The only way me I dey see say government fit tax crypto exchange na when dem get physical presence for Nigeria but if dem no get den all this tax discussion no get point because how you go tax wetin you no fit control. Binance no get any physical presence for the country to tax am and dem dun disassociate themselves from any institution wey dey claim to get affiliation with them (I remember them calling BinanceNG a scam). It isn't a lie dat the government get plans to do things wey go get negative impact to the crypto market for the country but if you dey use decentralized service you no get problem because nobody go know say you dey do cryptocurency unless na you open your own yansh. If you dey use DEX, government no go fit tax you and some CEX self no go gree unless dem begin block IP address as dem do with twitter. E just dey like Binance exchange now, dem get the popularity they need already in Nigeria and mightn't be interested in opening a physical headquarters here when dem fit do am for neighboring countries and still get big patronage from Nigeria.
I like wetting you talk here. Why CBN partially ban crypto currency na because Dem no fit regulate am due to de decentralized nature. But if binance and other CEX exchange want to make government bring there mind for this thing, na just to open braches for the country just like banks. Because Nigeria na top 10 country wey dey adopt crypto currency according to news. and which any financial institution should be flexible, reliable and trustworthy. I believe if CEX exchanges open braches I believe all this matter no go dey like this.
For the blocking of IP address that one na small thing na. online VPN them dey way no carry Naija location.
This na wetin me I want, we're too backwards when it comes to decentralization in the country, the things wey we dey use dey think say we dey use decentralized platforms aren't even totally decentralized. Me I want make government make all the centralized services wey dey operate for the country unfriendly so our attention go shift go decentralization and we fit improve that sector better because e go favor many developers wey go launch their dApp and dem go get interested patronages from the citizens of the country and no be now wey na VC and big investors go determine if your project/company go do well based in funding wey you go fit use do marketing and sell your product to the masses.
One of the problem wey make people no dey too dey use DEX exchanges na because e no dey provide merge for p2p transaction, on like CEX wey dey provide emediate merge for p2p and make trading fast and easy. But if Dex app wey ft do the work of Cex exchange fit come out by developers like you said I think mass adoption go dey and people self go dey happy to use such exchange.
Even say such exchange come out e go still dey centralized. Reason because for any exchange to be trust worthy for merging p2p, e go requires centralization.