Author

Topic: Buying stocks on Bamboo app versus buying Bitcoin to save as a beginner. (Read 42 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
Leave di bamboo stock app and focus on bitcoin. Bitcoin na one investment wey go last forever so di small wons wey dem don teach you make you carry am go learn more for here so you go dey do well for one corner. Weti I go advise y be sae, make u dey eye other piple post 4 like two weeks den start make contributions (comments) and ask questions wey u no understand so piple go help u. Na so we take learn too. And one thing u supposed know be say, bitcoin investment needs patient.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
My man which one be bamboo again? Me I never hear dis one before make una no vex abeg I never hear am before. Well in whatever way, you no go compare bitcoin with di bamboo. If you have the money to buy buy bitcoin make u do am sharp sharp now wey bitcoin e dey some low. Very soon di guy go go up wey u gede enjoy. And for u to learn more here if like reading.
1. https://bitcointalksearch.org/topic/unofficial-list-of-official-bitcointalkorg-rules-guidelines-faq-703657
And if like research
2. https://www.investopedia.com/terms/b/bitcoin.asp
You can still use the google search engine to navigate the net to get more information about bitcoin. Feel free to participate with us here.
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
una go fit advice me which between buying stocks and shares on bamboo app versus buying BTC and holding it fit make me richer in 2year time frame?
There is no complete certainty with any investment, but if you start investing today, in two years time it is possible that you will happy you made the early choice to start investing. Before people start to dey invest in bitcoins, people been dey invest in stocks before, stocks from better companies. Na because say bitcoin dey very volatile and person fit make high profit na part of the reason why dey make people dey gather here now. You still invest in stock if you like after better research, but on your own side try make sure say you still get investment in bitcoins because to an extent na In sure pas.
jr. member
Activity: 118
Merit: 4
Una well done o, I get one thought wey dey my mind on investment. Na about buying stocks and shares from any company using maybe Bamboo app versus buying Bitcoin to keep with any exchange wey dey sell.

My neighbor before he travel out, been dey tell me how e take dey invest in bamboo by buying stocks and I been ask am if Bitcoin no pay pass. Na em even dey lecture me on Bitcoin matter most times, but then my head no really carry the language until recently.
I find myself in the midst of so many persons wey dey use am one way or the other for their benefits and inorder not to dey left out I begin show interest, na em lead me here.

Abeg, before my hand go strong for the Bitcoin matter, wey I go begin trade or use another strategy to earn, una go fit advice me which between buying stocks and shares on bamboo app versus buying BTC and holding it fit make me richer in 2year time frame?

Thanks
Jump to: