk we go dey repeat.

After we hear the final result, I believe say all those election threads to stop or e go reduce so that make we see front to discuss other matters. Nigeria self to like to dey copy,copy as e dey our blood. After now,e for make sense make everything politics dey under one thread and everything economy also dey one thread to make am look legit. If you won come up with new topic wey dey similar to the one wey already dey for board, abeg just comment under.
hero member
Activity: 1036
Merit: 501
If to sae creating different topic of Nigeria election go count I for like am but as em d like this nothing the count for Naija. Even if you like scream from now till tomorrow, this our bad politicians and corrupt INEC no send.

Seriously, we suppose to the give orientation to d people wey we d introduce for this forum. The way wey Nigeria mata d take the spread for this forum d tire me. You go see how peso go carry existing discussion or mata wey the happen for our country d post am anyhow for the forum like sae our mata plenty pass others. I know sae wetin we d pass as Nigeria citizen plenty but at least make we minimize our grievances for the forum. We get social media platforms to do that.


In all of this wey d happen for this country we pray for a better Nigerian at the end of the presidential election. Na wetin I look up to
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
On the one hand, I understand wella why this talk plenty, first be say na the most important election wey Naija go don hold and secondly, the youths don wake up politically now and dem put body for the matter. So e make sense say every Tom, Dick, and Harry go get their own opinion.

On the other hand, I agree very much with Obari. Me sef don tire wella. All these threads and topics na something wey person fit still read for Twitter, Instagram, Facebook, LinkedIn, TikTok and the rest of them. I wish say we get our own local moderator wey go fit dey delete, lock some duplicate or irrelevant posts. Anyways like my grandma go always talk, dem nor dey use rush dey lick soup wey hot. We go get am right soon enough. 

Aswear boss them no dey use rush lock soup wey hot na why we just gats take things easy and also call on everyone to not spam the board as this very one fit make @theymos change mind come dey vex for us.
The forum no give any fuck about our election and no be forum we go dey do voting so I no really see any need for the unnecessary threads.

E just dey too much and na duplicate of wetin another person don post before and we too we no dey try because we dey comment on this these threads because we want make our post count for the monthly highest post for we local board. If we dey report this posts or call the attention of the posters to it, e go help to reduce spam and bring sanity for our local board.

Na the duplicate topics own dey pain me pass
Like dem no dey read to check for topics before posting ?
That's not right and make we no rush dey report as we all dey here dey hustle and make we no call attention come our board abeg.

wetin we they find na quality and constructive activities. E come be like say we just they scramble to fill up the board with posts, abeg make una stop.

Na always quality over quantity and na one value we suppose to dey instill In the minds of people and newbies and we all suppose to dey preach the gospel of quality.

I just they go through the board now and I Dey see high numbers of post relating to the Nigerian general election, it’s best that we limit it to one or two and any thing way you one contribute you fit contribute am for there.

Legit as you talk am boss and just as one person don first talk say dem no dey use rush lock soup wey hot, so I Believe say gradually we go build the board rightly.
And most of this threads and from newbies and I hope them dey see all this cautions.

Have also taught about this. Since we don't have a moderator yet here we should help the board by keeping it clean our self..
Sometimes I find it difficult to drop a post/comment because I don't really know where to add it and where not to.
Always feel free to do your things in the forum.
The only major rule the forum frowns so much at is plagiarism and we dey try build local board no mean say we all must create thread na, me personally barely dey create threads here but I know say I suppose dey very active for the local board.

The threads should be considered as spam in my opinion, election discussions should have been on a single thread. Even bringing new topic should have been on a thread.

Example is this long discussion:
El Salvador has become the first country to make #Bitcoin legal tender!

That single thread is full of many topics and replies to each topic which is about El Salvador making bitcoin a legal tender and not going beyond it than necessary.
You said it all sir and I'm sure we'll get to that very level with time.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
On the one hand, I understand wella why this talk plenty, first be say na the most important election wey Naija go don hold and secondly, the youths don wake up politically now and dem put body for the matter. So e make sense say every Tom, Dick, and Harry go get their own opinion.

On the other hand, I agree very much with Obari. Me sef don tire wella. All these threads and topics na something wey person fit still read for Twitter, Instagram, Facebook, LinkedIn, TikTok and the rest of them. I wish say we get our own local moderator wey go fit dey delete, lock some duplicate or irrelevant posts. Anyways like my grandma go always talk, dem nor dey use rush dey lick soup wey hot. We go get am right soon enough. 
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
E just dey too much and na duplicate of wetin another person don post before and we too we no dey try because we dey comment on this these threads because we want make our post count for the monthly highest post for we local board. If we dey report this posts or call the attention of the posters to it, e go help to reduce spam and bring sanity for our local board.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
My brother i tire pass you, i don't just understand how everybody wan post new thread about the election, if you wan discuss election matter, just do so in the original thread wey another person don create for that purpose, no need to start your own thread na. Wetin e mean be say many people no they read, them go just come start new topic, comot, come again start new topic, comot again; abeg e no make sense, the spam wey they this board don they too much.

Having said that, make una remember say admin been give us this local board after a very long time of asking, and if you check well the baba no they too approve local board requests, so we suppose set good example na. Activities no be by too much threads wey plenty of them na spam, wetin we they find na quality and constructive activities. E come be like say we just they scramble to fill up the board with posts, abeg make una stop.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
It’s a pity that after we struggled so hard to get our own board we would threat it this way by spamming all around the place. I still no understand why everyone think it’s necessary to start post about the election.

I just they go through the board now and I Dey see high numbers of post relating to the Nigerian general election, it’s best that we limit it to one or two and any thing way you one contribute you fit contribute am for there.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Top Crypto Casino
Just see clear example of wetin we dey talk about.



Tell me now wetin be the difference between both threads? Sometimes I dey wonder if dem nah by force to create new thread. If you nor get any new good thread idea why nor join the existing ones?
hero member
Activity: 532
Merit: 618
Have also taught about this. Since we don't have a moderator yet here we should help the board by keeping it clean our self..
Sometimes I find it difficult to drop a post/comment because I don't really know where to add it and where not to.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
The threads should be considered as spam in my opinion, election discussions should have been on a single thread. Even bringing new topic should have been on a thread.

Example is this long discussion:
El Salvador has become the first country to make #Bitcoin legal tender!

That single thread is full of many topics and replies to each topic which is about El Salvador making bitcoin a legal tender and not going beyond it than necessary.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
I just dey check local board since morning and I no go lie say I never tire because me I don tire for how everybody really just one just this election matter scatter the board with political Mata and rather than doing this spamming why we no just create on thread for political matter for presidency and when the time for state elections reach, we also create thread for each state, by so doing, the spam rate go reduce badly.

Na just my opinion, wetin una think.
Pages:
Jump to: