Author

Topic: Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems (Read 419 times)

sr. member
Activity: 798
Merit: 455
From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone.


Sometimes I dy wonda how come these Alt wey full here dy like do bad things more than things wey go make here grow.
Is like them know wetin fit spoil this our LB and them ready to do am without looking back. Me e no take me long to think am becos nah only person wey know d in and out of this Forum nai fit do this rubbish.  Nothing like I'm a newbie biko.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
The annoying thing about this user be say e no even open any thread for dis local board so at least e fit ask for pipo wey fo show am way if e no know wetin to tok! Chai, e really off me say e come indicate say BTT nah means of employment for youths for naija! What a falling of hands! We dey experience hardship for we contri but biko nah our own bad pass? I no just understand the motive of the user but nah people like this dey make me wish say person fit delete the post of another.
I don see that kind post before from oda members from different board. Although some of them dey talk how de forum don affect their life and how e don give dem a source of income based on say employment no too dey for their country. If naso the op take present that matter e for even try small, de nigga just write rubbish about him country and pipo. Even wen SC correct am, for him to lock up take correction, the nigga still dey brag say him dey earn 7 figures outside the forum, but same person don forget say him don post about quitting him job for Bitcointalk, as if Bitcointalk na job.

From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone.
Very likely... me self don reason am.
jr. member
Activity: 43
Merit: 23
Omo people dey ooo, I wonder why person go enter English board go dey make such a useless post. This user deserves a very hot slap. It's not proper to make such a derogatory post about we country. I don't know why some people behaves like goat. Them go tell una to go school una go say school na scam, now look at how the op is disgracing himself. My suggestion is that he should be go and delete the post. Someone who knows the op should pm him/her informing the person to delete the post immediately. Make we dey try get sense small. No be everything them go teach us for this life.

Wetin even make vex self na say him no gree take correction even as dem dey tell am him still dey argue join, this one na serious stupidity in a higher place. One wey understand here be say people no know how to create post to attract wetin dem want otherwise how him go just come here dey yan anyhow him like because him see say here na free place wey everybody fit come do as dem like for forum.
In fact, no be only slap him need na to just look for way limit am go even better pass why him no start from we local board to get orientation how him fit run role over here.
sr. member
Activity: 798
Merit: 455
The op no try for the post way in go make for English board on how this forum don help create employment for Naija youths. Na the person who carried him to this forum I blame because the person no guide am say this forum na where to gain knowledge about Bitcoin, to adopt the strategy in accumulating Bitcoin, and not where to earn money. The guy made it clear saying na Yahoo hustle our Naija youths be dey do before they discovered this forum and na this type of people they make why Nigerians no go freely register for here without paying a token for the account to be ready to use.

Bros no be this OP wey open that thread oh, nah another wrong man wey this current OP talk about.
And I no sure say person wey introduce Bitcointalk to that guy wey fall our hand , I no sure say the person just tell am about this Forum and leave am like that, him fit guide this guy but we all go agree say even as the guy tell am about this Forum, this guy go still do wetin dey em mind.
This thing nah personal decision becos wetin him type the person wey tell am about Bitcointalk no go dy dia to address him movement or choice of words, so I say this guy don carry our face clean ground without respect .
sr. member
Activity: 476
Merit: 316
Get $2100 deposit bonuses & 60 FS
The op no try for the post way in go make for English board on how this forum don help create employment for Naija youths. Na the person who carried him to this forum I blame because the person no guide am say this forum na where to gain knowledge about Bitcoin, to adopt the strategy in accumulating Bitcoin, and not where to earn money. The guy made it clear saying na Yahoo hustle our Naija youths be dey do before they discovered this forum and na this type of people they make why Nigerians no go freely register for here without paying a token for the account to be ready to use.
hero member
Activity: 798
Merit: 702
It’s funny on the kind of drama we meet here day by day, funny how our people no really they use their own tongue count their own teeth funny how the person way make that post just they some where cross leg they drink beer why eh they read all our post they call am rubbish funny how that person way make that post fit be say nah him alt account be that, eh fit be say the person just chop small money for campaign way eh just join for the forum and eh come make am feel say eh don arrive, small peanut eh no fit hold him joy instead him carry him self come eng board come showcase him talent way eh for they make use of for radio station.

When this person create this thread that very day, I read am even when eh just get small reply, I use my hand compose msg send for the OP for dem, even humble my self beg am to mind the mind thing way eh post as eh no go help him account reach any where at all at all, instead eh go make am feel like say nah either merit eh they beg and same time eh they rub portopotor for our face, but my G read my msg snub am still they debate for the same thread way eh create way I believe say no be just only me go don send am dm, so make I ask onah now if this person way they prove stubborn come later get issue for the forum one day we require our help him go expect people way been they talk to am way him they snub to come to him aid? Odikwapossible nah.

As I check the account never too day active since that day reach the last time I check am today, maybe eh don fulfill the mission for the day now eh don go back to him main account they chase him peanuts way they give am the Abi 6 figures way eh they brag about.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Omor who be this one na, you just come board dey come talk anyhow, na WA for una oo, to be very serious wattin that guy fo back there no make sense at all, those wey dey bring people into this forum abeg make una try teach Dem about things wey supposed to dey anonymous and thing wey Dem go talk, you know wattin men dey do outside this forum wey just come dey talk like say na for this forum you wan take live life. All these newbies make una mind wattin una dey talk oo,  this na one of the reason why Dem dey hide update, but e go come be like say person wicked.
hero member
Activity: 882
Merit: 800
Normally we no too supposed put eyes for op because we as we dey here like this e fit be say na only him or her find him way here and this na number one thing wey fit make am cap anyhow him like because I no sure say weda him know if we get local board because most of our people dey first put eye for this section before dem tuama go english board go showcase their talents but e no means say na to come open we ukwu for ijwe madu to see wetin dey inside.

So anyhow make we try go close to that person know how him or she dey do so that we self fit give am small OT wey him go carry run parole for fhis www.. although I don see how him take talk with authority for that thread meaning say him no even wan change or show sign of guiltiness say him don F for here, but anyhow make we commot body onto say here na no man's land meaning say: anything wey anybody do e dey for her head since dem no wan identify with the people wey dey here anytin wey happened him go collect I believe say e get some people wey get 3D eyes wey dey monitor people and if dem him turn em go answer query or dem knock him head him go sleep and never wake-up again.
sr. member
Activity: 714
Merit: 409
Op, I don go through the thread wey that user drop and I don see the feed backs wey em get even as you talk about am now I don see the response of our people to the post but i feel say we need to do more for our people.Even as I dey blame that user I feel say na person wey dey among us show am road for dis corner as the person for at least allow am gwt small akonuche before em create account for ram so f up dey also go to person wey help am enter rhis we corner.

Normal normal anybody way they bring person here suppose lecture am on things way they right and wrong but they thing there again be say, you don bring am in and no be all post way eh wan make eh fit carry show you first before eh go go make the post and you no go stay around am all the time to see Watin eh they post unless say you go gat get access to him account way you fit they run through the post view small small then you fit they delete some rubbish if you see any.

But on a normal how person even if them no tell am say Watin in wan do they wrong the person they chop food put for him nose ? Them no need even tell am about this things before eh go no say nah better slap to the face of their people be that Abi nah everything them they teach for school? Most of the things way most of us know today nah because we they use our own head they make some calculations if we they wait for people to always point somewhere for us all the time nah mistake go be our second name.

I no mean to insult the guy in question but as I go through the comment and how the guy carry they rap mouth about him achievement for their they self defend him self, eh obvious say the guy no ready take correction and their type fit even tell who bring them come here say them they feel say them be God make dem allow am do Watin in wan do, nah just part of life we no fit control everybody and some people behavior they make me feel like say no be every body deserve to get some kind information because them go misuse the information way you give them.
sr. member
Activity: 798
Merit: 455
Chai, nah only God knows why we no see the face of this person.
This one nah 1st class disgrace abeg. That user never post for this local board before and I believe say na one of us nai get that account, and na one of those ass licking people wey get for this local board, them ready to do anything make all those high ranked members wey dy outside to carry them along. Now see as this one don rubbish us, abi nah only we dy hustle for this Forum? Which kind unbeliever be this one nah...? This one pain me I no lie. Why him no say Bitcointalk dy create job opportunities for naija nah?
I no blame this left over wey do this thing, I blame some of us wey ready to sell out our own just to get that recognition. Some newbies no be newbie for this place.
hero member
Activity: 1022
Merit: 625
Watch&Pray.
Op, I don go through the thread wey that user drop and I don see the feed backs wey em get even as you talk about am now I don see the response of our people to the post but i feel say we need to do more for our people.Even as I dey blame that user I feel say na person wey dey among us show am road for dis corner as the person for at least allow am gwt small akonuche before em create account for ram so f up dey also go to person wey help am enter rhis we corner.

If you get students abeg try give dem good orientation, make dem dey seed you their write up first before dem post am e go help you notich things dem wey no make sense and you fit correct them and encourage them before sending it back to them, i hope say we no go see wetin i talk like insult but i feel say the person wey make that post no get good orientation and na person wey bring am enter here i go blame the person no do good work at all.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
 The annoying thing about this user be say e no even open any thread for dis local board so at least e fit ask for pipo wey fo show am way if e no know wetin to tok! Chai, e really off me say e come indicate say BTT nah means of employment for youths for naija! What a falling of hands! We dey experience hardship for we contri but biko nah our own bad pass? I no just understand the motive of the user but nah people like this dey make me wish say person fit delete the post of another.
 From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone but no mean say e come bring him sef down all in the mane of recognition nah Roll Eyes..biko, let's be guided abeg because dis other boards dey chook eye for where we dey and make we no dey give them reason to look down on us, biko.
sr. member
Activity: 602
Merit: 263
Lol everybody got their on motive  of joining this forum even though normally Shey nah that level make u join you for nor carry am go English board nah, normally nah falling hand sha if you still dey learn local board dey as a Nigerian to tey learn well nor be say u go, go other board go dey fall our hand. Before you post something mostly creating your topic try dey take your time do am research first b4 you come dey talk wetting nor follow you get even me seff den learn that is the aim of this forum to educate you concerning cryptoworld
member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.

d truth be say, I no really blame d guy, na person wey introduce am enter forum na e I go blame. I sha know say e no even still be dat one fault o becos from waitin d guy talk for there, e show say d person be dey try help e life but I swear na wrong person e go help. Since I join dis forum. I don see so many yeye people but most of Dem dey learn and na dey make Dem grow. But dis one wan con dey form jadon for forum. E even dey boast say if to say Dem know who e be, Dem for no dey follow am talk.
 If dis guy see me for real life e fit run o. We no dey brag shit for forum no mean say we no know who we be. No be forum dey feed me or most naija persons for here and e suppose dey think am but as person wey no smart, e just go dey spit rubbish commot from mouth. No body dey find e apology, becos of e come naija board na still disaster e go come create. Sha na to follow am back to back. D guy no smart at all.

Lol, this your comment funny and e still carry weight, no be lie Sha. I no go blame the guy, sapa wey dey dis country fit make person misuse opportunity, I swear. As be now things dey hard but make we just need to make the guy kno say make ihn make use of the opportunity wey dey this forum with ihm mouth closed. No be all cloth person dey sun for outside.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
Em don d like sae d more we begin not to say much about the newbies wey d enter the forum, the more they begin to talk out of point wetin no go  follow for the forum due to nobody the direct them on wetin d suppose not to post for the forum.

At times the kind post wey I d see from newbies wey identify themselves as Nigerians for this forum, d make me the wonder who d invite them come for this forum whether dem the nurture them properly on wetin d supposed to the post or not for the forum because peso no fit just wake up to create post and begin to generalized am like sae btt d serve as blessing give unemployed Nigeria youths. Like sae 200(unverified number) wey we d for this forum na all the Nigeria youths be that or em wan talk sae Nigeria youths d 200 for population. Anyway, we no go blame am sha cos the forum d open for everyone to post as em like but that one no mean sae we no go correct and caution them when they go out of lane
sr. member
Activity: 476
Merit: 308
I dey off if I dey see this kind thread them, I dey highly disappointed for that person wey make that kind thread, like can't we Nigerians comport ourselves, e no dey waste them time to begin paint us wetin we no be.
At first how dat guy take enter this forum, I dey sure say na person  fit bring am here den the person no tell am the rules and regulations for here abi himself no dey spend time read in detail more about this forum.
This our local board don dey already build better reputation for this forum, something wey this our oga dem don suffer for us to make here dey this kind active na him one new just one come spoil everything. I hope strict actions will be taken against that account
sr. member
Activity: 658
Merit: 293
Very good and valid point Adbitco, I think say na only me de notice all this kind threads. To me ba, no be by force to create thread oo, person fit just de engage for people if you no actually get important information to share because these English boards are general boards so if you come from our Nija local board e go be like u de represent us for there; so make we de very careful with what we bring in the forum, no be everything them they post. I understand say merit hunting de, but if you package and arrange your thread well with meaningful information and links, you will get merits for your effort, so make we de very cautious.
hero member
Activity: 770
Merit: 538
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The guy did not actually give a good impression for creating such a topic, and he has shown himself as someone who is only here to make money from signature participation. He basically cannot contribute to any serious and meaningful discussion because, judging by what he said already, he is only here to catch fun, and as far as I know, the community is not for fun but some serious, meaningful, and educational discussion. If he actually wants to have some fun, then he should visit the off-topic board and make some unserious topic that will not even gain any attention.

Some months ago, he created a topic where he was seeking an opinion on whether he should stop his job and focus on building his account and earning from the signature campaign.

The job he said he is earning seven digits per month is still the same job he wants to stop and focus on the forum in order to get paid.

With only 11 activities and one merit since I joined bitcointalk in January, 2023, I am currently faced with the dilemma on focusing on bitcointalk in other to learn/earn, but my current job is so exhausting that it takes virtually all my time.

Bitcointalk is the in-thing, but it requires time and efforts to grow and my Job do not give me enough time. My Job is more like 24hrs Job were I can be called to duty when I am resting/sleeping.

Do I quit my Job for Bitcointalk? (This is running through my mind)

My Job pays less that $300 a Month.

I am in a serious dilemma.

I need some motivating advice on what to do.



Some of the legendary and hero ranks on the forum are seeing more than $400 a month plus their personal businesses, which earn them more too, so what's PhilixCrpt talking about? It's just a newbie race that he is running, but whoever is his master should guide him very well because the forum is not a company where people get permanent employment.
sr. member
Activity: 476
Merit: 435
Omo people dey ooo, I wonder why person go enter English board go dey make such a useless post. This user deserves a very hot slap. It's not proper to make such a derogatory post about we country. I don't know why some people behaves like goat. Them go tell una to go school una go say school na scam, now look at how the op is disgracing himself. My suggestion is that he should be go and delete the post. Someone who knows the op should pm him/her informing the person to delete the post immediately. Make we dey try get sense small. No be everything them go teach us for this life.
member
Activity: 224
Merit: 68
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Even as we see this Nigeria finished Cus of the Economy na our government people dy misbehave every other thing set for Nigeria Good weather, no earth quake.good soil even no be poverty be our problem.but we must not bring it out other countries want to be like Nigeria,most people want to come to Nigeria but if they see this kind of post and other they will be discouraged.I understand bro let us really mind what we post.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
OP I was reading that thread with so much anger and provocation like I don't really know what some persons took this forum for, some kind of social media platform that you can say anything you like?. Just imagine what someone took to the general board to discuss like this is one of the many problems we are facing is this country, not taking things too serious that's why we have too many skit makers and content creators in this country.

This kind of threads can make some legendary to troop to the local board to check our activities here and you know what that means a very bad reputation. Well, let's be guided on things we do or say here, this is a platform that is under global watch so let's try as much as possible to exonerate ourselves from things that will tarnish the image and reputation of our local board.
sr. member
Activity: 434
Merit: 275
Enjoy 500% bonus + 70 FS
Thanks for your advice bro, I believe our newbies will learn from this thread because they think that is the best way to hustle for rank up in the Bitcointalk.org by telling lies to other people to believe that he or she is telling the truth not knowing that they knew what he or she is looking for merits in such thread.
Even @the special chemis even reply thesame thing.

that is them even know the reason why the guy post that thing.
Even as we they find way to rank up make we dey endeavour to protect our reputation . I think the hunger no be only Nigeria e dey. So make we no carry our own problem for head come dey paint 9ja black. I think 9ja don comot for the top 10 worst coutry for the world. So make we try.
sr. member
Activity: 1414
Merit: 236
VPN Friendly & Exclusive Bonuses!
Thanks for your advice bro, I believe our newbies will learn from this thread because they think that is the best way to hustle for rank up in the Bitcointalk.org by telling lies to other people to believe that he or she is telling the truth not knowing that they knew what he or she is looking for merits in such thread. Bitcointalk.org is a platform where BTC and crypto information is spread across the world which is the reason everyone in this local board and other platform are aware of BTC and crypto today before they start having the knowledge of BTC investment which is the area people use to make money to grow their wealth.

Wen I see d thread, I no say na our Naija newbies who no wan exercise patience to learn from d local board to know more about BTC before going to other discussion sectors hope dat he or she will get Wetin he or she dey find.
sr. member
Activity: 532
Merit: 250
I know say e get plenty newbies wey dey come here to come hustle but that no means say you go come blow up the cover onto say you wan earn or receive merits to just put bad records to our face. Please if i should come across such post again I don't mind reporting those as shitposting or spamming then such will be ban.  Any person wey carry you come here make him go show you road how to take talk and how to carry post because you are bring shame to our local board.

Dis user just dey talk wetin dey him mind without minding d repercussions of it. With dis write up wey him out togeda I no go talk say him no understand anything or no know wetin to talk for forum but him think say na d way him dry see things an so e really be. You wey come new to place suppose dey on a low, make you learn from the teachings of oda big members for here so dat e go serve as guide for you. Everybody love their own and dem no go enter public dey cast their own because say dem wan get recognition or some kind of favour for d outside world. As you carry d matter reach here now, him suppose don know say him no try and him no go repeat am again. Dis one na lesson for am and for others wey dey come d forum with dat kind mindset.


The painful part be say the guy no dey remorseful at all for the trash wey him post and dey even insult people wey he suppose learn from https://bitcointalksearch.org/topic/m.63320498 imagine justifying nonsense with nonsense boldly. He's not ready to learn from his actions in that thread. Nigeria is not the most poorest country and we should not be painting ourselves as the poverty headquarter in public domain. I don't want to mention names but people from some countries are very desperate in signature and bounties than the way we Nigerians dey run our affairs here.

The truth be say, nobody wan cast their self and na d best thing to do be dat if you dey public place. If no be say you talk about oda local boards wey dis things dey happen, we no go fit know because we no dey go their board and dem no dey come out publicly for global forum to talk about am. Everybody wise and dem know wetin good and wetin no good, if you go too overdo you go open your mistakes to people publicly instead bringing it to your locals to help you resolve am or tell you what to do.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
As I read de topic, de thing pain me well well. Even if our country don cast like dat no be everything person go dey cap for public space, e just be like no be everything wey dey happen for your family na him you go tell everybody wey you see for outside. Dis kind post e no go well and e go make dis guys to dey look us somehow. Just as BrainBoss bin yan for one of him post like that, wey him talk say reputation for de forum na everything. We dey try build our image here as a person and as a country, with dis kind of thing wey this guy go cap like dis, e dey dent our image. Abeg make we dey guided, make we no dey cap carelessly.  
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
make we no carry desperation and hustling for merit take spoil ourselves give this people abeg.

One thing about this kind of people be dem no waste time ban dem na dia eyes go open to start learning their corrections, anyhow e be i just post am here so dat any other person fit learn from this post but if the guy dey form donjazzy den make go him way who cares and who sabi am? Even d merit wey him dey hustle for go hardly meet am bicos him no wan follow better ways.

Lastly, make the guy post apology under this thread because we deserve it from him or her and delete that disgusting post. Locking the thread is not enough because e go dey break my heart if I waka jam am anytime. I'm very disappointed in whosoever is behind that account.

Well him no fit come here to write any apology post bicos him still dey claim right meaning say he is not ready to learn and me no even care about am rather if other reputable members do care about am too. So no reason am just let go so that we no go get personal beef with am, this forum is a free place to do whatever we want but doesn't mean we should disrespecting the entire nation in the name to seek for merits just as The Sceptical Chymist talk for him comments i really love the wey him take talk and handle the mata, this is to show say him still love Nigerians and not like others wey hate us.

I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
d truth be say, I no really blame d guy, na person wey introduce am enter forum na e I go blame. I sha know say e no even still be dat one fault o becos from waitin d guy talk for there, e show say d person be dey try help e life but I swear na wrong person e go help.
Na wetin make if we dey help person make we find smart people come here if at all you must help any person otherwise i no see any reason to carry graduated fools come full here to dey spoil we names for the forum. I believe say those people wey stick around we local board has learned something and those things dey really help them out.

I think is time we have a group outside here to know how to tackle this kind of issues of introducing incompetent people. If we go fit bring them to a group first for orientation before them register for the forum. Make una think of this idea.

Bring inside group is not the really the problems but what happened there is that this said person has refused to learn even at his rank as newbie still claiming right, do you think this rude person should be added to any group if there where any?
No! I no see am as person worth to belong to any group because na problems him/she go cause since him like arguments and na one thing wey me so much dislike even though me get that kind space to add am I no go even try am because na waste time and energy to bring such person to community group since him dey claim about his Degree meaning say people na nonsense for him eyes. Make we just free am then we wey don see this nonsense make we try make the correction before something like this go repeat itself again.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205

I think is time we have a group outside here to know how to tackle this kind of issues of introducing incompetent people. If we go fit bring them to a group first for orientation before them register for the forum. Make una think of this idea.
Na really good idea so that we fit know the person wey dy behind this kind rubbish post, but the major challenge go be how to take force everyone to be in that group and how to take punish defaulters and person wey no gree be partaker of such group.
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I notice am too say some Nigerians want come dey fuck us up for here with there nonsensical posts.

When saw that post I vex weytin no nice if you read although the thread you go see my comment. The reputation wey Nigerians get for this forum go come spoil because of some vagabonds wey no Sabi weytin to do around the forum. Normally most countries for here hate naija because of the reputation wey yahoo boys do create around Nigerians but inside here Dem never dey look us such eye buy that guy and others wan use him merit farming strategy come ruin others own.

I been think of to raise this issue this morning but you already did thank you for that.

If to say na only for local board the guy publish such thing I for reason less because people no go too see am as per say na pidgin or something else but for general board e no make sense at all the way an see it. This could bring small look at the naija board soon. 

To think of it the guy responded to my comment there trying to prove a point that his right.
Quote
Thanks so much for your comment... My post may not go well with you even though it hits on reality of things in our present state, it's undisputed that some person's have left internet crimes and focus on making legit money through this platform, however, I understand you very well, from a patriotic point of view as it involves spiling out reality even though it sounds like exposing a whole Country.

Learning is a continuous process... With all my degrees, I am still learning especially on this platform as it has to so with something totally out of my scope of knowledge.

Thanks ones again.


I think is time we have a group outside here to know how to tackle this kind of issues of introducing incompetent people. If we go fit bring them to a group first for orientation before them register for the forum. Make una think of this idea.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.

d truth be say, I no really blame d guy, na person wey introduce am enter forum na e I go blame. I sha know say e no even still be dat one fault o becos from waitin d guy talk for there, e show say d person be dey try help e life but I swear na wrong person e go help. Since I join dis forum. I don see so many yeye people but most of Dem dey learn and na dey make Dem grow. But dis one wan con dey form jadon for forum. E even dey boast say if to say Dem know who e be, Dem for no dey follow am talk.
 If dis guy see me for real life e fit run o. We no dey brag shit for forum no mean say we no know who we be. No be forum dey feed me or most naija persons for here and e suppose dey think am but as person wey no smart, e just go dey spit rubbish commot from mouth. No body dey find e apology, becos of e come naija board na still disaster e go come create. Sha na to follow am back to back. D guy no smart at all.
sr. member
Activity: 840
Merit: 380
The way I vex after seeing that post Omo na only God knows I swear. I thought it was in our local board sef when I received notification for telegram but clicking on the link, na general board e take me to. I was like no no no be Nigeria person post this but impersonator disguise as a Nigerian. Even for this our local board, that kind post no necessary at all talk more of public boards. That guy really shame us for here. I don prepare my response but the thread was locked before I should finish with what I was doing. God really save him because make I no lie, na fact I go tell am if he like make him vex.

The painful part be say the guy no dey remorseful at all for the trash wey him post and dey even insult people wey he suppose learn from https://bitcointalksearch.org/topic/m.63320498 imagine justifying nonsense with nonsense boldly. He's not ready to learn from his actions in that thread. Nigeria is not the most poorest country and we should not be painting ourselves as the poverty headquarter in public domain. I don't want to mention names but people from some countries are very desperate in signature and bounties than the way we Nigerians dey run our affairs here.

To everyone wey dey introduce people come this forum, abeg make una dey take time to guide them so we no go dey see such embarrassment because I no too blame that guy but the unguided friend wey him talk say introduce him here. Even thou na merit you dey look for, you no suppose downgrade your fatherland for personal gain. There are other ways to earn merit without disgracing us before the whole.

Lastly, make the guy post apology under this thread because we deserve it from him or her and delete that disgusting post. Locking the thread is not enough because e go dey break my heart if I waka jam am anytime. I'm very disappointed in whosoever is behind that account.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
First of all thank you for bringing this issue come inside house so we fit trash dis issue.

I want all of us to know say if we paint ourselves ugly picture outside, na so dem go take dy look all of us wey get naija blood. abeg most of this oyibo dem no see us as anything, dem believe say dem better pass us which we , we know say na lie, naija no dy carry last for anything, even though our government dy rubbish our economy, e no mean say we go dy campaign am give person wey no belong to the family abeg, just as the op don talk already, make we no carry desperation and hustling for merit take spoil ourselves give this people abeg.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I came across this post and i was touched to report it here because it's a slap to our entire board for someone from Nigeria to go make such post, I don't even know who brought such user without even giving them proper orientation. There are some post you would want to make that requires reasoning before releasing those post or even possible try consult your boss or your madam who brought you here do you think we are upto 1,000 users here or we more than?

Bitcointalk.org has become a blessing a large number of unemployed youths in most low income countries around the globe.

From my observation, Bitcointalk.org has helped in creating wealth creation for thousands of unemployed youths.

This has helped in reducing unemployment and in turn boasting the Nigerian economy through Wealth Creation.

Thanks to the originator of this life saving platform that has engaged millions around the World.

Truthfully, platforms like this has helped in reducing crime rate in many Countries by engaging mostly the young generation that would have resorted to crime.

I have seen so many struggling youths, now financially self reliant and helping others around their communities with resources made via this platform.

Kudos to the inventor(s) of this great platform. 🙏👍👏✍️

If i am not mistakenly we are only less than 200 active users who are in this forum that doesn't mean they are earning money, earning is from bitcoin investment and not bitcointalk- that is to say here is a community to get information and acts or not act according to information you get or not but for saying this forum has helped thousands of person from we kontry is a kind of slap although I can say that lots of Nigerians are into cryptocurrency investment, trading and whatever but not solely depending on this forum and even as that you should be guided properly before going out to the english board to post.

I know say e get plenty newbies wey dey come here to come hustle but that no means say you go come blow up the cover onto say you wan earn or receive merits to just put bad records to our face. Please if i should come across such post again I don't mind reporting those as shitposting or spamming then such will be ban.  Any person wey carry you come here make him go show you road how to take talk and how to carry post because you are bring shame to our local board.

Due to some things wey i see i stop to dey post here because every time na the same story, the same post with another format organized in a different ways and to me i think we are more than so let us stop to dey bring our names after we don go up finished one newbies wey from no where go just ruined our reputation this one wey every body don dey give strength say wey dey try no be where we go just come messed ourselves up onto say we dey introduced people to follow hustle abeg make una mind the kind of incompetent people we carry come here next time before theymos go vex delete our localboard oo.

I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
Jump to: