Author

Topic: Bandit kingpin with sacks of redesign naria note. (Read 55 times)

member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 07, 2023, 04:02:55 PM
#5
Nothing dey surprise me for naija again because anything can happen, we no need pastors or anybody to come tell us say all this Politicians dey connected to this bandits Dem, na this bandits Dem dey do illegal jobs for this politicians nai make you go hear sometimes for news say bandits killed or kidnap some persons somewhere and when this things happen, government no go do anything Dem go dey on television dey talk plenty, Las Las wetin you go hear be say na unknown gun men na do attacks.
My question be say Dem no dey arrest this unknown gun men, abi this unknown gun me na ghosts?
 Dem no go even do proper investigations, my people na politicians Dem give bandits that new naira notes, na politicians dey buy ammunition for this bandits Dem too...
hero member
Activity: 574
Merit: 627
For this one countri notin way no go fit happen, eh get the Tori way I read 4 one of diz our countri new site. Were the kidnapers reject 5.3 million naira way victim people carry come for them say the money nah they old note say them no fit take am, say if them no go fit provide the new one make them carry the money use buy them food stuff and drugs before them fit release their family way them hold Source.
This bandit them way get this new note, make eh no surprise you say them first everybody get money, becuz nah still same high officials way we call representatives nia they sponsor them, so the money go reach their hand, them no need stress their self.
member
Activity: 308
Merit: 26
This our country naija things they happen and this one wey bandit kingpin done dey with sack of old naira notes, some men in the government are really the onces sponsoring this boys and now they have given them old naira notes ,
Now there is naira scarcity and a criminal is holding the naira notes in excess only God knows how to bring us out of this situation.

They empower criminals how on earth will that money get to him if not that our government gave it to him.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
This kind news no dey surprise to us for Nigeria again, we don see all this kind of things many times before for Niger, our leaders know where the new naira note dey and they will pretend like they are all innocent, upon all the suffering and all the problems we dey face for Nigeria, people still get mind they give bandit money and I fit even swear say no be bandit get the money, it will be our leaders that gave them the money to hold, Nigeria needs prayer with Good leaders.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
https://www.thecable.ng/bandit-leader-flaunts-redesigned-naira-notes-claims-to-have-plenty-in-sacks/amp
Kachalla Baleri, a bandit kingpin terrorist
Omo check out this news,we the good citizens dey here dey suffer for CBN redesign of Naria note to circulate and this  don make so many people no get access to their money especially those people wey no fit do transfer. POS operators find am hard to meet up with their customers demand,because if you go bank on top the small money wey bank go give you,bank go take their own interest. CBN say na cashless policy we don dey practice but me I feel say na only poor people all this their law and policy dey affect.

Make Una see Bandits wey dey inside bush get excess of cash in sacks of the new Naira note and them dey even use am brag say them still use the new Naria note buy ammunitions. My concern be say who give these bandits them all this cash and how come we the ones without gun no fit get access to this redesign note. I see say all this new things na because of election. See the kind leaders wet we get na only themselves and their family dem dey after.

Jump to: