My question looking at this news and the state of the nation where nothing is working such as refinery and others infrastructural development that generate fund for the nation, is not working will there be government again as foreign debt, pensioners labour without means of paying back.
However, even if say government borrow money dey invest e no still dey proper because no investment dey guarantee for this life, both Bitcoin, real estate, gold or any other things wey you know of. And again, I no sure say both me and you know watin these governments and em pipo dey use this money wey them dey borrow do.
Me.. I dey ur side, I agree wetin you talk, na only God wey dey see everything both in secret na e just know wetin them dey use the money wey them borrow for, because even before this our current president enter sit, plenty money wey our previous president dem borrow wey they no fit pay, tinibu say na e go pay am back because e get money, na e make why almost everybody vote for am, so that e fit help us pay our debt but now reverse is the case, who even know whether e dey plan to still borrow, to still dey increase the debt and make we no surprise say e go still keep am for the another president, if e comot for sit now and yet, things go just dey as e dey, no improvement of anything like Job opportunities, good security management etc