Author

Topic: Eleme people actually Dey this forum (Read 59 times)

sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
December 15, 2023, 01:43:19 PM
#4
Baba I greet oo, I no say you wan try to locate others so that una fit hangout for the same territory but make I still clear you say to provide this kind of more detailed location for were you dey stay and you know say we not supposed to even release these kind of information especially for forum like  wey majority of our talk na money matter we dey talk. To be honest e nor dey safe as e be say many outsiders don dey fit understand our local pidgin. My brother safety first oo, make Dem for no use us chop Christmas oo.
The way una Dey Dey take handle this privacy matter no follow at all and it seems a lot of people Dey get very wrong conception of what privacy means in the forum but nevertheless, I no been dey ask so we fit hangout but I been Dey ask to fit get familiar and who Dey hangout for this hard times wey even pure water don get very serious level😂

~snip~
normally from the bari when de your name e don show say you me better OG boy and I doubt say na only you mount for this ama.
Normally from the name I be eleme boy and the difference na the “o” wey Dey before the bari but nevertheless we all be the ogonis but I been wan clear say eleme na council on its own but with regards to our hero KEN we all are the OGONIS
full member
Activity: 266
Merit: 113
December 15, 2023, 01:18:45 PM
#3
Yes I mount
And out of curiousity, I don Dey wonder if na me be the only eleme person wey Dey this forum or e get plenty others wey Dey seriously disguise because frankly e no Dey nice say another eleme person Dey here and I no actually sabi the person because on some several occasions, I don Dey privileged to link up with men and the high rate of unity wey OG men Dey get, it seems we the sister LGA Dey left out and as such this thread na to allow the eleme people wey Dey here to identify dem selves make we fit grow in love l, hence this thread go Dey self moderated to avoid spam.
normally from the bari when de your name e don show say you me better OG boy and I doubt say na only you mount for this ama.

I be ph boy though no be from eleme but I think looking for an element person for the board go fit de a bit hard, you for ask of ogoni members for the board and e for de easier to locate them but anyhow e be, nija na nija and na one love we de use carry everybody along.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 15, 2023, 10:28:54 AM
#2
Baba I greet oo, I no say you wan try to locate others so that una fit hangout for the same territory but make I still clear you say to provide this kind of more detailed location for were you dey stay and you know say we not supposed to even release these kind of information especially for forum like  wey majority of our talk na money matter we dey talk. To be honest e nor dey safe as e be say many outsiders don dey fit understand our local pidgin. My brother safety first oo, make Dem for no use us chop Christmas oo.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
December 15, 2023, 01:36:23 AM
#1

Jump to: