You do well and this news dun dey for the media for sometime now as e get when the SEC been dey worry Binance based on this their BUSD mata and e belike dem been call am an unregistered security. Binance come say no be dem self dey issue the stablecoin even though e dey bear their name. The mata come out around February this year and maybe this na just steps wey Binance exchange dun dey take to protect their customers and also to comot for the SEC lawsuit wahala because if dem prove say BUSD na security and Binance exchange still dey parole with dem e fit pit dem for big wahala.
The mata na true and Binance been dun dey offer the swapping BUSD to other stablecoin service. Also I been dun dey get notifications of BUSD pairs been delisted from Binance exchange since and other services wey person fit do for the exchange with BUSD has been slowly removed. Binance dey take precautions make e no cause price to tank due to panic as any harsh moves wey dem make go fit affect the market and they'll be held responsible. Already Binance dun send notifications say; Binance Encourages Users to Convert BUSD to Other Stablecoins Prior to February 2024 and this one na information directly from the official Binance exchange support page.