Author

Topic: Different source of income can you help you achieve your financial goal faster $ (Read 134 times)

jr. member
Activity: 157
Merit: 8
Nigeria no be country way you fit succeed with only one source of income myself I dey drive my neighbor children go school bring them back and I currently dey learn Front end Web Development like this hopefully when I don dey use am chop I fit go learn back end join small small dey grow my digital port-folio,,
I really appreciate this post so much because e touch very important part of our life abeg if anybody get more sources way we fit dey learn online skills kindly share make God bless you jara.
I go advice anyone way dey read this thread to also share this with those people for street way dey always beg you for small thing when you come back house, Sometimes no be only money you fit give them you add better advice join am.
sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
Person wey dey do one job for this country no fit succeed except say the job na the one wey be set E dey bring money more often. For one to succeed for this country you go really need to get like 2 to 3 type of business in other to scale through the hardship. Because if you dey reason say only one type of business go fit help you na big lie be that. Another problem wey people dey face na how to handle complex business like 2 or 3. No be everybody wey get that strength to fit run plenty business, sometimes E dey make people no dey focused because you go need another person to run the second and third, then you go come focus for one. But I trust some people dem fit run all at once base on how there strength reach.
sr. member
Activity: 532
Merit: 250
One source of income no fit dey dependent on for dis economy wey the country dey so o. People wey no even dey do government work dey for dey see money pass dose wey dey into government work because of how limitation don make dem not to fit go far for their hustle too join. Government don block way for dem and dem no wan increase salary for them too. With how stressful working under person be, you no go fit get time go hustle for yourself. I just dey wish day our people fit know the importance of having multiple source of income, dem go fit live better life despite the hardship wey dey the country.
full member
Activity: 448
Merit: 202
I will say kudos to your topic. Actually, anyone living in Nigeria should know that they need to have an alternative where they will be gaining. Many people are complaining and suffering from poverty because of a single source of income, which is one of the factors that introduced poverty. But many find it hard to understand anybody wey dey leave for dis county suppose know say one source of income no fit do am because the high cost of leaving wey dey Nigeria now like this na be small thing oo, fuel cost, food cost join even the things you day think say nah minor things day no suppose cost them don cost join, to leave for the county come they some how and apart from the high cost of living security no day for the county. To me, we need to help ourselves with side hustles, no be say we go dey wait for the government to increase salaries.

👉 this skull na number one for my list based on say i don try am and I dey do am. This one na Affiliate marketing.
👉number two on my list na AMAZON KINDLE PUBLISHING:
👉copywritting and blogging: I
👉 video editing.
👉 forex Trading: 

All of the skills you mentioned are good, but all of the technical hustles you mentioned take up time and make it difficult for you to do your main work. All of the side hustles you mentioned require knowledge, time, and electronic devices such as phones or laptops. And some find it difficult to use this electronic, so some side hustles that I will also recommend are physically side hustles that go around you, like farming of poultry, also known as chicken farms, fish farming, opening a provision shop, investing in a well-profit business, and a lot more. From there, you will also find out that your mind will be at rest than all this online side hustle.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
Omo the way the country dey go now, I don't think it's wise for any person to have only one source of income again oh, omo
One source of income not for do anybody again.

In this computer age that everything seems to be running very fast, having just one source of livelihood is very risky because when the desirable is unavailable, the available becomes the desirable so what this means is that if one side of ones investment isn't working at a time, one can easily switch over to the other business one has in other to keep going unlike having just only ones source of livelihood because if anything happens along the line then one will look like those that doesn't have any plan in life therefore it is very important that no matter how successful one has become in a particular skill or business, versatility is very important in life because the future is unpredictable as anything can happen at any given time even without ones knowledge.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You don try sha i know say this we no country no easy to survive at all because many people no still get opportunity to join here to learn lots of thing mostly i dey see people dey create some videos close to my house and i dey hear them noise on how them dey do if e dey possible person fit go into comic videos wey be say him fit do am den cun update am for media such as tiktok and youtube, facebook and twitter i believe say person fit still make money join upto the one person sabi here.

But then the task no easy because you no go fit dey for all angle dey do every work or skill to dey money just imagine as here dey very hard like this to dey read things which time person fit get space to go do those ones, to me wetin matta be say make person just find the one wey him dey comfortable with to dey learn or put interest so that him fit master am small than jumping from skill to skills without knowing any one properly, I no say to go learn those skills dey bad oo but e go betta say person learn am sabi am wel well so that him fit dey make money from am.

Sometimes wetin make people no dey too get money for skills wey dem learn na because of too much distraction jumping from skills to another and if you look into wetin i dey yan you go see say sense dey into wetin me dey talk so most people no go like to hear this part wey me dey cap like this. The better we focused for one better work wey we know say go give us better money the best we becomes.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Omo the way the country dey go now, I don't think it's wise for any person to have only one source of income again oh, omo
One source of income not for do anybody again. Price if things Don high, house rent Don high, oya the one wey dey shock me now and wey dey still pain me na as common water wey dey everybody house Don add serious price, even as cheap as the major resource them dey use produce am dey.

When you dey a country wey be say even the president no get only one job, him be president and still be minster of petroleum with other small small offices wey him dey keep for himself you suppose understand say e get how the country be. Our lecturers no be only lecturers dem get other side hustle dey or dem dey jungle between two universities dey teach. Our doctors dey do the same thing as dem dey work for government hospitals and still dey work for private hospitals. After all this things wetin make you think you go fit survive with one source of income. You supposed get different hustle wey you dey do incase this one no pay, you no go para but go turn to the other hustle to continue living your life and when both dey pay you fit get enough money to use sustain life.

Quote
👉 this skull na number one for my list based on say i don try am and I dey do am. This one na Affiliate marketing.
👉number two on my list na AMAZON KINDLE PUBLISHING:
👉copywritting and blogging: I
👉 video editing.
👉 forex Trading: 

All this skills you talk here make sense and I go wan add say when you dey find a side hustle, make sure you no go do wetin go stress you or need 100% of your time. Make the side hustle dey online based so you fit do am remotely from anywhere. We dey cryptocurrency industry so make we try find hustle wey wey here so we no go dey outside of our field and money dey this  industry well well. Just small telegram group manager wey you fit be can be earning you $100 and above because projects dey pay well although some dey pay you for their tokens and if them list (like dem become successful) na better block you dun get like this.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
For this country we dey so, man no also need to put all him egg inside one basket cause many things they happen wey fit affect that source of income and if e happen where person one run to. Even Dangote sef no get just one source of income, him dey base on sugar, cement, salt and even flour. So see how diverse he established his source of income.
Skills and online business can also be a better option as one's source of income, right now no knowledge is a waste as long it's digital.
sr. member
Activity: 602
Merit: 260
The way things tey dey change for this contri earn if u nor Sabi hustling you too go see shege.E get one topic wey person create for begginers concerning free courses. I think that can also add up to this your post op, see the link COMPLETE DIGITAL COURSES BUNDLE
 
Quote
forex Trading:  we all the risk involved in this, but when it has been mastered it gives good results.
Normally we all know that all trading comes with great risks both forex and crypto trading. I won't advice any one with small capitals to go into trading. Because if you have little funds and you using to trade and same time using your leverages recklessly you can easily get liquidated. Doesn't still mean that with much funds you won't still lose ohh. According to op when you have mastered it you then know the beauty of trading.

You go con know say as great risk tey dey attached to trading na so great profits tey still follow am. Any thing you do always do it wisely.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Those people wey dey depend on only one job since 2018, them dey hear am well well for this period as price of things don go up. As I dey like this, I get to hand work wey I take they support myself plus the signature campaign money wey I dey get, but I still no dey totally satisfied because, I no know wattin dey ahead and I need to save up with Bitcoin. However I don hear about that amazon selling of book but I never too dey exposed to the full details. But e sound like wattin go dey very fun, even if nothing easy for this life as you talk.
sr. member
Activity: 98
Merit: 55
Omo the way the country dey go now, I don't think it's wise for any person to have only one source of income again oh, omo
One source of income not for do anybody again. Price if things Don high, house rent Don high, oya the one wey dey shock me now and wey dey still pain me na as common water wey dey everybody house Don add serious price, even as cheap as the major resource them dey use produce am dey. For this thread I wan just put up list of side hustle wey dey pay for the country and where you fit go learn am, although some of them dey expensive small to learn but the passive income e dey generate fit help you meet up with higher needs, even now wey many of us do  dey see the need to invest in crypto and to keep up you know say you need to get many source of income

👉 this skull na number one for my list based on say i don try am and I dey do am. This one na Affiliate marketing. Make I explain am small since I know am. This skill dey allow you to leverage on people product sell them, then get commision from am. As an Affiliate your work na just to be online mediator between product owner and seller. Commission fit range up to 50% and its not complex or hard to start. One of the place you fit find cheap course learn na selar.co, Digistem, even me sef get product on this one and I dey willing to put anyone through on am. They pay in dollars

👉number two on my list na AMAZON KINDLE PUBLISHING: this one too dey easy but you need laptop to start am. This one you go dey create books dey sell and amazon go dey pay you in royalties.  No worry e no hard na AI most of my friends dey use. And they pay in dollars

👉copywritting and blogging: I no too sabi how this one dey work but you fit read about am here.
http://www.copyblogger.com/content-marketing-copywriting/

http://www.copyblogger.com/content-marketing-copywriting/

👉 video editing.
👉 forex Trading:  we all the risk involved in this, but when it has been mastered it gives good results.

This are all the easy to learn once I sabi.

Goodluck.
Jump to: