Author

Topic: DI FIRST BITCOIN TRANSACTION: One big Milestone for cryptocurrency history (Read 51 times)

full member
Activity: 182
Merit: 131
RATING:⭐⭐⭐⭐⭐
Bitcoin don become one big technology wey plenty people dey enjoy today, because of the better better benefits wey e dey give to humanity.
Different people get different views on wetin bitcoin really be, some see am as store of value, some see am as means of exchange, some see am as way to facilitate transactions, some know am for en decentralized nature and transparency. But the Koko there be say, even with different views and perspectives wey different people get about am, since them create bitcoin till today, Bitcoin don benefit humanity and society in many ways, and yet no be  everybody wey dey/don enjoy these benefits know how e take start.
So I say make we do small history about am, so Make una fasten una seatbelt, as we go come enter on one historical journey.

THE FIRST TRANSACTION

On January 12, 2009, na en the first bitcoin transaction happen, and e become one big event for cryptocurrency history because na dat day everything start. In October 2008, bitcoin creator, Satoshi Nakamoto, publish bitcoin whitepaper, wey e promise to give the world one decentralized digital currency wey go operate on en own without interference of banks or other Centralized financial institutions.
 E take am several months to develop dis technology, and after several months, bitcoin network come dey ready, and e launch on January 9, 2009.

 E come mine the first block, wey e name Genesis Block. Three days after launch, Satoshi Nakamoto initiate the first bitcoin transaction wey e come take send 10 bitcoins to one programmer, Hal Finney, wey be enthusiast and na e collabo with Satoshi Nakamoto to develop the technology.
Dis first transaction na to test bitcoin network functionality, but as matter come be, e come appear say e no be the only purpose, because e become one historical event for cryptocurrency history, marking the beginning of decentralized P2P electronic cash system.

Dis 10 BTC transfer come dey recorded for bitcoin blockchain, one decentralized ledger wey dey store all transactions wey them don make for the network, and the transaction block number na 170.
 Block 170 don become one symbol of bitcoin humble beginning and en potential for growth. Bitcoin today no be just digital payment system alone, e don come get many other benefits to humanity, with millions of people around the world wey dey use am, e don also become the biggest cryptocurrency asset today, with plenty benefits.
Jump to: