As CBN don already talk for their cashless policy, ATM go stop to give out 1000naira and 500naira while bank go come limit how much peso go fit withdraw for inside bank. Day and weekly withdrawing of 50k-500k per week
em go make much sense make we familiarize ourselves with the bank USSD code wey d much faster for electronic payments. Bank USSD code no need data or airtime to run am. wetin dem d take run am na your phone number wey you activate for bank via receiving of bank alert
link for information: https://www.legit.ng/business-economy/money/1513106-cashless-economy-full-list-nigerian-banks-ussd-code-electronic-transfer-internet/
Las las all this things wey dem puting in place say this and that them don dey adjust am small small inside this TINIBU tenor, for that line wey i mark RED ehh, to be honest wey get business people wey dey make huge amounts of transactions for business, person no go wan reason the stress say if all thing wey CBN dey try put in place say him or she wan dey go bank go stand for crowd.