Author

Topic: Be Creative And Not Formulative (Read 161 times)

member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
March 10, 2024, 06:32:56 AM
#16
I don notice plenty things for the local board and I don try to correct most people like me for the forum and local board, say no be to just wake up write any lie wey dey your head thinking say the lie go fetch you merit, people here don get plenty experience and so those things wey them think say na new lie say no body go know, the forum don last for over 15 years now and those lies people don tell am before us am make merit so now the people don wise no matter how you frame your won lie Dem go understand say na that type of lie wey dem don see before.

My concern be say anytime wey I correct person them go shout say na bully or them go use that opportunity chuck me say me too I be newbie for the forum, na true say I be newbie but e get some things wey I understand and I naim mane I dey tell Dem but them no go ever agree. but any ways I know say for this LB or forum self I dey among the youngest so if them like make them do anything wey dem like I go still dey at advantage because I go learn fast pass them.

So people here dey create but lack guardian, if people wey sabi for here dey guide person well omor some people dey very brilliant enough to make good post. but as you talk am na to dey creative no be to lie full ground.
full member
Activity: 378
Merit: 182
Play Bitcoin PVP Prediction Game
March 09, 2024, 02:44:25 PM
#15
True true, the rate of lies when de for the forum no be here oh! And the funny thing be say them no de creative at all when it comes to creating post that lacks originality. Although e de for this board but from my observation, e plenty for other board pass Nija board. Boards like economy and beginners and help get plenty fabricated stories when from first look, you go just know say this story no hold ground at all.

We know say we all need merit to enable us rank up but their are better ways to go about it rather than creating real life stories that are false. It's even worse when you see someone creating stories that he used a whopping sum of money to buy bitcoin when if you look at it in the real sense you will know that this is purely false. The thing about this kind of fabricated story is that it can make a reader to make an hasty decision that could affect him negatively because he feels what he read is actually true.

I don't know why people are doing all these, they forget that lies are always identifiable, if someone lie about a situation or things, every board here has intellectuals so such lies might lead to serious problem on such person side, there nothing to lie about here.
This forum is informative and it is a learning ground too so what are we lying for, is it not better to learn and grow yourself in a sincere manner than lying and at the end of the day get your account tagged, I come to conclusion many people here are not grounded enough to be a member of this forum because the are too in haste to attain success but they have forgotten that this place is meant to be followed by process to actualize our individual goals.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
March 08, 2024, 05:43:04 PM
#14
The lies wey dey go out from here e don dey too much and because of dat many of our brothers and sisters e don collect weti e no good like neutral tags. Nai make I say make I create dis thread to help those wey their own na to lie to hunt merit. Make tell una, if you go lie make you dey creative, make u no talk something wey big pass you. Wey ordinarily we all know say for we country dat kind thing e no go happen. And u come make am say e happened. And wen people see dem go attack you. See dis place na just creativity and not formulating lies. Read other people threads and know how dem take make to that level, and creatively, you do yours and become di man of the forum. Me I learn plenty things from our naija brothers dan di outsiders.

No lie and do am real. I dey like won guy here, oh Jesus Christ di guy w dey creative. And if you dey creative to rank up e no go hard you. Let me tell una threads wey full ground wey una never write as newbies or beginners. And if u really want to write, things wey e dey around you nai u go use am create thread and tell use weti happened concerning cryptocurrency related matter dem. No lie and just be creative den butter nd bread go full ur head. Read, learn and be creative. Nai be di konkon. Go do am den come back nd greet me. Read di successful hero and legendary Members here in di local board nd learn from dem.

You need to know say, there is different between lie and creative. So choose di creative and not di lie.

My brother no be small, I think say na only me this matter dey pain like this oo. Wattin dey give me joy na besay, as Dem lie, na so them go dey kack Dem tag, so that make them know say wattin Dem dey do dey bad. This forum no be for place for fake people, this na place wey men with wisdom dey make good post, and if you like be like Dem, the only way na to learn from them. Concerning those wey dey go outside dey go talk laolao about this country, eyes dey watch una, and the more lie and stupid post you make, the more your account dey chase merit away. It's as simple as that, I no see reason why you go cast your own, because of merit, and the worst thing na be say you no go even get merit from all those kind posts sef. This forum na for the smart and sound minds.
full member
Activity: 154
Merit: 107
March 08, 2024, 11:40:44 AM
#13
It is very obvious that everyone is accepting the fact that being creative is the key, and that is true. The country we live in has made citizens understand that it is not about words, quality speech, or academic excellence but about someone who is smart and thinks outside the box. Most companies are looking for smart people who can be very creative in every opportunity that is given to them. So i also agree with you, OP, that being creative in whatever we are doing would elevate us because that is all we want.
member
Activity: 168
Merit: 75
March 08, 2024, 11:02:42 AM
#12
Na true, person need to dey creative because as e be like this for us, that is as things be so, problem here and there plenty, if we dey creative we go dey help people in one way or they other like to use am create job opportunities for people wey no get any source of earning or to they take care of themselves, also with that means too, we fit they impact knowledge they give other people so that them fit learn too to help themselves and the society, rather than being formulative because as the economy be like this for Naija, to get certificate no really matter o, because even if you get, to get job go still dey hard and e no dey really pay o and go dey only dey rely on monthly salary but when you dey creative, you fit they work still dey use your hand work as side Job, by like that things no go too hard for you.
full member
Activity: 140
Merit: 63
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
March 06, 2024, 10:44:10 PM
#11
Wettin you talk na true, most newbies dey creat lie lie thread to gain attention for merit hunting to runk up but forgetting say the room dey smarter than them. As you dey talk, people know say you dey talk truth, as you dey lie people still know. so the best thing to do na just to dey natural no point for lie. Even say you wan lie make your lie no dey obvious. Even say you wan lie you fit dey do am for were the oyibo dem dey but for we 9ja here before person dey read your thread finish them we don know we're you dey land. That is why most of this newbies wey enter new wey their blood dey hot for merit dem go leave to make post here dey go talk about we country 9ja for english board dey think say dem go give them merit not knowing say those men too dey sharp to the extent wey be say if na merit hunting post dem go tell you ho-ha say na Merit fishing thread so make we just dey careful as we dey lie to gain attention. The room dey transparent than glass.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
March 06, 2024, 05:42:56 PM
#10
Creativity all di way
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 21, 2024, 05:56:01 AM
#9
Creativity nai be the konkon for the forum. Many people just dey formulate stories wey e no dey get head. See make I tell you, yes I fit manipulate story but make di story e dey realistic. Even in human life na di combination of fiction and nonfiction. Life wey no get fiction, e no dey complete. But those fictions na to make a compliment to di real life. Make una go read stories in di forum una go confirm am. No be say I dey talk am ordinary. Most of di threas wey I dey see here sef e no dey creative na just be say make we dey help. If u produce creative something, I dey tell you, u go get di marits wey u need.

No be say I dey attack you but I want you to do well.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
January 20, 2024, 02:40:37 PM
#8
As you talk na true matter you talk and I go like go through senior men them threads to learn more, concerning the lie wey people dey yarn for the forum dey take earn merit na serious matter sha cause some go get merit while others no go get, na here the creativeness take come and who sabi think fit create ideas.
Sometimes when I read the stories I dey know say na lie but this forum na every man for him/herself so nothing concern me but the problem make people no too know us as Liars cause na one person dey spoil full community name and e no good if we get that kind reputation.
jr. member
Activity: 112
Merit: 4
January 20, 2024, 01:52:23 PM
#7
Every great man today in this world e.g satoshi Nakamoto - founder of bitcoin, mark Zuckerberg - CEO Facebook, Elon musk - CEO Tesla , Bill Gates - Microsoft, Aliko Dangote -CEO Dangote group etc born out there great empire through creativity, it's always worthy to be creative because creativity is always celebrated. So in all you do concerning this Bitcoin forum learn how to be on your comments, reply and topics on how you feel, see things and experience them don't  formulate your comments,topics or reply at least it should be what people can relate to, ask questions and gain understanding, rather than formulating . Because one might reach out to you through this bitcoin forum and with expectations but if you have formulating  you can defend your self.
As we are here  in this bitcoin talk forum, we are here to learn, teach and relate to others in the forum through our experience and what we know especially concerning bitcoin. Soone should be creative rather than formulating there topics and reply.
full member
Activity: 182
Merit: 152
Never give up
January 20, 2024, 12:27:50 PM
#6
///////
I no see anything way person go take use lie wen we wey be em fellow Nigerians no go no say na lie.
I done join this forum since August 4th but I been no really dey active because I been dey handle one or two matters that time, but after that when I con decide to dey serious so that I go fit learn about crypto currency way be Bitcoin, I con grow faster and if any of you go fit use small of una time check Una go know say constructive post and activeness na dey make person dey rank up fast.
Moreover, no be everybody comr here to dey constructive, some as soon as them just get small knowledge about cryptocurrency them go just leave the forum because them done get watin dem they find, but some based on some of the opportunity way them get them no go like leave but stay and gain more crypto knowledge.
E dey good to dey constructive because e go make sense wat be say anything way person write others go fit relate with am and also add their own lines but when e fin be say person no dey do the way em suppose to dey do, just like to dey lie or try to spam, then that time othets go won try to they ignore me person.
And this ignore matter na watin I dey always fear, because no body knows who go help am for this community tomorrow, so when person start to dey do rubbish and others start to dey ignore am tomorrow when em go try to change from em past behaviors em go still dey ignored if the person no comot am from the ignore list, so the only way to prevent one self from being ignored by other members of Bitcointalk is for them not to lie and post or say something off topic in a thread whereby the discussion is serious.
full member
Activity: 266
Merit: 113
January 20, 2024, 12:11:32 PM
#5
True true, the rate of lies when de for the forum no be here oh! And the funny thing be say them no de creative at all when it comes to creating post that lacks originality. Although e de for this board but from my observation, e plenty for other board pass Nija board. Boards like economy and beginners and help get plenty fabricated stories when from first look, you go just know say this story no hold ground at all.

We know say we all need merit to enable us rank up but their are better ways to go about it rather than creating real life stories that are false. It's even worse when you see someone creating stories that he used a whopping sum of money to buy bitcoin when if you look at it in the real sense you will know that this is purely false. The thing about this kind of fabricated story is that it can make a reader to make an hasty decision that could affect him negatively because he feels what he read is actually true.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
January 20, 2024, 11:36:13 AM
#4
Normally if we see story topic wey dey true we go easily relate say na truth the person dey talk. Yes, d as i notice the forum don full with fake fake story line and unrealistic imaginations from people wey dey find merit bad bad. Which e no make sense at all. Nothing bad if person just be himself and share they share information wey be say na the koko, people for the forum go understand and if they helpful or educative members of the forum go merit am asap.

E make sense say you con talk am for our LB so tha tour brothers go avoid those kinds of things. Make we no go use our head put ourself for trouble. Also make we no forget say smart people they the forum, if they notice any suspicious activity or misinformation dey no go hesistate to tag the account. My own na make we just avoid any wahala and make we focus on making organic comments.
Dis this wey you talk dey sweet me for belle. When I started to join dis forum people dey call me dey tell me say I took dey talk di reality, I come dey tell say let dem leave am. And when I come dey get merits dem come dey call me say make I show dem di way, my broda ma there is no way but only be creative then e don finished. People just dey tok weti never even happen or exist. And if you want to tok dose kind tok dem then you can use demo as a creative writing and not the other way round. Yes true tori dem e no dey hard to know but fake ones e dey obvious.

How we dey take dey know di fake Tori dem. Dem dey wear over size stories. Na so we see dem.
E make sense say you no takae any of their criticism to heart instead you carry am set as climbing stone wey make you come dey post quality topics and commnet for the forum. Now see the level you done feach, some person ho they wonder how you take do am. Yes o, at first wey we enter the forum so we no too dey familiar with the way e they go so small small mistakes they come out sometime. But this thing no suppose stop us to learn. E no dey difficult to they creative. Ah no no why e they hard some persons.

You know say i dey see some kind topic wey be say the person you english grammar finish work but last last the main idea of the topic no they communicated to the audience. Weting con be the point of all those plenty plenty talk na. People con they bash am for there so e go write weting him self no understand.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 20, 2024, 07:28:47 AM
#3
Normally if we see story topic wey dey true we go easily relate say na truth the person dey talk. Yes, d as i notice the forum don full with fake fake story line and unrealistic imaginations from people wey dey find merit bad bad. Which e no make sense at all. Nothing bad if person just be himself and share they share information wey be say na the koko, people for the forum go understand and if they helpful or educative members of the forum go merit am asap.

E make sense say you con talk am for our LB so tha tour brothers go avoid those kinds of things. Make we no go use our head put ourself for trouble. Also make we no forget say smart people they the forum, if they notice any suspicious activity or misinformation dey no go hesistate to tag the account. My own na make we just avoid any wahala and make we focus on making organic comments.
Dis wey you talk dey sweet me for belle. When I started to join dis forum people dey call me dey tell me say I took dey talk di reality, I come dey tell say let dem leave am. And when I come dey get merits dem come dey call me say make I show dem di way, my broda ma there is no way but only be creative then e don finished. People just dey tok weti never even happen or exist. And if you want to tok dose kind tok dem then you can use demo as a creative writing and not the other way round. Yes true tori dem e no dey hard to know but fake ones e dey obvious.

How we dey take dey know di fake Tori dem. Dem dey wear over size stories. Na so we see dem.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
January 19, 2024, 07:25:16 PM
#2
Normally if we see story topic wey dey true we go easily relate say na truth the person dey talk. Yes, d as i notice the forum don full with fake fake story line and unrealistic imaginations from people wey dey find merit bad bad. Which e no make sense at all. Nothing bad if person just be himself and share they share information wey be say na the koko, people for the forum go understand and if they helpful or educative members of the forum go merit am asap.

E make sense say you con talk am for our LB so tha tour brothers go avoid those kinds of things. Make we no go use our head put ourself for trouble. Also make we no forget say smart people they the forum, if they notice any suspicious activity or misinformation dey no go hesistate to tag the account. My own na make we just avoid any wahala and make we focus on making organic comments.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 19, 2024, 05:40:56 PM
#1

Jump to: