Author

Topic: E be Like Say One Belle, One Mind No Dey Our Police side (Read 49 times)

full member
Activity: 140
Merit: 63
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
For My country 9ja no body dey gree for each other o. This kind issue wey you see so, that criminal oga don pay bribe for that matter to silent and maybe the other officer no no say something dey happen underground. Naim be the problem we get for our society today criminals get connection pass government workers self. Wetting dey give those criminals mind na those politicians wey dem dey work for, during election. Because na election convenant them get. And other secret deals them. I no fit mention am finish but our politicians  get big connection to our problem for the society.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
The kain things wey dey happen for naija now dey off me. I nor know if you don see this Chinaza Phillips case wey dey thread. After police don come out to parade the boy as kidnapper, fct police come out talk say them nor arrest anybody like that.  Communication nor dey between our security agencies. Them nor dey united at all. All of them dey quarrel each other. OP yo7 don forget DSS and EFCC fight last year wey DSS come seize EFCC office for Lagos.
full member
Activity: 504
Merit: 151
My pipo, I greet una. E get one question wey dey pepper me for body wey I say I go bring come here to get all of una opinion and views. Abeg, why e be say with the current happenings for the country e be like say our security agencies nor dey work together in cohesion. And even within themselves dey nor dey together. See now, some days ago, Police say dem catch one notorious kidnapper.  E nor come tey the same Police but for FCT come talk say, wetin the other Police talk nor be true, say nothing like that happen. This one cause serious gbas-gbos for the internet. If these guys nor fit work together with one belle, one mind, how dem go fit solve the increasing security wey we dey face for our country.

For contxt abeg read this - Confusion as FCT Police Command faults report of rescued man abducted in Abuja

This topic for dey under Politics and Society had it been say we get sub and Child Boards for this our Local Board

Omo the police personnel across the states no dey in unity, I feel say them get sentiments with themselves. I beeen read the news as e dey trend for internet, is as if them no dey coordinated, even the person way them say them catch, the person get multiple names. Na because say them no dey work in unity, na why crime plenty for we country too, every command dey do anything way him, na when matter don pass garri u go see their P.R.O go come out come drop yeye press statement.
full member
Activity: 378
Merit: 230
Bitcoin in Niger State💯
Na this kind thing dey make people say if you ask me na who I go ask? Na today you still dey realized say our security network for this country is a big mess up. This simply shows that there is a big lacuna in the police force. It's either they are hiding something, because I see no reason why people go come out come announce say them catch person if they didn't catch anyone. Something fishy is going on.

First and foremost, there's disconnect between most security agencies and departments and that have caused serious danger and problems much more than we thought or imagined. Not even only when something is fishy is going down but in an ordinary situation, there's that disconnect between those quarters.

Now, let's relate it back to this case again, whether there's a fishy incident there or not, on no account should we witness a situation where a police unit or branch will disregard information that is coming from another unit or branch of the police. That's an insult and causes lack of confidence in the process.
full member
Activity: 224
Merit: 151
Na this kind thing dey make people say if you ask me na who I go ask? Na today you still dey realized say our security network for this country is a big mess up. This simply shows that there is a big lacuna in the police force. It's either they are hiding something, because I see no reason why people go come out come announce say them catch person if they didn't catch anyone. Something fishy is going on.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io

Jump to: