My country people, I bring this tori come make we look into am very well. I dey yan about am because na something wey happen for my very presence of lately which I think say some people here go don dey in similar situation before. I realise something wey dey amongst every average Nigerian. When ever an average Nigerian sees a youth, the male to be precised, sitted and operating a phone for a long time without looking up, it is assumed that the young man is doing or running streets a.k.a Yahoo boy which in the reality sometimes is not true.
Days ago wey me and my friend go him location, while we dey move around to see things for ourselves, my guy get notification for phone wey need him urgent attention to respond to. So him just adjust to reply the message wey dey urgent although e take am time but while him dey do am, one of the workers for the location dey observe am. After a while, the guy just begin dey talk anyhow waka go meet my guy wetin we hear na "senior man wey dey press abeg make e drop so that we go chop o. See as you fresh like yahoo boy". Omo as my guy hear am him nearly don wan punch am but I quickly intervene because e no reach to react like that but to be frank wetin that guy talk reach to put my man for big problem if to say police dey pass now come hear the talk wey him talk. Police for no want to hear anything o since them don hear yahoo, dem go want collect their own.
Point I dey try to make be say na for us to dey very cautious and careful anytime wey we dey outside. More especially us wey dey into Crypto. We no dey run streets but the truth be say security agencies no go understand any explanation if anything funny try happen. If you get updates as per Crypto matter outside, abeg do well to observe your environment, adjust to any where wey dey you convenient and comfortable wey eye no go too dey look you then do your work. Even as you dey do your work, no too spend much time like that dey concentrate on your phone, after a little time raise your head up and look around for sometime then continue. We all know say our phone wey we dey use alone for this our industry dey attract eyes and na that one sef suppose make us know say we get dey careful whenever we dey public places. I no dey put up this post to discourage anybody but to call to our consciousness to always dey careful and alert anytime we dey outside dey work with phone. You no know who dey next to you dey observe you whether na agent or na area boy wey dey wait to attack you.
Make we take our safety and security serious so that we no go encounter any wahala wey we suppose avoid in time. This na the matter as e be. Be alert and watchful.
My brother, you don talk well, people in this our present age and time now they see anybody wey dy press press phone as a yahoo boy just as the op rightfully said, because yahoo boys don give them that wrong impression say once you dy work with ur phone or laptop, mean say na illegal something you dy do, wey we all know say na lie, so for safety reasons, make we try let one or two people wey dy close to us to know say we dy into cryptocurrency in case of tomorrow, so that you fit get someone to speak on ur behave, if people start accusing you falsely.
And another thing wey I wan advice is that, anytime wey wan work with our phone or laptop, make we try do am in the comfort of our homes or somewhere private, so that you no go get any distractions and people no go come dy think say you dy do something illegal like yahoo.