Author

Topic: Decision of one governor can influence others for February presidential election (Read 131 times)

legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
Wetin i know be say Wike just they do all these things to hamper Atiku's chances of becoming president, immediately after the primaries wey Wike lose, he no they happy with the result since then, as e believe say the candidacy suppose come the south, but PDP still manage give am to a Northern man wey be Atiku. Wike and him G-5 governor friends no fit decide who go be president, and i no think say them don even talk say na wetin them go do, wetin Wike been they do since na to carry Nigerians they play, say e go soon decide who him they support for this presidential election, small time e comot talk say e no go make that declaration for public again. Wike just want make Atiku sweat, and e they somehow bring disunity into PDP ahead of the elections.

Having said that, make nobody deceive you say e get power to decide who go be presido, na me and you wey be the electorate so na im go decide who go be president, na out PVC get that power, so make we no sell our votes, but make we come out that day, vote for the candidate of our choice.
jr. member
Activity: 40
Merit: 2
All these happenings for this country na as a result of the foundation. For we to see changes, we need go back to default then reconfigure the system. All these leaders where put in those positions not by the masses but by a particular set of people. Like the saying, snake must always give birth to a long thing, this is how the transition happens. So definitely it can influence because they are the system.
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Wike with en g5 governors dey fight for their own interest oo, no be Dem go tell us wetin we go do, another thing be say wike and their g5 governors go only influence the election results of their state and that one no concern us, if to say wike and Atiku dey at peace we no for hear noise, make wike fight en fight alone, make en no involve us...
Na peter obi we go fight for normally, anything wey wike and G 5 governors dey support no concern us..

As for buhari, I believe say en go support tinubu shall, cos I know say APC no go like fail for the presidential election, but God go help us make our preferred candidate win, na peter Obi we want...
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
Actually PDP get their own role to play for election to see say them deliver their state votes to PDP,likewise APC. Na the person wey him compass tight pass for the state na e go deliver e state. I remember one election like that maybe two previous election for River State wey Wike, use e pressure rass all the polling unit with e boiz wey dem no allow any other party to vote apart from PDP. This one happen for my friend community under Kana LGA. So I believe say na e make am dey make noise because e believe say him go fit deliver him state to the party wey e dey support. Buhari still get the power to give the president to APC because na the incumbent president e be. Na Goodluck Jonathan carry power give APC,if not na PDP for still dey rule. Therefore, I still see say if no be free and fair election Jagaban don win already,because if una see the assurance and confident wey Tinubu dey use declare himself as the winner of this forth coming election you go tire.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country, nah here wey i watch the interview https://fb.watch/i13prgh_Ib/ but wetin i dey see here b say the youths now na dem go tell us the wey become president not those governor's who call themselves integrity group. This matter plenty well well, because dem sama sanctions give the chairman of electoral commission, and tension dey e body now. So do you think that buhari wey b our president now go support tinubu to win this election.
Yes.. in politics there is a team called "Political Wizardry" in a political candidate is withdrawn from contesting the election in a day to di election. So what Wike is saying is di truth but nothing and di truth. For instance, if Wike and the other G-5 Governors withdraw from PDP at the deadline, it will affect Atiku very strongly, because it will cause chaos and reduce di voting strength of Atiku. Remember di G-5 governors have a large number of followers. But let si weti go happen 4 di election. But no doubt Wike oo. He knows how to play di political game. Dat is y he dey very confident to say anything wey im like to tok
member
Activity: 308
Merit: 26
A governor can only influence the election results in his state, Becos na en territory be that, no go fit influence no go fit influence the same result for other states expect. But em fit buy the mind of people tru campaigns, And e also depends on the capacity of the governor, we get some governors wey really get influence for their party, like Nyesome wike get for PDP, a governor of that calibre fit influence other state or governors self, like when em influence the gubernatorial election for Edo state ,

And maybe the governor now get allies as we dey see for the G_5 governors, I think the influence of the leader of the group fit affect the decision of other governors
hero member
Activity: 812
Merit: 675
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country, nah here wey i watch the interview https://fb.watch/i13prgh_Ib/ but wetin i dey see here b say the youths now na dem go tell us the wey become president not those governor's who call themselves integrity group. This matter plenty well well, because dem sama sanctions give the chairman of electoral commission, and tension dey e body now. So do you think that buhari wey b our president now go support tinubu to win this election.

