Their is a saying that, if you are wise, it will be beneficial to you, but if you are foolish, it will also be beneficial, but to others.
Anybody wey allow politicians use Dem no wise, you don ever ask yourself where their children dy? If you no know, just know today, Dem no dy for we country, that's why Dem wan just spoil this country keep, when bad tin happen like war, na Dem wey get money go first run, those wey no get to use run out of the country, go dy here and face it or die, if some of my fellow youth like, make Dem no wise.
Na true sha, na e mk dem dey draw everybody for ear mk them dey wise, mk we no gree for anybody, any person wey won carry our loyalty take play na so we go carry their own too play, mk we wise up, mk we hustle hard, mk we n dey wait for government to carry food come our table before we go eat, na e mk dem think say without their help, we no go fit make am, na e mk dem dey do anyhow, dey act anyhow dey want, dem no dey concern about us, whether e dey affect us or not, dey no care, as far as their children no dey here, e concern dem but our prayers and cry go go far go hurt dem for any side wey dem dey but nevertheless mk we no allow because as everywhere dey like this, allow our politicians to use in a way e go affect us and the society.