Author

Topic: Another wahala wey we get (Read 33 times)

sr. member
Activity: 224
Merit: 195
October 08, 2024, 11:15:37 AM
#1
Are we facing the wrong people? Many saga's done dey happen for this fight against Dollar to Naira rate to the extent where be say many crypto users don dey affected. Worst of it be say, our economy don really go bad with all fingers pointing at the black market with the conversion rate when be say wetin follow they affect us just dey corner dey operate silently and no governmental body go want talk about am because i believe say dey get hand behind everything.

Our broda VDM don come out talk about how this called customs dey operate when e reach time to clear imported goods, the matter be say this people dey clear on dollar rate not just that of bank rate but dem dey use black market dollar rate which make am higher and more expensive to do so. If everything come join as this traders go also want top up the fee to cover all expenses and last last na still we wey be the consumer go still suffer the cost because na we be the final stop.


This na matter wey they supposed look into, i know say the oga dem follow for wetin dey xup but na very disturbing and deliberate activity wey dey cost every individuals for this country to pay direly coz as e be Nigerians we mostly depend on import to survive and by the time dey don add money each time mean say price of goods go also increase for market. Customs don pose lots of threat for our economy using the Dollar against our Naira, this has done more harm to our survival and high time we talk about this, so something can be done.



Jump to: