This na serious mata guys, we dey see how many influencers the spring of in the Nigerian scene well many of them dey entertain us no doubt and there is nothing bad with all that, I am a big fan of comedy content and I have followed many of the social media content creators that entertain me with comedy videos and as they get popular they want to monetize their talent well that's not a bad thing.
My issue here be say many of this content creators then turn to social media influencers and not just that they influence platforms that pays them without even checking wetin them dey influence, the result is they get richer and their followers who joins such gets hurt.
No matter how you like or enjoy any content creator this does not make them genuine, they get paid for everything they endorse (it's not free), if you must use what they endorse always make sure you do a very extensive research about it.
Na so e dey be. Make we say plenty of these things are caused by the proliferation and non-regulation of the contents that are flown over the social media platforms. The ministry wey supposed to dey at least checkmate these things for the masses no really dey function like that, for that reason, plenty people dey see say dem fit advertise anything wey dem bring come for them, especially as far as money go dey involved. Dem no wan do plenty research on the standard of the company wey them dey advertise
They're called influencers not financial advisers so make we no dey believe everything dey post blindly without doing our own research. If dem talk say A na black, no just believe but do your own finding before you believe dem. This guys are hustling, most of dem are newbies like us but dey just have a large social media following so dem dun take dat pros become influencers.
Even when dem dey free like the project no pay dem for the promotion wey them dey do, no forget say most projects get a referral commission program wey anybody fit use to make money from affiliate marketing. E just dey like 1xbet wey we dey see many influencers dey promote, most of dem no get any official partnership with the company but just affiliate marketers that get paid through referral commission so make we no dey believe anything wey we see.
Your first paragraph dey so, so give me joy my oga. But the truth be say, even many of them dey put am as disclaimer say them. Them no be financially adviser,, so make people no dey take their words serious since them. Having said that, plenty content creators no dey do better background check on wetin dem they promote for social media and na that non- charlatan attitude na him make dem no dey care. We don see plenty situations where influencer go dey write long note from lawyer say him dey disassociate himself with product. And na why I fit agree say, Although Davido and Wiskid dey collect adverts too o. But dem dey do proper investigation before entering into working for them.
The investigation part is very necessary because no be every social media promotion person suppose put hand in. This na one reason besides the fact say government want control the citizens, wey make them say them want make every social media account dey registered.
Cryptocurrencies na the trend for most young guys when you ask them their hustle, but watin dey more common na this shitcoins vendors wey fit carry person money disappear at anytime.
Most of the promotions on social media serves to help the popularity of cryptocurrencies surge on social media platforms, thereby creating a correlation between social sentiment and crypto price fluctuations.
Crypto vendors like Binance, luno, paxful, Coinbase, only do well to ensure crypto buying and selling or facilitate transaction Payments and should be well known before using them.
No be issue of say my favorite celeb dey advertise one crypto vendor wey just start business, then I go just rush go begin use am. Many of the influencers no dey even use the vendors them dey influence.