Author

Topic: Can anyone explain this (Read 67 times)

sr. member
Activity: 854
Merit: 451
May 16, 2023, 04:49:50 PM
#8
I will advise you to change that Bsc address and use Electrum bcos there are some apps dat bring up unnecessary adds to wallets.
If you check the account well, you go see say him dey use the account for bounty, I dey sure say na for spreadsheet dem copy  d wallet dey come send d token to random people. You no expect say person wey dey use account do bounty go dey use electrum wallet now, na the best wallet wey him fit use for bounty na Wetin him don dey use be that, the only thing wey him go do na to no just swap those tokens make him just leave them like time, i dey sure say with time him go still receive more tokens.

Those messages they are sending are from scammers and if you click any link there the coins which you have in your wallet don go be that.  
If you read the post again, you go see say no be message d Op talk say him receive, so no be link him talk say him receive, na tokens him talk say him receive for him bsc wallet, and I no dey sure say dey fit attach link to the token wey dem send to wallet, so make u just check am well again.

As 4 me I never see am before so knowngunman dey say na normal something sef, I Kno Kno am.
Na true knowngunman dey talk, like say you never run bounty before, if you don run bounty before you go understand Wetin knowngunman dey try talk. If you dey do bounty e dey normal say you go see those kin token for your wallet, but make we no just swap am ooo.
full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
May 16, 2023, 03:04:17 PM
#7
I think, you have used dat wallet address to apply for bounty campaign that mak d bounty manager to have access to your wallet address because dat is were all those tokens use to come someone wallet dat make some people to feel are scammers. But you can reject such tokens because  u have full authority to ur wallet address, if u wish to stop such tokens in ur wallet by changing the wallet address at the moment.well, u don't need to worry too much with such issues op, because sometimes it may be some of the work u have done in the past that made dem to send u d tokens for ur reward.
hero member
Activity: 1022
Merit: 744
May 16, 2023, 02:36:03 PM
#6
Una good day my country people, recently, I dey notice say some kind token wey no get name they hit my BSC wallet address and them always they write phishing and scam for the front. Abeg anybody fit explain wetin the sender they try do?. If this thing dey dangerous, abeg wetin I fit do. Dem don send me 4 token wey no get name than "bep 20 and phishing , be careful on how you relate with this token "
Those coins wey you de see en, na scammers de send dem to random BSC wallets so dat if you attempt to swap am with some of your personal details involved, dem go use that chance take get access to your wallet come de do wetting them like.

I will advice yo to always avoid any coin wey be say no be you buy am if you see dem for your wallet, because me self no know how dem de run am, even if you change wallet, dem go send come dat one again.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
May 16, 2023, 12:08:22 PM
#5
I will advise you to change that Bsc address and use Electrum bcos there are some apps dat bring up unnecessary adds to wallets. Those messages they are sending are from scammers and if you click any link there the coins which you have in your wallet don go be that.  Ignore them, the sender dey try to lure you to dem so dem go scam you di way dem been dey do for Watch wallet. And make you too no go enter places wey u Kno Kno. As 4 me I never see am before so knowngunman dey say na normal something sef, I Kno Kno am.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
May 16, 2023, 11:08:40 AM
#4
It depends on the places you visited and where you often post yur wallet address to, there's no way for you to receive a token into your wallet address without having any connection with the sender, though it mean nothing and can not harm you as long as you don't drop your wallet private informations to them on request, but you also need to be careful, things can go shady enough to get one hadked through any means they can come up with, don't also leave your address open to the public, I've not received any thing of such from my end.
sr. member
Activity: 798
Merit: 364
May 16, 2023, 09:48:23 AM
#3
Una good day my country people, recently, I dey notice say some kind token wey no get name they hit my BSC wallet address and them always they write phishing and scam for the front. Abeg anybody fit explain wetin the sender they try do?. If this thing dey dangerous, abeg wetin I fit do. Dem don send me 4 token wey no get name than "bep 20 and phishing , be careful on how you relate with this token "
Na normal thing wey almost everyone dey experience. Just like the comment above mine explains na so e be. Some are meant to deceive their community on the number of holders while some are meant to scam you when you attempt to swap them cux they will ask you to top up gas fee which amount to high $ and if you do so you Don enta one chance be that. Just dey Waka pass them as if you no even see them for your wallet. Don't try to spend what you don't work for.
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
May 16, 2023, 05:04:11 AM
#2
Una good day my country people, recently, I dey notice say some kind token wey no get name they hit my BSC wallet address and them always they write phishing and scam for the front. Abeg anybody fit explain wetin the sender they try do?. If this thing dey dangerous, abeg wetin I fit do. Dem don send me 4 token wey no get name than "bep 20 and phishing , be careful on how you relate with this token "
No be only you they receive all those kind of tokens on your bsc address, and am sure you can stop it as far as you dey post your wallet for public places, maybe you dey use the wallet do bounty. The only thing wey you fit do na to leave those coins their, no even try swap am. I don receive one before, if I dey try swap am, they go commot gas fee but e go fail, I no go see am swap, the more you keep on trying, na so dem go dey commot gas fee and the transaction go dey fail, like say na d developer side the gas fee dey go, I don’t know how dem take dey don am.

Some projects go send their coin to random people so that people go reason say dem get plenty holders just to encourage people to invest in their coin, which na lie, they no get any plenty holders na set up. So all those kind of coins if u receive them no reason say u done get free money, just leave them for their like that.

I notice say you dey use ur account do bounty, no try send d coin to random wallet ooo, make dem no come talk say your account dey connected with the person own.
member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty
May 16, 2023, 12:49:29 AM
#1

Jump to: