E de beta say dem suppose de use bitcoin wey de decentralized, for forex payments, instead of dollar wey de centralized.
This one nor go happen. E dey too risky because government go lose their power and control over the people. Which country one allow am happen.and also how Dem go take balance the volatility wey dey in the use of Bitcoin?
1. Bureau de change: this system go totally phase out, because you no need to convert your money to dollars before you go fit to make international payments, na just to transfer bitcoin, directly from your wallet to your customers abroad.
2. Convenience: if you go for marina, for Lagos island, you go see as hundreds of people de queue, something's de fight for line because dem wan buy dollar. Bitcoin go eliminate di stress of fighting to buy dollars.
3. Banks as intermediaries: no need for dat one again, na to just run direct bitcoin p2p or through exchanges.
4. Multipurpose: as you de use bitcoin to make international payments, even wen you travel go another country, you no need to exchange bitcoin to dem local fiat to take purchase commodities, na to de spend bitcoin de go.
5. No barrier: bitcoin no get any centralized authority wey de control am , unlike dollar wey be USA private property.
Aldo di disadvantages wey follow bitcoin be say people and countries never adopt am finish and im still de new, compared to dollars wey don stand the test of time. Me I de hopeful say one day bitcoin adoption go reach every corner of di world and based on say im de decentralized, im go be di best option for foreign exchange international transaction payments. How una see am?
[/quote]
Na only for utopian society wey this one fit happen. For Naija. Never. You suppose Sabi say e get pipo wey dey benefit from this use of dollar. Dem go fight am.
E go good make you still list the disadvantages of the use of Bitcoin for the country so that we go get a balanced view of am.