E get wetting I dey always observe this days from people. Many people dey like to comot without their ATM card for pocket. and some wey dere own don expire no dey even reason to request another one from bank, because them get mobile banking app for phone forgetting say emergency fit come up at any given time wey you go dey stranded while you get money for bank.
Make I take myself for example, e get the day I go pH go buy something. So along the line agbero snatch my phone from me unknowingly and everything dey inside the phone and I get ATM card with me. I been wan comot without ATM, but I just say make I carry am along. So as the phone lost I just use my ATM card to withdraw and continue with my activities plus my TP, if not how I for do am? Because even tp self don finish for my hand because of change of price on transportation. Maybe I for turn begger for street dey find TP because how to contact person for be problem. Expecialy when person no no dey close to bank.
So make we look into this matter, because some things wey dey common fit mess us up when we least expect. So wetting ona think about am?
this one just de like say na me you de talk to aswr!
I don fall my own hands plenty times for this matter no be play. I don de too used to using my mobile banking and for that reason since my atm expire, I never use atm again. I don get so many experiences when I don put myself in toght corner because network to de to access my app and I no de with cash at all.
E get one day I even used all my last cash pay tp enter one place hoping say I go withdraw money for their use buy something then still keep some for my transportation. To my greatest shock, as I each their ma him network comot for my phone and no way to withdraw money again oh! I waka around find network tire I no see shishi.
An better lesson I don lean so and I don de make am compulsory say I go always de with spare cash when ever I'm going out but I guess I still have to work on sorting out at least one atm for cases of emergency.