Buhari will definitely support Tinubu because theiyre party member and they have the interest of the party members at heart. Even though he doesn’t like him to be the next president of Nigeria, he can’t just show it to the public and this is amongst what is killing us in terms of choosing the right leader for the country. I just hope we get it right this time around.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country,
We get about 36 states for the country, and all those 36 states get a governor each wey the rule them. As a governor of a state, you get command over everything wey d happen for your state even for election period. Wetin I wan talk be sae, the only place wey Wike go get maximum power na for em state ''PH''. No be for another mans state. As for the G5 governor's wey Wike belong, they can't even decide who go run the country. This country na big country for one peso to come talk sae na this peso go rule am.

As this coming election dey so, so many things come with am. The tension the too high for peso wey we think sae em go win. All man just d pray make Peter Obi win but will it be easy for him cos people wey d run the same race with am, no be small people for Nigeria policies.
hero member
Activity: 672
Merit: 855
Wike word’s actually carry semantic meaning because even if na individual votes there are people that influence our decision on way or the other na why election campaigns and rallies Dey. Wike and other G5 governors most especially Oyo state governor Seyi Makinde get influence on top their people because of their excellent work. The only difference between what this influence do in the past elections and this coming one is the fact that Nigerians don’t just follow blindly but they do their own research to determine which is better. As for the G5 governors choice I think they have to also make a decision that could shape their political career and or end it. Makinde has the hardest option than the other four. Because he is the only one contesting and a decision could affect him too.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country,
The decision of not just one governor, but the decision from one Influential Governor can influence others in this our coming election. You see the way Wike dey package, na him get influence pass na why e fit gather all those other four governors. Some people go dey feel say all those things e dey do nor dey get influence on people even people wey dey both under the party and not under the party, but e dey get effect. The decision of one influential governor matters, the decision of one influential past official matters, the decision of those integrity groups matter to some certain kind people, The decision of traditional rulers matter, The decision of religious leaders matter. Their influence is widespread and you fit dun dey influenced already listening to them, na so the thing just be.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Well only Wike can't make a candidate to become president in Nigeria but Wike has join the decision making group in PDP, and to some extent in the country at large. Because im get influence in di political space in di kwantri. That is why if Wike tells di G-5 governors to support any presidential candidate, I believe dat candidate go win. Before Wike dey tok like dat, im no dey tok for imself but 4 all im supporters. Bcuz one man can not make a society. Tinubu (APC) and Obi (LP) nai dey contest 4 dis year election, as for Atiku im name no follow again. And Tinubu APC and Obi LP go bi a tough election. We pray make obi carry di votes.
I bin no wan tok politics before but election don reach corner and we need to tok about am.
member
Activity: 421
Merit: 47
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country, nah here wey i watch the interview https://fb.watch/i13prgh_Ib/ but wetin i dey see here b say the youths now na dem go tell us the wey become president not those governor's who call themselves integrity group. This matter plenty well well, because dem sama sanctions give the chairman of electoral commission, and tension dey e body now. So do you think that buhari wey b our president now go support tinubu to win this election.

Wike been de talk alot of things to make hinself happy, e no mean say na true e de talk. Every election cycle every political parties has their own voting bloc; yet it does not determine seh dem go de get the votes every 4 years. With different level of shege wey eye don see over 5 years now, no governor fit direct anyone who to vote for. everyone knows who they are voting for
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
The news i saw some of the interview of governors wike speaking that they will decide on the person that will make president, so i began to reason that can the decision of this governor and those people wey e call integrity group make somebody to be president of the country, nah here wey i watch the interview https://fb.watch/i13prgh_Ib/ but wetin i dey see here b say the youths now na dem go tell us the wey become president not those governor's who call themselves integrity group. This matter plenty well well, because dem sama sanctions give the chairman of electoral commission, and tension dey e body now. So do you think that buhari wey b our president now go support tinubu to win this election.

Buhari go surely support tinubu because na for the same party dem dey, besides the governments fit select person wey go become our next president if we the youth no shine our eyes and get the PVS to vote for the right person na ojoro them go take win and put the person dey wish to win the election and nothing we go take do about it.
make we try and vote for the right person this is our time.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
The decision of That governor can no make person to be the president of naija na we go vote no be them and na the person wey vote pass go win so even if they decide e no get mean unless if they fit convince other people wey they find the position to step down for the people wey want.
But no way wey a few number of people go decide person wey go rule the whole country how, ah no deh sure say that one go work
newbie
Activity: 25
Merit: 0
This matter wey here strong, but one thing is sure as e be say nah president is the number one speaker in a country, e fit no support am as e be say em no be em tunub political god father, so that em go fit talk to am anyhow.
full member
Activity: 504
Merit: 154

Jump to: