Author

Topic: Election day safety tips. (Read 85 times)

sr. member
Activity: 350
Merit: 255
February 25, 2023, 04:35:14 PM
#9

(Make we join add more safety tips for our benefit)
I won add my own,make you also avoid temptation for your PU,some people na trouble dem won come cause there so that make them cancel the unit,so if person talk to you anyhow just avoid am so that you go dey on the safe side. Lastly always shine your eye like policeman torch so that in case kasala burst just locate the shortest incorro road to your house. Election na using of head,because politicians fit go at any length to win election. Nice tips OP
full member
Activity: 798
Merit: 134
February 24, 2023, 07:35:16 PM
#8
You try my brother everything wey you talk here dey absolutely correct most especially those wey there polling unit dey for their village and dem dey city here. Then secondly make dem reduce argument that one dey really exhaust person energy wey be say to run na problems couple say dem come wear political polo join am e come dey more easily for other party members to attack them join.
Please Vote wisely and come back home safely!
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
February 24, 2023, 02:09:54 PM
#7
Well said brother... The dressing part of your write up dey really funny but na true you talk. Na to wear something wey dey simple and comfortable incase kasala boost, person go fit easily run but we pray say e no go come to that, God will keep us safe tomorrow just as He has always been keeping us. This election no go cost ur life or any member of our family or friends. The economic realities of the country no fit stop us, we go turn up en masse and vote our conscience.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 24, 2023, 02:07:40 PM
#6
This election safety caution is most appropriate at this time where the whole 9ja electoral atmosphere is in an intense level with high tensions as to where next will be the direction of the country and the general election have brought with a high level of security risks that we as individuals and citizens must take percussion and build some safety skills and tips among which the ones listed in the ops have included most of it in this post.

-Most importantly is never to get involve in any political misconduct even though you are the one contesting for the position, or you are doing it to support your candidate because that is the fastest way to die since the President have declared war against electoral malpractice.
hero member
Activity: 770
Merit: 589
February 24, 2023, 01:53:05 PM
#5
 I feel say that tip about keeping your opinions to yourself nah the most to me oh. For this election, you go see pipo wey for dress like normal peeps wey come to vote but nah spies wey dey there to hear wetin pipo go bad mouth about the candidate, bifo you know, kasala go burst.
 All of us prayers nah say election go smooth tomorrow without kasala and the fit candidate win.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 24, 2023, 01:06:21 PM
#4
All the tips you talk go well oo, and I believe say anybody wey read am go abide by am, this election no be war, as we dey go out dey go cast our vote for our different pulling units, make all of us dey very careful and make we use our head make nobody go die for any politicians head....
sr. member
Activity: 714
Merit: 421
February 24, 2023, 12:19:01 PM
#3
You don try comrade. This tips Dem wey you post here make brain. You see for election ground makw nobody loose guard o otherwise na in your own matter o. Bible say wisdom os profitable to direct. Anybody wey dey go vote make the person follow these tips wey OP write here so. No go dey talk any how for polling unit o, cast your vote codedly and adjust yourself for one corner dey observe the scenario dey sensitive to your environment for the time being. As OP talk about dressing, follow that measures no go  dress like say you want to party oo because if run Start, you no go fit run with heavy make up and wear so dress smart. Carry water along with you so as to avoid being dehydrated. If you can stay, watch from afar as vote is counted no go dey argue or claim this one that one there o
Lastly, do not sell your conscience for peanuts, vote wisely, vote for the future of a better Nigeria.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
February 23, 2023, 10:02:41 AM
#2
You don do well for this post wey you drop so, e they important to vote, and e they most important to stay safe before, during and after voting, so as you they ready to go exercise your constitutional rights, also know say some evil elements and miscreants might be lurking around, so ensure to they on guard always. E they pain me say at the level wey this country they, we still they discuss how to stay safe during election, normally election suppose they free, fair and peaceful, but as insecurity choke for Naija, some problems fit arise on election day.

Having said that, you don drop most of the tips wey they useful, i fit also add say if you get security dog wey you train well well (no be the one wey go bite fellow voters oh), you fit carry am join body with you for some form of protection from evil people, and make sure say you no carry any weapon of any sort oh (no talk say na for protection oh), if police catch you with gun or knife them go arrest you, them no wan know why you carry am.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
February 23, 2023, 07:31:58 AM
#1
The forthcoming presidential elections will attract many voters, more voters than Nigeria has ever witnessed. It becomes important for us as we plan to go out to exercise our civil duties, that we also plan to return to our homes and family safe. How do yo prepare for the election.
Some tips are:

- For people wey their polling unit dey very far from their side, maybe due to some kind reasons, if way dey for you to go that area go find person dey with till the early morning of that day so e go dey easy for you to reach your unit, e make sense like that.

- Nor be dressing competition, try wear comfortable clothes and shoes, so you fit easily discharge incase kasala wan dey. Very importantly, wear normal cloth, nor go wear cloth or any thing wey go show say na any political party you dey support. That day na day to vote by voting, not by wearing party material.

- Keep your opinions to yourself mostly, nor too talk that day.

- If e dey possible say you and person wey you know dey the same polling unit, e go dey better say two of una nai go go, make una join body waka.

- Make sure say your phone dey charged, and if possible you carry power bank follow body.

- Chop better food that day, carry water follow body or find way get small money early wey you fit use hold your side that day.

- Nor involve yourself for any form of electoral malpractice especially snatching of ballot box. Nor allow politicians use you when their children dey abroad already.

(Make we join add more safety tips for our benefit)

Jump to: