Normally normally we are talking about to buy Bitcoin now but this evening something came to my mind and I will like us to talk about it and also be aware of it too.
The things way i won talk be say, as the bull dey front dey come, e go good if those way done invest for Bitcoin earlier this year and way back dey careful this season and the whole of the next year and after, because I really believe say plenty of scammers go dey more active to dey find those way them go scam (more especially Bitcoiners).
As e no go dey good if person sweat go just enter into the hands of scammers nai make me say make I drop am here but if this kind of post already dey this our board or outside the board abeg make una tell me so that I go lock am ASAP.
You no need to lock your post because the post carry weight and e dey very informative to everyone here. One thing with dis scammers be say ba, as new ways dey comot to take combat dem from scamming people, even dem too dey get new ways wey dem go take scam their victims the more. All dis tins na because of d newest technologies wey dem come always. Most of dis scammers are more educated dan us but one things be say make you know the basis of security and not to expose your self to the digital (online) world too much. Remember say anything wey you no share online, nobody go fit get access to you talk less of scamming you. A word is enough for the wise and when the wise obeys it becomes a lesson and a more wiser person in the future.
I dey come across some post like sometimes and I think anybody wey don dey forum for long go understand waiting we dey talk here, na only the beginner's abi newcomers na them go get issue with the matter wey we dey talk, to every newcomers, waiting we dey talk here be say this life no be waiting we dey think, you go work and person go wan chop you clean mouth, as e dey now anybody wey dey hold bitcoin for hand now should be careful, no share your details for anybody, no trust anyone, no follow anybody wey tell you say if you bring small money within 24 hours you go make am, no follow anybody wey instructions say make you click some links say they get waiting wan happen to your bitcoin say na them be agency wey go help you, all those things na scammers, make i just call am fraud, so make everybody shine their eyes.
All dis ones no be new method wey scammers dey use scam their victims. This ones don cast and dem don upgrade pass like this. That being said, newbies go still fit need dis one if dem never know about all dis scams before since I dey sure say anybody wey no be newbie here or new to the online digital world, dem for don understand all dis scopes wey dis scammers dey use to fraud their victims. Technology don go far the way we dey think am now, make we just dey careful with anything we dey do online. Na d place to learn new things to make yourself better but d same time, the place dey very risky too so make you know how to trail for dis kind place wey go fit make you lose everything within minutes.