Oboy this your grammar sef get as e be. E for better say you flow for our local Pidgin so that one go make sense say we understand than to come dey see all this. Well you try Sha but see ehn de news wey dey for air now be say the supreme court which na the Apex court of Naija don suspend the deadline for currency swap see am here https://www.primebusiness.africa/just-in-cbn-stopped-from-phasing-out-old-naira-as-supreme-court-favours-northern-states/
but that one no means say people no go swap their old currency o. The only thing with this court judgement be say e give enough time for everyone to go bank go swap their old currency notes so that e go reduce in circulation while the new note go come begin tmdey circulate.
Another issue be say Naija never mature for this cashless policy matter of a thing. Dem want to do cashless wey bank no even get network to do transfer. I go market today to go buy something the market women Dem no gree for transfer o. The woman say make I pay cash omo o need go find post to get cash even the POS sef na wa. The new note and cashless policy matter tie wrapper.