Good morning my lovely people I say make i bring small update come board small I no know weda una don get the information wey federal government dey talk say
all commercial banks go shut down for 24hrs in celebration of 63th year anniversary of our 9ja comes on October 1. But the shutting down go dey effect on Monday 2 October.
Now my concern be say, our independence fall on Sunday why federal government want stress people with their issues and even though say every body I mean, all sectors go obey the independence why them wan include banks how business people go do am. I no know why this our new bubu wey enter sit wan make him own things dey different.
Abeg wetin una fit yan for this matter e go or e no good?
I no really see this news as anything sha. Not anything negative. I know everybody get him own opinion when it comes to things like this and everyone go want make him/her opinion carry weight. But thing be say, i no really see wetin dey wrong for this matter, since na human beings (Nigerians) too like you dey work for those banks and dem too need rest, and enjoy the rare joy and reverence wey such event they bring once in every year.
October 1st na the day wey Nigerian collect freedom on top white people wey come colonize us move our properties dem, legally and illegally go their own country to go develop themselves con leave us inside the mess wey we dey today. At least, Nigerian people, our leaders of then, who are the very true-spirited leaders wey we get dem, stand up against those oppression con help us collect our independence, diplomatically.
I believe say October 1st na one event way every brethren and progressive Nigerian go dey happy about. Hence the cause for the public holiday. So, I personally no see anything wrong with them closing for just 1 day. No forget say, even as them close, them ATM booths still dey open to collect cash.
Thank Almighty say we also get access to cashless society where you fit do virtually everything for your phone and POS, if you are left with no other option – in worst case scenario. So for somebody like me, I no really see any problem inside so far as dem go leave cash inside their ATM machines for that day.