Author

Topic: Bitcointalk.org na the only legit Bitcoin forum wey Satoshi Nakomoto welcome. (Read 23 times)

member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Additionally, scammers/hackers use alphabets that look so similar to the original one to confuse people when making fake websites for instance -- Bitcointalk.org then it would be spelt in this manner [/B] Bítcointalk.org [/B].

Hackers/scammers use the following alphabets : ìîïīí - óôöòøōõ -- àáâäãåā -- éèëêē -- úûùüū

When this alphabets are used it doesn't show much so people do fall for it but you just have to be more vigilant.
member
Activity: 322
Merit: 70
I dey create this thread for members of this forum wey feel say every Bitcointalk forum na legit,most especially the newbies.When dem tok say Bitcoin hack dey vast,hackers no exempt bitcointalk.org accounts,the reason why most members for dis forum don lose their account na because say dem go log in and create account for another fake Bitcointalk forum.I no go too blame newbies because dem no know the origin of bitcointalk.org,if dem know say na only one bitcoin forum Satoshi create dem go reason am say other Bitcoin forum na fake.Satoshi welcome dis forum on the 22 Nov 2009, before em welcome dis forum dem be get one existing Bitcoin forum wey dem be dey call Bitcoin.sourceforge.

Fake Bitcointalk forum na strategy wey hackers dey use hack bitcointalk.org members account.As we dey this space na to get the right information nai matter pass because misleading information don too much.E dey very important to know the domain name of any website wey you dey look for,funny enough most newbies no even know say the domain web address na Bitcointalk.org,so any web address like Bitcointalk.com, Bitcointalk.gov, Bitcointalk.net na fake.Nai make dem dey advice us to double check URL because every URL dey unique nai make hackers no dey fit get legit website their URL,dem only fit manipulate legit website their URL;
1.Dem dey add their own words to the URL.
2.Dem dey misspell the URL.
3.Dem dey add periods to the URL.

Dis Bitcoin forum wey na Bitcointalk.com na fake Bitcoin forum so any body wey get account for Bitcointalk.org wey go sign in/log in for dis fake Bitcoin forum fit lose em account.
E get the way you go search bitcointalk.com make your browser correct you,to show you say bitcointalk.org na the koko.


Sources
https://bitcointalksearch.org/topic/the-most-iconic-bitcointalk-threads-history-on-bitcointalk-4322078
https://bitcointalksearch.org/topic/steps-to-check-potential-phising-links-5130231

Jump to: