I Dey new for this Bitcoin stuff and I don dey hear about am for a very long time but I no really know wetin e dey do or contain, I go dey very grateful if una fit help me with material wey to help me understand this stuff well
I just dey see your post today, and me self go like welcome you to d forum even as people don welcome you before. Make sure say you read the forum rules and regulations first before you start to dey post ooo, make sure you don’t go against the forum rules and regulations, because they get some offense wey be say dey no go forgive you, na either make dem ban you or make dem tag your account, and if you don post anything for the forum, even if you delete am, dem get how dem go see am, so make sure say you check anything wey u wan post well first before posting.
Make I come back to your post again. You talk say u don sabi the forum for a long time and u no sabi Wetin e dey about, I don’t really know how you got to know about the forum, but bitcointalk na place wey you fit easily learn about bitcoin and cryptocurrency in general, and if u sabi your ways, then there is room to be earning also.