Author

Topic: Buhari tenders apology to Nigerians as tenure comes to a close (Read 28 times)

hero member
Activity: 784
Merit: 589
 I say make I bring this one here make we discuss and air out our opinions on this action wey our soon to be ex president, Muhammadu Buhari take on Friday when e go on e Twitter page dey apologize to Nigerians say make dem no vex unto say e fit don wrong pipo due to the way e take dey rule.
 Now, most of us fit agree say ever since e enter office 2015 nah so so wahala the contri just dey face; Insecurity just dey get bad by the day, corruption dey flow, economy no dey beta. Amongst the top pipo wey see this apology like scam nah the African Action Congress presidential flag bearer for this election wey pass, Omoyele Sowore.
 He go ahead to list all the bad tins him (Buhari) put the contri through and tok boldly say e no see reason why Naija citizens sopoz forgive am afta the pain e don cause them.

 How una take see the mata? Wetin the president do nah somtin wey dey necessary or e just dey make matas worse. Or as oyibo go tok e action nah example of 'no use crying over spilled milk?'
link here
Jump to: