Author

Topic: After halving, waiting be the sign (Read 149 times)

legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
January 20, 2024, 04:04:17 PM
#14
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.

To begin I'll say the bull markets starts when the price begins to recover from its lowest point but many people think it's when we hit a new ATH. If you invest at the lowest price of Bitcoin and the market recovers to the previous ATH you dun already make so much gain wey be say you no even need to wait for a new ATH to sell and make profits. Even before the halving we go get some bull run but the thing be say after halving, the fomo dey come much wey be say the price of Bitcoin go come reach a new ATH.

I no go advice make you dey wait for signs of a bull run before yo invest in Bitcoin because by the time that signs go dey show it's already too late but e no mean say you no go fit still profits but I dey try talk say we supposed get in during the bear market and not to wait for signs of a bull market to get in. I no go talk talk all this without giving you some insight too on how to identify the bull, just dey monitor the market you see anytime wey you just begin dey see careless altcoins they pump anyhow and everything dey green for a very long time, just know say we dun dey enter the bull market as new money dey flow into the market thereby e dey pump the altcoins them and Bitcoin isn't excepted. The time wey we dey look na 2025 but the bull run will be going on before then although na 2025 na when the peak of the market go dey as usual.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 20, 2024, 03:25:06 PM
#13
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.

After Bitcoin halving, the block reward for miners go become half, i.e from 6.25 BTC to 3.125 BTC. The law of supply and demand go come take effect, as the supply reduce and the demand go increase, this go help to drive the price up. When we enter bull season, dem no go announce am for news lol. Na from the market you go know, the market go turn green, the price of bitcoin go shoot up and other altcoins like ETH, SOL, BNB, XMR, XRP etc. go follow experience price surge.
My brother no be small, because no body go announce for anywhere say the bull run don start but the wave wey e go cause for the crypto market nai you go take no say the bull season don reach because the price of Bitcoin fit jump go up well well and this na the reason wey dem dey always advice now to start the hoarding process because when the price rise their is high possible say e fit even touch 100k so if you plan well from now the next bull fit be of better benefit to you well well.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 20, 2024, 11:19:15 AM
#12
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.

After Bitcoin halving, the block reward for miners go become half, i.e from 6.25 BTC to 3.125 BTC. The law of supply and demand go come take effect, as the supply reduce and the demand go increase, this go help to drive the price up. When we enter bull season, dem no go announce am for news lol. Na from the market you go know, the market go turn green, the price of bitcoin go shoot up and other altcoins like ETH, SOL, BNB, XMR, XRP etc. go follow experience price surge.
sr. member
Activity: 532
Merit: 250
January 19, 2024, 06:12:34 PM
#11
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.

I neva experience this halving before too but base on the experience of those wey don witness am, dem no need tell you say bull run don come. With your two eyes dey look chart, e go just dey go up non stop. You fit even sleep wake up see say bitcoin don move beyond wonders and altcoin go they follow dey pump with am. The thing be say now, nobody knows when the bull run go take place but it is certain that e go happen after the halving. Hold your bag tight and secure it with everything as you won’t want to miss out on this bull run.
sr. member
Activity: 476
Merit: 299
Learning never stops!
January 19, 2024, 05:36:48 PM
#10
There's no sign than Bitcoin is still volatile  although I'm also looking forward to experiencing  in as a first time experience though but i think after the halving Bitcoin should become much more scarce as the FOMO increases from time to type  so we could also experience a little  bullish in my opinion though can't  really assure that and this doesn't mean we won't have dips but it should reduce a little compared to bullish market.
Remember, this are all just Speculations  and they might not really have effect in the future or even  take place ,  the best choice  is to continue  practicing HODLing
hero member
Activity: 700
Merit: 577
January 19, 2024, 05:28:00 PM
#9
After the halving na di bull and the sign go be the rising of Bitcoin price. The dip go come before the halving and within di halving. And after the halving the dip go still stay small then bump, it will rise to the ATH. And if you look well now in the market you will discover dat the market is about nto start di bear market. Bitcoin was on the $47,000 and instead of going up, it comes down and now it is $41,000.

But di price might go up again before di halving but I doubt. I will want everyone to save now so you can buy di dip in the halving time.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
January 19, 2024, 01:44:12 PM
#8
Bitcoin Price prediction no dey like football predictions, although e still dey every hard to predict football too but at least e dey more easier to predict when some strong teams won play against some teams wey no dey strong and defensive like the strong team.
So Bitcoin price dey very hard because e no get time for am to increase or decrease.
Moreover, I never witness any having or any bullrun, but based on some discussions way we dey see for Bitcoin discussion board, I dey feel am say nah just the normal things way they happen before nai go still happen but if in any way things go change, nai be say Bitcoin price go high pass the way wen e been dey high.
So the best choice for every individual way dey into Bitcoin investment, nah just for us to buy as much as we can to buy plenty Bitcoin and hold am untill then, and anybody way no know watin em go use em profit take do make that person continue to dey hold am.
sr. member
Activity: 546
Merit: 342
January 19, 2024, 01:21:24 PM
#7
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.
For me I know say before the halving or after the halving a short dip fit occur for the market and na after that slight dip then sign of the bull market rising go come dey show but I no go lie, am not too specific on the exact year sha but I know say the main bull run fit come during the late period of this year entering into the new year of 2025 and although me I don talk say dat small dip wey supposed come na another opportunity sef to take use strangle up some more coins because me sef wan follow benefit from the bull run wey I don dey miss before.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
January 19, 2024, 01:13:58 PM
#6
But weti you take start the talk me I think say you know the signs oh because u say after di halving e go take time before the rising of price go start , and that means you don experienced am before. Well dis matter wey you bring an only those people wey been dey the cryptocurrency scene from 2018 nai go fit give you the konkon because dem don experienced the bear market and the bull market in 2021. And people like us we never experienced halving and dis is one wey dey come nai be di first one I wan experience. So no too much input for now. But when the bull market wan take start, di price go dey increase day by day. And you too you go confirm am syndi bull e don start because everyone go dey talk am for here in the forum. And mostly in the speculation board.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
January 19, 2024, 12:55:22 PM
#5
To know the signs of bull run after halving go hard oo, as be be say dem no dey fit predict the market movement so, thing dey happen differently. Just like after Dem approved the Bitcoin ETF wey we think say na bull dey come, the next thing no be price correction back to $42k naim we see, now sef e don even go down to $41-$40k. So the market fit move opposite to our predictions. Though I never experience the halving before, but I believe say the bull run go definitely come after the halving. But make we no even think of to wait till we see sign before we start to buy oo. Now wey the price don go down small naim be the best time to buy more so that any small increase go dey give us joy.
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
January 19, 2024, 11:59:57 AM
#4
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.
I never witness any halving before, and I no sabi how e dey be, but plenty people don dey talk say we suppose see bull run after halving, but me I no sabi any sign wey go dey before bull run, but if we wan accumulate coin, the best think na make we do am before halving, make we no dey wait for sign before we go invest in coin. Na y if we go invest, make we do am with any money wey we no go need for now, because people just dey talk say bull run go come after halving, but nobody dey sure of d particular time wey d bull run go come, if you go use money wey u go use in d next few months or weeks go invest, thinking say before u go need d money, ur coin go don pump and u go don make profit, e no really make sense, because when u go need money fit reach and u go dey at lost.
hero member
Activity: 896
Merit: 586
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 17, 2024, 04:07:16 AM
#3
After halving happen we know say e dey always take some times before bull run which is unpredictable to some extent, but at then waiting be early sign the market wan start the bull run.
Make una talk from experience, make people learn because me know say some people fit keep mind for early 2025 make the thing go happen b4 then or after that time.
I never experience the halving event before, but from my little understanding, after the halving, the moment bitcoin price come start to dey go high and high without correction. If the price don come reach 60k, make you know say the bull run dey for your eyes Koro Koro. Actually, nobody fit tell when e go happen. This na the reason why if you won sell your bitcoin the next bull run, make you get price target, so that if bitcoin reach that price you go fit sell and take profit.

However, we dey expect the bull run next year 2025, but anything can happen, and the bull run fit start towards the ending of this year, but I dey hope say na next year. Some people go forget themselves for the bull run because of greed, them go want make bitcoin price reach their own expected price and before you know am, the new ATH go dey look them but them no go know say na the new ATH for them to sell, them go miss out due to say them want make the price high pass like that and before them go know the bear market don catch up with them.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
January 17, 2024, 01:34:51 AM
#2
Factors like ETF may make the bull to come while others, later than expected but the bull may likely come around ending of the year or 2025.

The truth is we can't actually get the precise moment for when the bull will start after halving but one thing we know is that when the bull comes, we will know  Grin
member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty
January 16, 2024, 05:49:43 PM
#1

Jump to: