Author

Topic: Abeg my country people make we no dy paint ourselves black for outside abeg (Read 174 times)

full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Good evening my country people, abeg🙏🙏 make we no dy paint ourselves black for everyone's eye abeg, in as much as some of us dy new for this forum, make person wey bring you come try give you proper orientation abeg, for this forum we get reputation and respect we must maintain, and na our duty to protect ourselves.
Fine, we know say our country bad, but make we no dy go outside go dy campaign am abeg, many set of people wey bad pass us dy for this world, make we no dy go clean our dirty clothes outside abeg.
Anyway we carry ourselves, na so dem go take see us as, make we try, and may God bless us.

See wetin one of us go dy post for economic section of this forum,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5480521.new#new

Na true talk u talk so, no be only for this forum self, anywhere we just find ourselves, make we just try to live right and give other people the benefits of doubt too, because for some places for outside country, Nigerians no fit go dat side because of our we don spoil our reputation and e no make sense like that, no be say na our own na e bad pass, as u just talk but we too dey carry our own for head like say na we bad pass, mk we dey try to dey give ourselves that respect, no be everything we supposed to dey talk for public even for this forum self, because e go dey make us to dey look bad for other people eye.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
 It is even better that they paint it black and white so that when government see dem go k ow say weti dem dey do e no correct so dem go do adjustment for di bad bad things wey dem dey do. Me I no dey support dis our government foe anything until dem do the right thing. And foe now I want them to reduce goods and services to a bearing minimum way so dat poor people too can survive.

U know how many dey fight a day because of credit or debt. If the government is doing good things and someone spoke about am I no go gree foe am but foe now make dey pant like that and make whole world also know that this is what di government dey do to her citizens.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
You know say na over sabi Dey cause all this things, I no blame am because na waiting they happen him talk but the one wey be say him Dey mention our country no make sense at, no matter how bad a country is every citizen still Dey proud of he or her country, and all those things wey he mentioned no be only Nigeria all those things Dey, let me say it all over because no any country wey no corrupt, so no matter how bad he talk about this topic wey him post no be only Nigeria.

But the most painful one na e be Nigeria, as I talk am before, no matter how him spoil the country na, it will still be his country, and we are still proud of being in Nigeria because there are many countries that are not better than Nigeria, and Nigeria no good today no mean say e no go good tomorrow, but to be honest let know what and how we are going to talk make over sabi no let us disgrace ourselves.
full member
Activity: 770
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!

...Anyway we carry ourselves, na so dem go take see us as, make we try, and may God bless us.

See wetin one of us go dy post for economic section of this forum,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5480521.new#new

For a fact, it would take more than a negative review from a member who is expressing their opinion, to tarnish the image of this country.
Although we can't dispute that corruption hasn't taken a hold of some affairs and ministries in the country.

It would also be nice to send such a person a dm as a concerned fellow citizen and also let the person know how to make use of the local board section to express his/her deep concerns about the state of affairs of this country.

There was even a merit awarded to the poster and that's a pat on the back for a job well-done.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
It will be difficult for we not to see such things in this Bitcointalk.org because, some people created such trends for merits purpose by cooking the fake information just to make other people to believe in them that they are saying the truth  not knowing that people know the reason for such trend.

If those people bring the newbies into the forum can give them domestic orientation on how to improve in quality post without flaming fake information for other people to believe them because Nigeria is not the most corrupt country in the world and it will never be in the future.
full member
Activity: 322
Merit: 146
The thing is like a game of opposite sides and I don't blame us that publicly brings about our shits out there.
Op, can you afford to be by the riverside while soap gets to your eyes? It does not make any sense to act normal when you or things are not going normal for the caused of bad governance.
I don't think if there is anyone pointing evil hands towards individual for a public awareness Instead all hands been on deck in the national crying out loud is pointing towards the bad government in this nation so I don't think If it is worth embracing and sleep mouths shuts up without expressing how bad it feels being under an inhuman governance that we are today.

Op did you also consider the effects in disguise as our evil politicians always acting like everything needed for human resources is in accordance and claiming that the masses under their watches are being so comfortable but me awhile... We are burning and negatively infected inside.

So I the game is that the government can not act what is not real to be and we the masses can not afford to say what real is not real.

What is level of our slavery that we should not stand out to air our views, consciences and give remarks to how we are being governed? How comfortable are we to keep those mouths shut down without letting the world knows about our welfares in this country?
Why do we have to act normal because just because there are societies worse then us? So then we should also accept to fail simply because others fails too? Of course not.
If we have not been acting out loud to this extend do we believe the state of our current being would even get manageable as it is today? Of course not.
Nigeria our country deserve that bitter sabotage.
member
Activity: 70
Merit: 10
Good evening my country people, abeg🙏🙏 make we no dy paint ourselves black for everyone's eye abeg, in as much as some of us dy new for this forum, make person wey bring you come try give you proper orientation abeg, for this forum we get reputation and respect we must maintain, and na our duty to protect ourselves.
Fine, we know say our country bad, but make we no dy go outside go dy campaign am abeg, many set of people wey bad pass us dy for this world, make we no dy go clean our dirty clothes outside abeg.
Anyway we carry ourselves, na so dem go take see us as, make we try, and may God bless us.

See wetin one of us go dy post for economic section of this forum,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5480521.new#new
Omo this one is a fact….we have too United and have solidarity to be able to achieve anything as a nation and not but down accusations of other citizens in other places and country entirely.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
The rate way our newbies dey take paint Nigeria Black, e no good. say person wan grow for the forum no mean say person go spoil him reputation before you go grow. Forgetting say the black wey you dey paint us dey still affect you. because you are also not exempted from it. And  most international people wey dey dis forum don get negative mentality about Nigerians before, and people wey dey here don try to let them know say Nigeria no dey D way them dey paint am. So for him trying to buy favour from outsiders to be nice will only make him a betrayer and him go walk alone because if him don cast were him come from, when dem go posue am for outside where him go run to? Morover I don check Google Nigerian no dey Top 10 worst country again. so make this matter just dey like this. make we all they focus on how to add value to ourself rather than creating wrong impression to gain attractions.
full member
Activity: 560
Merit: 161
Honestly,  no be post like that the forum Need sef, if at all person one make that kind of post e for make sense make e be local board to discuss things like that about our country so that people wey no from naija  no go fit understand anything wey we dey talk about the country.  This na one of the reasons why we get local board,  so that even if we dey talk matters concerning our country e go hard make pthe people understand.  Make we dey try to dey think twice before we make post.
full member
Activity: 196
Merit: 123
Wetin dy worry me most for all this kind of thing is that, as we don dy spoil our reputation by ourselves like this, wen we travel abroad, mostly to the western part of the world, dem go just dy dey very cautious wen it comes to us, because dem go don dy see us as corrupt set of people, dem no go just trust us even though dem know say we get good one's among us.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Wetin the person wey make that post think say he go achieve for that thing wey he write. You come place to learn bitcoin matter you leave that one wey you go put your eye, na yahoo and hookup dey pain you. Person wey won change him society nor go do wetin you do so. I been never see the tori before, but as our person post am here I go observe am. I see as the talk dey go even brah like @smartvirus dey collect one or two unto the matter. Everybody dey free to write wetin sweet am for belle, we dey only beg you say make you think am twice before you post.   
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Infact @Funke, go too far for dat thread wey im start, she no get any justifiable reason to paint di county black as you talk, evendo say na true say corruption too much for di country. As corrupt people de na so incorruptible people also de, but to generalize the whole country as corrupt no go do us good for di forum. Wetin worry me pass for di thread be say people from oda countries fit to de tag we Nigerians for di forum as people wey de corrupt for dem mind, because for a forum like dis reputation matter well well.

I de happy and I commend you OP as you put di record straight say no be everybody corrupt for di country, I see say members from oda countries also make Funke, to understand say corruption no de peculiar to Nigeria, alone. I believe say na over excitement say make im impress for di forum make am go dat far, hopefully she go do don learn her lesson from her post and she go de apply wisdom for her posts henceforth. Nobody is above mistake.
full member
Activity: 266
Merit: 113
Good evening my country people, abeg🙏🙏 make we no dy paint ourselves black for everyone's eye abeg, in as much as some of us dy new for this forum, make person wey bring you come try give you proper orientation abeg, for this forum we get reputation and respect we must maintain, and na our duty to protect ourselves.
Fine, we know say our country bad, but make we no dy go outside go dy campaign am abeg, many set of people wey bad pass us dy for this world, make we no dy go clean our dirty clothes outside abeg.
Anyway we carry ourselves, na so dem go take see us as, make we try, and may God bless us.

See wetin one of us go dy post for economic section of this forum,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5480521.new#new
you know go too blame am. The thing is that we've become too used to speaking negative things about our countryy and whenever you think in making any list concerning Nigeria, it's always the negative side that always comes to out mind.

We know say we get issues and the truth be say no be only us get am, so many other countries de when de battle this challenges and as we de too loud our own, e no go help us in any way.

This one no be person when bring am come the forum fault bros, you know go expect the person to de monitor all him post as him go also get one own stuff when de keep am busy, maturity de expected of every member of the forum and we need learn to keep some things to ourselves. If you no get important thing to post, reply to peoples posts and don't make it a necessity to always post and thereby tarnishing the image of the country you are suppose to be protecting in the process.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
I no really understand watin we mean when we Dey say cast ourselves. I like it when people talk true shah but, some truth Dey completely over exaggerated and ma that one I get wahala with. When person Dey present something like say en Dey at the forefront with evidence to prove something and e never see nothing.
E forget say, na all this write up both on forum and off forum Dey contribute to watin Google search engine go sum and present as a truth about a nation? When you don talk bad for here, talk am for the other place and then others Dey carry am, e sum up to make statistics on watin Dey go about.

E get any nation way no corrupt or nation way no Dey do bad? Dem know watin them Dey call pimp for US? Right from the days of 2pac in the 90s and it existed even before then.
Still, you no go find people Dey jump in here to write about am or make noise on am. Na the small one we Dey learn from them we go con Dey loud am like say, na our own bad pass.
This our loudness no suppose reach everywhere shah. We no really bad as most people Dey present am.
Nigerians are good people, na just few persons bad.

Abeg, make these Johny just come Dey try take an easy. You Dey rubbish full country to get 1 or 1 merits and you no Dey get any. Watin you archive with all those degrading post? Absolute nothing, abeg make una try Dey think before una write and releases certain contents.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Actually wattin you talk na true oo, we nor supposed to cast ourselves for outside like that. Even if say na true the guy been dey talk, at least that na why we get local board wey we go fit use take discuss our problem dem the wey we want. some persons no understand the work of house, house na primarily for protection, but for literal term our elders Dem say e dey cover many things, so that people for outside no go dey see everything wey you dey do. Anyway the bitterness why dey em heart naim e don pure so, but na for the wrong board. Wattin dey bad if e carry that thread come here make all of us shook mouth put? Some person na builders while some na destroyers.
newbie
Activity: 16
Merit: 0
True talk!, he for make sense if we fit cooperate solidify our good reputation
full member
Activity: 196
Merit: 123
Good evening my country people, abeg🙏🙏 make we no dy paint ourselves black for everyone's eye abeg, in as much as some of us dy new for this forum, make person wey bring you come try give you proper orientation abeg, for this forum we get reputation and respect we must maintain, and na our duty to protect ourselves.
Fine, we know say our country bad, but make we no dy go outside go dy campaign am abeg, many set of people wey bad pass us dy for this world, make we no dy go clean our dirty clothes outside abeg.
Anyway we carry ourselves, na so dem go take see us as, make we try, and may God bless us.

See wetin one of us go dy post for economic section of this forum,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5480521.new#new
Jump to: