As e be now, people Dey fraud with clear eye and traces without anybody even doing as much as to cough talk more of when a more anonymous system Dey invoked.
Omo, Nigeria need to fix systems like the judiciary and the armed forces before we go look towards legalizing anything. At least, make fear of these frauds Dey and not just within those kind men them way Dey use am cash out.
Meanwhile, that one nation don accept am no make other nations bad or behind in there plan for the country. Nigeria still better and na when you travel you go see.
Omor, I no sure say this country fit fix anything again oo, our judiciary now, as e corrupt reach I no sure say we fit expect to see any changes, Dem wey naim be our hope before say dem nor dey side anybody if them dey make judgement, but now with your money you fit even win the impossible case for this country. Now wey dem don legalize am, make we see their real intent weda na to kukuma finish us or weda na good plan make we see, but we pray make e be for the betterment of the country and the citizens, one of my padi sef been dey say, as Dem don remove the ban say na to carry tax for transaction take kill us be their next plan.