I won drop some of the top coins way dey behind Bitcoin, and as Bitcoin dey increase the other coins too dey increase, many of us way dey for this country done buy some of those coin, even as say them buy Bitcoin self them still buy some of those coins too.
Na only Bitcoin na I done buy and I no dey plan to buy any altcoins except ETHEREUM but as long as say we dey find were we go fit put our money so that e fit hold and accumulate better thing (profits) for future, as we dey invest in those other coins make we still dey careful because most of them nah unstable coins without good reputations.
We done enter the year when many people dey expect good profits from Bitcoin as this year nah year when Bitcoin go take skyrocket, many people done predict am say e go reach $100k.
Enough greens dey for the market today, can this be the beginning of the greens?
Na big joy for people wey dey hold bitcoin this days, na this time some people go remember say patients is the best key to success, if you hold your bitcoin now my brother you dey among people wey get money for our naija, some people buy bitcoin with amount wey no even reach the half of waiting him Don dey see say him go gain now, you see sometimes we should know that there are many way to become a successful person in this life, and any time wey we wan invest make we never forget about bitcoin because na investment wey nobody fit forget am.
And about the remaining Alcoins, to be honest I don't invest on those because I no get the mind to buy those coin, and you talk am you said they are unstable coin so na that one be my problem, although them too get profit and some people dey wey be say if him buy them him dey always get the luck of selling them with better profit, but for me I no get the mind sha, also about bitcoin wey some people dey predict that E go soon enter 100k, but I hope say no be this year matter be that, bitcoin dey 45k now yes we know that but you know that bitcoin is also unpredictable because you fit predict am now and before you close your eyes and open the price fit come down, so predicting bitcoin is a dangerous thing because you fit go give yourself heart attack when you see waiting you no expect.