Author

Topic: Bitcoin price predictions on di short term no too de necessary for bull run. (Read 54 times)

full member
Activity: 224
Merit: 195
I see your very points, whether we get to speculate or not e dey very absolute say we go observe the bull run and our investment go grow and yield better returns. Despite anything e good say we take priority to accumulate and top up our Bitcoin portfolio instead to just they watch dog our investment but not forgetting e also get importance as to why speculation for the market they important, na say e dey help increase the buying pressure wey dey also involve to make the market greenish but not applicable to those interested in making quick profits and speculating the market just to get a good entry price for their trading benefits. As long the motive na for the long run, we are expected to calm from  every speculation and predictions.
full member
Activity: 294
Merit: 215
My take on all dis questions about predictions of Bitcoin before and after halving, weda we go see new ATH dis year and many prediction prices for dis bull run, many of dem no too de necessary, if na long term investment we de do. Why I talk so be say so fa we de hodle Bitcoin for bull run matter, wey just de start, we no suppose de worry about di short term price pump and dump. If we get faith say we go see massive bull run wey go give us plenty ROI, no need to worry about short term price movements. Na to focus on wen price go reach the estimated peak of bull run, wey be from $150k and above . How una reason di matter?
You don already talk am finish, bitcoin price prediction no dey necesary for people wey dey hold for long term. People wey suppose put eye well well for price prediction na people wey dey do day trading for bitcoin. Me I no fit give person mind make him enter bitcoin trading because e dey risky, make person no lose all him money untop greed. The ogbonge way to take follow bitcoin na to buy and keep am tey so e go fit vomit beta profit. Plenty people dey like buy plenty when the market fall well and them go hold am reach when the price go begin go up well well.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Na to focus on wen price go reach the estimated peak of bull run, wey be from $150k and above . How una reason di matter?
There is nothing much to add because you are correct. Bitcoin long term prediction is easy to analyse and more accurate than short term. Short term prediction is used by traders but trading is very risky. For holders, long term prediction is better. But if you bought bitcoin and the price started to decrease, it is not advisable to sell your coins at the time if you can hold it long term. Bitcoin will still get to all-time-high and I also think that bitcoin will get to $150000 or more.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I don notice many threads for different boards inside di forum wey de discuss and ask questions about Bitcoin price predictions, some of dem na weda price fit to dip reach $50k and bellow before halving, others na weda different price fit to happen wey go pass $72k before halving. Some threads na weda price fit to reach $100k dis year, some na wetin go be di new ATH price for peak of bull run, plenty oda questions wey concern Bitcoin price as we de enter bull run.

Jump to: