Una Good day oh, just as the market dun dey turn green small small, the whole altcoins bullrun talks dun dey come back. I just dey scroll over twitter and na so so speculations I dey see over there. I say make I bring this opportunity to the house so we fit share one or two projects wey we dey personally dey look into wey be say we we love. Before I go forward, I just wan use this opportunity use warn everybody, make you no take the suggestions wey you dey see here as investment advise. None of use qualify to advise you on how to invest as we just just dey talk from our own mind, on how we dey see the particular project. Wetin I invest in succeed fit no be wetin go blow you therefore always do your own personal research and make sure na you dey take the decision to invest and not following anybody blindly.
Also make sure you get security in Bitcoin, asin before you dey wan invest in any altcoins, make sure you get Bitcoin as na the only reliable cryptocurrency be dat and no be joke. Every other coin fit just disappear from the market but Bitcoin na baba and him no dey go anywhere. Lastly no forget to take profits, no go believe any altcoins die. Next ten years, you dey see that coin wey everybody dey dread, e fit be say him dun die or nobody dey reason am again, so no marry any cryptocurency, just see them as partway to your financial freedom and use their heads.
Now to my projects of interest, I get two for mind wey I dey observe very carefully, they're ETH and BNB. My speculations are atleast 10x for each of this coins which means the least 10k investment na 100k cashout etc. Why I dey monitor this two be say Ethereum obviously go dominate the space again since Solana dun dey shake and BNB go follow am for back and if the government no go over attack BNB and with all the burning then dey do, $3k per BNB go dey very possible by 2025 and $10k ETH. Wetin you think about this prediction and wetin be your own or any other coin wey dey ur mind, wetin be your prediction come next bull cycle.
Bitcoin is a sure one and good for people wey get plenty money. For those wey get small money, I feel say some altcoins them fit dey good because if you are lucky you fit get coin wey go give you x10 when BTC still dey consolidate. The problem be say, risk plenty for altcoins so it is good to do tight research before choosing.
Personally, I dey look at $Life Crypto. Na GDA Captial get am and them dey build wallet wey go dey like Metamask and wey fit do plenty other things wey Metamask no fit do. So, I get some confidence say this one go pay but make you do your own research before you enter o...