Author

Topic: Fake life in naija (Read 329 times)

full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
January 31, 2024, 07:05:14 PM
#44
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  
Yeah na true you talk but however na women way they mostly use that disguising lifestyle so that them go impress people say they come from a rich home so that they wil blend in anywhere they found themselves, the one way I see for my neighbor self surprise me, because I no no say one guy way they outside the country they chart this girl and she they tell the guy say her father is every wealthy man, so that the guy go they shower her with money, but meanwhile she no get anything, so the guy come send somebody to monitor her and also to really no were she they stay, so na after then way the guy come realized say the girl been they disguise to be living a lifestyle of another person.

Na wa for some people Sha. Not only girl dey disguise, men do as well. For the case of this lady, she just use her fake life spoil her relationship. She has forgotten that man wet go marry you if you tell her u no get anything, go still marry u. Now she build the relationship on lies and she ended up losing everything.
jr. member
Activity: 38
Merit: 1
January 20, 2024, 03:04:11 AM
#43
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

this matter tie wrapper, I jam one man way I dey run show with not knowing the life of this man is all about fake, the first dey he carry enter his friends house another time he tell story, wrist watch way his friend buy wey him never were they guy man wear am the friend could not hold himself na him react in front of me not minding anything it deeply shame to him and me myself been in such a wrong hand but one thing I saw in this measn oeoy with fake life they full of lies, have no shame and have sold of their conscience in dealing with things. The truth is that any who is engaged in fake life is very difficult to stop,the end part is always a failure it make them not to be their real self.
member
Activity: 196
Merit: 25
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
January 19, 2024, 05:18:07 PM
#42
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

Op this your topic, laugh wan kill me, but is not funny many is addicted to fake life, just as many are to drugs, one even that occurred in my area I hope many hard it in news precisely in Port Harcourt where apprentice carried a car brought to his boss shop for maintenance to play around with his girl friend hard accident the car shape damage beyond repair. Everything have it consequences I think what he have be doing in the past as fake he, have to pay for it on this instance he damage the car of his boss customer. Fake life is worst thing any one can adopt because it possessed like evil spirit very hard to cure and the painful part is it always end in regret,at the first it will work efficiently but the end is always hard I know at that point is too late to any one who is involved.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
January 19, 2024, 10:10:34 AM
#41
The one wey dey pain me na for social media. People go just dey give stupid update, dey form wetin dem no be. Las las them go till inbox you or Whatsapp you, say make you help them with 2k make them take do one or two. Dem no no say fake life no dey pay. As them dey form naso their destiny helpers wey suppose give them compass no go reason them because the helper go dey feel say them dey alright.

Life na turn by turn, the fact say you no get, no mean say you need to borrow to impress people make them clap hands for you.You need to humble yourself, maybe there's a lesson God wants you to learn at that point in your life, so that when you get to the top, you go understand somethings about life. Work hard and pray, no need to fake wetin you no be.
newbie
Activity: 95
Merit: 0
January 19, 2024, 09:56:53 AM
#40
There’s a saying in Lagos that’s “fake it till you make it” this wasn’t created in Lagos but was adopted by Nigerians from their Europeans visitors who mostly fake being rich to Nigerians to get preferential treatments, This has further eaten into the Nigerian youth system of the nation where young guys pretend to have it all just to get young girls to do as they please same goes to young girls who even though at home can’t boast of 3 square meals they go out looking very lavish In borrowed clothes which most times they paid to just wear for 24hrs and it has to be be returned or will attract extra charges.
It even goes so deep in the social life of Nigerians we can see the fake life practices in places of worships like in churches most people don’t go to church if they don’t have a new dress they are more concerned about their image to the public than their righteousness.

We need to look inward and speak the truth to ourselves so we can overcome this fake life trend and go back to living a simply and just life where people are contented with what they’ve got and work hard to achieve more this is the kind of life we should pass down to our young ones.
jr. member
Activity: 70
Merit: 4
January 19, 2024, 09:39:13 AM
#39
na low self esteem and pressure(like peer pressure) dey cause this fake lifestyle. E get why "some" wealthy people no dey too stress themself for this this type of thing. Their high self esteem just dey enough for them to enter anywhere.
full member
Activity: 280
Merit: 159
January 18, 2024, 06:24:41 PM
#38
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

Nah so oo imagine person wey get iPhone 15 dey try oppress landlord  Grin this country get as e be oo, like this all this fake life things nah poor people day do am, because person wey get money no go ever show him money to any one but no try poor man oo. Although many men dey enter this fake lifestyle just to impress the ladies as them too nah money dey their head. Some girl wey dey do fake life are just doing it to prove expensive lady in order to get rich guy wey go fit spend real money for her.

Imagine a girl borrows an iPhone 12 just to go party and do fake life oo. luckily enough in the process of the fake life acting phone fall screen break she begin dey cry and sweat, say she borrowed the phone from some thug guys wey dey her area just for the party and now phone don break she know know how to explain give the thugs wey get the phone. Abeg this one no be wahala she go buy by her self because she no go gain anything but only enter new problems again, wey solutions for those problems self go hard wella.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
January 18, 2024, 03:30:18 PM
#37
Them all fails to realize say fake life offers lost of opportunities after their exciting posture where people who don see you finish go dey avoid you cuz constant request becomes burden, who observes your mind of person disregards you and who supposed help you for life over looks cuz you look like boss already plus ur accumulating debts way no bring productive returns instead you keep roaming the hoods like one dodging stray bullets while hiding from who you dey owe.

Some of them even mocks and tends to discourage others way dey work and earning penny while the fake lifes people no get shi-shi means of income just being dependants with low quality of personells .
All people care about is self respect and they want people to respect them at all cost so they will do anything possible to cook up lies just so they will earn that respect and that is why will are having a lot of issues now in how country because a lot of people are fake and when they get tired of been fake then they wont mind to go to any level just to get money to fit in that fake life some of them can even go to the extent of killing just for that life which is not even worth it. and just because of their pride people wont want to help them because they act like everything is okay which deep down they clearly know they are in a very deep shit. they can not talk just  because of the way they carried their self but i pray many of them will know that its wrong. and some of them are gamblers they will even go to the extent of gambling without paying money.
 not only people that work but people that are serious with their life they will not wont the person to look done on them but if you not smart they will even influence you that is serious with your life.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
January 18, 2024, 01:20:34 PM
#36
I greet everybody for here and everybody wey put mouth for this matter, e don too dea noticable say fake life don too much for nigga. So tai many people don too carry such life put their self for trouble.
We know say packaging dea, but people don form am another thing, from packaging to fake life which is not how is should be, looking good doesn't mean we should art too much of it.

Is not everybody that ups on good cloths that are okay or living well. Some are actually living life they don't know off, trying to art like someone who's in a good position but not.
So abeg make we live our life right, fake life no fit help us rather such life go give us more cost and trouble, so live rig
full member
Activity: 224
Merit: 195
January 18, 2024, 12:46:35 PM
#35
I no see reason why, youth of nowadays go forget all the hardship wey Dem don pass through, then try to use small money wey Dem get to impress person wey fit no give a dam about them. I know of a friend wey be say e like to chop everything now, because he dey always come up with a quote day what if we die now. And guess what? After e don chop em money finish e go still run back to me for help, forgetting say after too much flexing come broke lifestyle. Small money go enter your hand you go forget all the time wey you dey soak garri, go sp ND theonry anyhow, no use comparison take spend irresponsibly oo.
The youths are now leaving to impress and intimidate other people, forgetting life is all about stages. life is gradual, step by step without skipping one, to become rich and wealthy some criteria must be obtained if not, one will slash back to his beginning which becomes a very big slab.
It is important to know how to manage available resource, those who comes from the dust will understand better, life is not always too rosy some days good and some days worst, it's left for us to be mindful on how we spend.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
January 18, 2024, 10:51:44 AM
#34
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

This question wey you just ask so, if you ask me na who I go ask? My brother you forget say na Naija you dey? Naija na where if people deceive you, you go deceive them back, that fake life start now no be today na, E don tey wey the matter they sup, many guy's no fit dress in their normal way now, everybody wan dress like yahoo boy's and girls too wan claim say them be big girls, everybody just dey deceive each other for naija, I Don see where guy use renting bike and clothes to marry and after marry he carry the girl to one kind single room lie for the girl say the house wey him they build never complete so they gast stay there for now, that marriage no reach 2 months everything scattered because the girl later come understand say the guy no get any money.

I dey think say na impression they cause all this thing, but as a person that have faith in God you will not allow impression lead you to waiting you no fit do, if I no get, I no get be that and I go try to make a way wey be say me too go dey see small change for hand, and the other thing wey dey cause fake life for boy's no pass girls, girls don't want to date person wey no get money and we men also want to date a girl wey dey fair in completion, and girl wey be say people go talk say the girl set or the girl fine.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
January 18, 2024, 04:19:25 AM
#33
I no see reason why, youth of nowadays go forget all the hardship wey Dem don pass through, then try to use small money wey Dem get to impress person wey fit no give a dam about them. I know of a friend wey be say e like to chop everything now, because he dey always come up with a quote day what if we die now. And guess what? After e don chop em money finish e go still run back to me for help, forgetting say after too much flexing come broke lifestyle. Small money go enter your hand you go forget all the time wey you dey soak garri, go sp ND theonry anyhow, no use comparison take spend irresponsibly oo.
full member
Activity: 322
Merit: 166
January 18, 2024, 03:52:52 AM
#32
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

The competition amongst the youth of wanting to live a luxurious lifestyle in order to be praised by their fellow compatriots is what is causing all this. They want to impress their equals that they are living a big lifestyle in order to be well acknowledged and seen with high esteem in the society is what is breeding all this. Even when they know the end of it not being great, they still continue to do it. Another cause of it is the social media, everyone wants to live a big life like the ones they see in social media, little did they know that they’re all fake life’s and not real. If you’re the type that want to follow the social media trend, you’ll be disappointed and wish you never did.
full member
Activity: 560
Merit: 161
January 17, 2024, 05:41:55 PM
#31
Lolz😂😂the reason for all dis fake life like u talk na to impress others especially the opposite gender.Most people wey u dey see wey dey live fake life some dem wan just feel among for social media for example Instagram, according to one Naija musician him say poor man no dey for Instagram.You go see person wey dey use the lastest phone,shoes,bags dey live luxury life but em dey squat with em friend for one room all those one na de packaging wey I talk,dis country Naija na vibes.
The kind of fake life wey some people dey see for social media na dey make them to dey depress , because they with the flashy things wey dem see for people wey dem sabi e mean say everything don better for them. Fake life too full for social media which somebody no need to take ahm serious, many people for social media are only trying to impress people to see that they are doing okay, and if you take wetin you dey see for social media you fit even dey depress to give in life. Social media is just a place full of fake life.
member
Activity: 105
Merit: 9
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 17, 2024, 05:23:26 PM
#30
Lolz😂😂the reason for all dis fake life like u talk na to impress others especially the opposite gender.Most people wey u dey see wey dey live fake life some dem wan just feel among for social media for example Instagram, according to one Naija musician him say poor man no dey for Instagram.You go see person wey dey use the lastest phone,shoes,bags dey live luxury life but em dey squat with em friend for one room all those one na de packaging wey I talk,dis country Naija na vibes.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
November 26, 2023, 12:47:40 PM
#29
Lol the truth be say even the fake life they very expensive no be everybody they do fake life they succeed some they cast, but the thing be say why I go they do fake life why I go dy claim watin I no be just to impress human beings too bad na for 9ja that thing they sup pass go yankee you no fit sabi who rich because all of them they very okay dy dress well no be 9ja way if person Wer white big polo they don dy reason am big boy if the boy use Benz self that one worst they go reason am big man but that same Benz them dy use am as taxi for yankee na we just they stress ourselves for all this things.

The fake life is very much expensive as you said, but come to think of it, does it really pay to live such life, what will be my benefit not to live my life according to my standard, I think some people need to be advised if they will take the advice, is only here this things happen, where every one want to impress irrespective of what it will cause them, they dont mind, what matters to them at this point is to satisfy their themselves at that moment to impress even though it make them to be in debt that isn't a problem for that moment, it is a pity for people with such character.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
November 26, 2023, 12:34:28 PM
#28
Nigeria is the headquarters of fake life, you see some people not having anything to boost for, but the will come to the public to the show up and say something gum them, but it would have been better for someone to live his or her normal life, be real, don't fake it because there are people that wants to help too, but when you fake it, they will feel that you are among the happening guys and you will miss out if you do as if you know or you follow, people we keep you in that standard even though the realize later that you need help, they will never render such help to you because of your lifestyle, some people are swimming in poverty today because of this lifestyle.

Some people live this life in other to compete with others or even be recognized, but let's be sincere so many people will appreciate the real you more than your fake self, so be mindful of what you do in other not to be an object of mockery later.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
November 23, 2023, 01:49:29 AM
#27
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
That one don turn habits among Nigeria people. But mostly girls. Because I no see reasons to why man dey borrow clothes because men nu get time to inpress wonan but rather women borrow to inpress man. If man borrow clothes to inpress woman na big fish e wan catche.

This thing dey dey common for Lagos. Lagos people dey like p ackaging like mad. but for me I see no need to borrow clothes dey try inpress person because who wan help you fit see am say you get and see as say wetting em wan give you, say you no go fit like accept am based on your level, not knowing say nothing gum you.

The only place I fit support say make we borrow clothes, na when we dey apply for some contract, wey require you to look sharp and financially capable of doing or handling the job. Because if you no get that character of packaging sometimes you fit loose contract wey you dey find. Like me the first time I applied for job wey I learn, and the work I never do am for any company. I lie say I don work for here and there with proof. Because I no say I Sabi the job but just need alot of reasons to prove to them say i Sabi wetting Dem dey talk. otherwise dem no go fit give me am. Sometimes previous experience dey always come as a question to who dey find job and if you no hold your mouth tight you don Jones.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
November 22, 2023, 05:53:38 PM
#26

This na lifestyle way dey everywhere and even more common with celebrities.
If you dey listen lyrics for songs, you go hear when RickRoss been dey refer to Lord Birdman say, e get when e been dey feel say the wealth them dey display for there music videos was their properties but, omo, na borrow.

The life, them dey front am. Most of watin don translate to materialise as lifestyle today na borrowed culture. For social studies, them dey call am acculturation. Na normal gor human behaviour but, no be watin I like personally shah.

I like see person as them be. Make we know when e better and when e no sure. No be say you go rub am for face o but, at least, make we know who dey with us, lol!
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
November 22, 2023, 05:47:10 PM
#25
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

All this thing's na fake life we dey call am, everybody no wan make them see am as them no get anything in life and this thing dey lead make person no achieve anything in life because even your destiny helper go pass you commot go give waiting belong to you to another person, and people that always do all this kind thing came from poor family and they will be forming big boy and big girl, this even remember me now about one of my guy wey  dey date one girl like this, the girl get swag even if you see her you go fall, this girl set and she is acting like one kind girl that her father is Mr president, my brother at the end na from poor family this girl come from Grin, my guy really want to end the relationship because of the lie but at the end they settled, this kind they affect many people relationship and still yet they still continue but from my observation I don't think this fake life for naija go end.
jr. member
Activity: 44
Merit: 1
November 22, 2023, 03:36:13 PM
#24
Lol the truth be say even the fake life they very expensive no be everybody they do fake life they succeed some they cast, but the thing be say why I go they do fake life why I go dy claim watin I no be just to impress human beings too bad na for 9ja that thing they sup pass go yankee you no fit sabi who rich because all of them they very okay dy dress well no be 9ja way if person Wer white big polo they don dy reason am big boy if the boy use Benz self that one worst they go reason am big man but that same Benz them dy use am as taxi for yankee na we just they stress ourselves for all this things.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
November 22, 2023, 10:46:01 AM
#23
This life we no fit sabi finish and one thing wey me I know be say person no fit see me finish and if na to live fake life be the way out then I no sure say I fit get choice but nevertheless, I no see reason wey person go Dey love borrowed life just to impress people Abi the person no get other meaningful things to do with their life Abi wetin Dey sup? And one major reason wey Dey make nigga live fake life na to impress woman because this our girls Dey make love life hard for the poor and average man and our boys already know say this girls Dey believe more I the things dem Dey see and you already know say first impression matters a lot and appearance also follow for major impression and most times end up sharing cloths just not to be caught unfresh.

This Nigeria no get any specific approach to follow am up because wetin work for A fit no work for B so anyhow you go take survive is left for each of us and if fake live end up to pay your bills, who I be to talk you out 😂
full member
Activity: 252
Merit: 157
November 22, 2023, 10:19:34 AM
#22
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  
Yeah na true you talk but however na women way they mostly use that disguising lifestyle so that them go impress people say they come from a rich home so that they wil blend in anywhere they found themselves, the one way I see for my neighbor self surprise me, because I no no say one guy way they outside the country they chart this girl and she they tell the guy say her father is every wealthy man, so that the guy go they shower her with money, but meanwhile she no get anything, so the guy come send somebody to monitor her and also to really no were she they stay, so na after then way the guy come realized say the girl been they disguise to be living a lifestyle of another person.
full member
Activity: 322
Merit: 146
November 22, 2023, 09:43:59 AM
#21
Them all fails to realize say fake life offers lost of opportunities after their exciting posture where people who don see you finish go dey avoid you cuz constant request becomes burden, who observes your mind of person disregards you and who supposed help you for life over looks cuz you look like boss already plus ur accumulating debts way no bring productive returns instead you keep roaming the hoods like one dodging stray bullets while hiding from who you dey owe.

Some of them even mocks and tends to discourage others way dey work and earning penny while the fake lifes people no get shi-shi means of income just being dependants with low quality of personells .
full member
Activity: 308
Merit: 197
November 22, 2023, 09:01:46 AM
#20
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
   Fake life na normal life for this country ooo. Everybody dey try impress everybody. Person go jus dey try live above him means, which dey very wrong. Girls especially, na Dem get hands for this kain thing, Dem wan be like, Dem wan feel among, you borrow everything for party wey nothing comot or to go catch man by deceit, the same man wey go follow catch you by deceit too. Sometimes peer pressure dey responsible for the fake life because why on earth would someone wey no hold wan dey act like say him hold. This country no dey better, people dey struggle to live through their normal life, na him person go just stay decide say him wan live the life wey big pass am.
   We go hear say oga travel, leave house for gateman to look after, gateman get mind, call him irresponsible and unreasonable girls, lie to them say na him get am, sounds funny but na reality. Normally you dey try eat the little food wey you get for house, but as a guy wey dey expect girl, you go come go above your means to impress girl wey nothing fit comot wey you no even know if she too dey follow chop your normal routine for house. As a girl, you comot with man con use am as an opportunity to rip the guy apart financially, all because you wan show say class dey. E dey better to really dey contented o because if the economy no kee people for the country, na the thing wey yoruba people dey call "ojukokoro" go kee Dem.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 22, 2023, 08:43:23 AM
#19
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street...
Dat wan enta BlessingCEO well for body. She go use persin house pose as na she get am for social media and the real owner got her arrested. The worse part be sey na most of those people wey our youths dem dey worship as their role models dey do dat type of thing pass. Borrow pose. Dat attitude crisscross d entire human race, nor be only Nigerians dey do am. For me, anybody wey dey do am nor be principled person. In fact, the persin na mumu because im suppose sabi sey e nor good to lead ur life to please anyone.
full member
Activity: 560
Merit: 161
November 22, 2023, 03:48:27 AM
#18
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
People like this don believe say na with fake like this they fit meet up. Bit this is a useless lifestyle faking a life and claiming wetin you be, instead of living a fake life it is better to work hard and get something real that you can prove people it was earned from you. People who dey live fake life to impress people I still dey wonder how long they want lieve this fake life, if they wan live this their fake life forever, it is impossible because living fake like get it own consequences because e dey later backfire.  Giving people that you have it all is making them that you are okay with all you have and when you go need help from people them fit no reason you again.
full member
Activity: 266
Merit: 113
November 22, 2023, 01:49:39 AM
#17
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
you done hear the phrase "fake it until you become it?" Baba, some people de fake am so when de finally get the money e no go had them to live the kind of life them been done de fake. If na just to borrow car or cloth burst out event, I no too reason am as any big deal because even the oyibo when we de learn most things from de also buy car and with time de go de pay am small small. E De only get to me when I see person when no get shishi for account de form unnecessary when we see others. You see those boys when he carry bottle water everywhere eh, most of them no even get one room apartment when dem de stay, some of them no de even drink sat her water for there house but when he burst out like this De go shut down the street then go back house go sip garri.
hero member
Activity: 616
Merit: 509
Top Crypto Casino
November 21, 2023, 07:28:56 PM
#16
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
The feeling to be among the elite social groups is not only common in Nigeria alone, my brother this habit sometimes na due to peer pressure influence and many youth of this age dey always fall to am. Fake life dey always cast and it's not necessary because instead of living a pretentious life, try struggling and living your life as simple as you can and go on with flow and Wait for your turn to come.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
November 21, 2023, 07:25:52 PM
#15
Make I put mouth for this talk with my own 2 cent advice,  which is very simple and it will help a lot of us form unnecessary pressures.

1: we should be contented with whatever we have,  and also we should leave below our means and not leave or appear to impress anyone,  one of the measure causes of borrow posna because the person no want leave within him means and ability rather he prefer to fake it which will do more harm than good,  because a lot of time,  such lifestyle chase helpers away from you without you even knowing,  this is is most cases where your helper may even think that is them that even need your own help,  that is suffering and smilling.

2: trying to be in competition with other,  this na another reason why some people the borrow be that,  some want to match up with their friends so you see them borrowing cloths,  shoes and even under wears just to belong to a class where ordinary their are not,  this is why many of them fall victims to a lot of negative views at the end.
newbie
Activity: 18
Merit: 0
November 21, 2023, 06:42:05 PM
#14
These no be new matter again na lol .welcome to Nigeria .for Nigeria now na fake it it till you make it oh.in Nigerian people borrow cars,clothes,houses,shoes,bags even hairs just to impress their fans .and there is one thing with this fake life ,when you start it ,it becomes very difficult for you to stop .each and every day you would want to level up.this very common with women, these genders ready to do everything possible just to meet up.that one no mean say man Dey innocent.as a result of the fake life some people are now under pressure,they end up doing things that is unpleasant to the society just to meet up with there fake life.we no really know who be who again for this country again.But one thing I go like advice be say ,as youth make we try they cut our coat according to our material,so we don’t  get into trouble.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 21, 2023, 06:36:55 PM
#13
Angry Angry ,,,, What de fuck are you saying? If you don't understand what I am trying to say,,, you better not quote my comments bro.

Abeg oo, I no mean to offend anybody oo, after all na wattin you post naim I talk about oo, I no go manipulate text from anywhere, exactly the way you post am, na just copy and paste I do come quote you oo, besides I just write that thing for fun sake, no be say I mean to talk say you dey fully support the girls for wattin dem dey do. The only problem I get na as you talk say for the girls na just normal lifestyle while for the boys na to use am take impress girls, but the truth na be say you no go fit just exclude girl for using cloths to impress the opposite sex, in fact girls dey use am to seduce boys, period.

Talking about an infection,, are you trying to say that it is only the women that do get infected easily? If that's what you are thinking then you are apparently wrong because even the men do get infected and still pass it on to their wife's or their girlfriends after getting it from some of their concubines  Roll Eyes

Yes in mean it, based on study and real life experience it is know to be so, and there is nothing that can change that, females are very open and fragile, that why the are some times called the weaker vessels. Beside you even made it clear that men would pass infections to their wife's or girlfriend from their concubines Grin
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
November 21, 2023, 05:48:58 PM
#12
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

I don't know say you sef reason am oo, some people with fake life na 5&6, you know say fake life sef still get level, some people they on a norms their lifestyle them fit get money to dey drip, but shishi no fit they their pockets to take chop, this kind thing dey happen everywhere, you know say for their mind, they are think that person wey no dey drip woman no dey follow am, and for girls dey feel like say, girl wey no dey classic no fit get better men wey go follow them, how do they even comfortable they borrow person clothes wear, they no fit see them with the cloth another time, but they no send, you know we naija anybody wey dey leave fake life, if you are not close to them you won't know that they are faking everything in their lives.

For naija e no get any surrounding wey be say person dey without anybody leaving fake life, they con get one guy wey i sabi him very well well, leaving fake life wearing people clothes, he want to leave like his other friends in school, telling people say na oyinbo him dey scam, all this lie from people wey never see even $5 collect before   Cheesy the day wey me and the guy con get chance seat down, him just dey tell me say nothing dey this life na to leave fake life, like i just laugh and everybody believe say na oyinbo him dey scam, to extent wey be say people dey ask am for update.  Grin Grin
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
November 21, 2023, 05:44:20 PM
#11
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
I no sabi Wetin people dey get from that fake life wey dem dey leave, you no get something, y u go come dey pretend, but I know say Wetin dey make guys dey do that one na mostly because of women, but d most surprising part is how people dey fit maintain that kin life. And mostly girls dey leave that kin life so that if guys see dem, guys go dey reason say na big girl them be, and some dey do am just to make their friends feel jealous, but na rubbish me I see things like dis as. I dey hear am say dem dey rent even complete building for Abuja for like one day, and even cars dem dey rent. If you just wan impress girl you fit just rent house and car for one day, if d girl come she go think say na u get am, but na rubbish all those things be jare.
sr. member
Activity: 350
Merit: 295
November 21, 2023, 05:40:24 PM
#10
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

This is not a lifestyle by naija alone, it's a normalize life you see even outside naija because people try to show what they really not are, they want to impress people when they don't have nothing and I see that as nothing but inferiority complex.

It doesn't have age bracket, it can happen to people who suffer from peer pressure, people who try to impress women that are not their class but will go a lengthy leg to want be part of their life, people who want to show off their financial status when they don't have nothing in their bank account. Some of them even borrow car to take a girl on a date just to fell among and I get sick on this simping lifestyle.

However, I don't blame people who do this sometimes. When you show the world that you are doing the right thing and you are not there yet, nobody will take you serious. People want to live the present in the future and in a society when there are not plenty of opportunities, compromised is the only alternative and no wonder we have now high numbers of fraudsters(yahoo-yahoo) in the country, may God help us.
full member
Activity: 280
Merit: 172
November 21, 2023, 05:08:58 PM
#9
Teenagers and youths of these days they more attracted to finesse thangs. ( Drugs, Sex and Money). Just as Burnaboy call am "trabaye". If you no they leave this kind life you no fit, get best  freind again for the country. everybody wan go club, party they want feel among. As long as dey dey benefit one or two things from you from all these angle nah so they dey call you blood. E hard to actually there around all this peer influence but if you go fit withstand am then you go far for life.

I feel like say people no care again, they just wan live the life untill death call their name. The life no easy and any money way dem get they want use am enjoy. But nah the wrong thing to do in my own opinion. The way i see life nah say as long as you they live make you they make plans just the same way you they enjoy yourself cos its a very big world and you need to prepare for the unexpected.
my brother everybody wants to look clean with person cloth and  no be say anything they wrong with say make you like fine thing oh but make everybody know him pocket if you no fit afford am na to live the thing the way he they but to they borrow I no they that one, drugs and money worst because people especially young people fit go any lent just say they wan get money na the course be that, if them done get money the next thing na to enter club go party. and just because they want to enjoy life does no mean say make them live their life recklessly na make we they try watch every step we they take for life.
full member
Activity: 518
Merit: 156
November 21, 2023, 05:00:31 PM
#8
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

According to them, they say fake it till you make it. Omo I just don't understand why, some person's no go just live within their means, just to appear rich in the eyes of the public that don't give a damn about them and whatever they have to offer.
Such kind of life will end of leading those person's into criminal act whenever they don't have the means to sponsor or maintain that exotic lifestyle.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
November 21, 2023, 04:46:18 PM
#7
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

make i shock you say some persons no be say dem dey form, na just their normal lifestyle to dey select food even though say them never eat anything, dem prefer to stay hungry than to eat wattin dem no like, but the one wey pain me pass na those people wey their ogah give them car to go wash but dem go come end up using the car go flex and most times this flexing dey sabi purge dem, maybe the car go come get issue or get scratch and before you go know dem don loss the job wey dem dey manage. then concerning the cloths own i get one friend wey sabi live this kind of fake life, em go fit borrow both top and trouser like 5 from different persons take do fine boy. but i wan still clear your doubt say no be only naija this kind of things dey go on, na every where e dey most especially for this part of Africa.

Make i suprise you bro,na for naija you go see 2 guys wey they share the same dress just to impress people, na only god knows why em no give some people money for naija if not this country will have been worster than how it is now because the of kind life wey some of  them wan live for this our naija no be small thing, the one wey they pain me pass na em be say some of them sef no go wan do waiting there power reach na em even make stealing plenty for our naija now.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
November 21, 2023, 04:33:11 PM
#6
if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style.

rechael see your mouth like "if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style". how e take be una normal lifestyle wey you sef no say na bad thing and una fit still hustle to make money wey go dey enough to fit buy some fancy cloths for bolling. the fact say na bad thing na for both boys and girls, beside una wey be girls own naim even worst pass because un dey very prone to infection, make you no go borrow cloth from friend wey get sweety but she never tell you ooo, because na so so scratch scratch you go just dey scratch body anywhere wey you go  Grin Cheesy
Angry Angry ,,,, What de fuck are you saying? If you don't understand what I am trying to say,,, you better not quote my comments bro.
I don't mean it is good for women to borrow pose but nowadays it is something that is just normal just the way most men are smoking the hell out of themselves.
Borrowing is not good and it is something that no one should try to partake on.
Talking about an infection,, are you trying to say that it is only the women that do get infected easily? If that's what you are thinking then you are apparently wrong because even the men do get infected and still pass it on to their wife's or their girlfriends after getting it from some of their concubines  Roll Eyes
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 21, 2023, 04:14:23 PM
#5
if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style.

rechael see your mouth like "if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style". how e take be una normal lifestyle wey you sef no say na bad thing and una fit still hustle to make money wey go dey enough to fit buy some fancy cloths for bolling. the fact say na bad thing na for both boys and girls, beside una wey be girls own naim even worst pass because un dey very prone to infection, make you no go borrow cloth from friend wey get sweety but she never tell you ooo, because na so so scratch scratch you go just dey scratch body anywhere wey you go  Grin Cheesy
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
November 21, 2023, 03:44:39 PM
#4
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
The habits of borrow pose nah bad things because pesin dey do those things just to impress others, if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style.
But truth be told, borrow pose nah bad thing, but the real matter be say, no be we start this fake life of a thing,,,,, I dey try to talk say this nah part of many pipo life style. Sometimes, many pipo just win feel among, more especially when them see their fellow mate dey do the kind of things way them never do before. For instance, of your friends dey go night club and and you never go before, based on say them dey always bring some kind of goodies and some gist way them go dey yan you. One day you self go like follow them go and if you go go, you self go like look good,,,, if you no get good cloths, you go like borrow to pose.
But e no dey good,,, if you no get just try hustle to get.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
November 21, 2023, 03:27:53 PM
#3
Teenagers and youths of these days they more attracted to finesse thangs. ( Drugs, Sex and Money). Just as Burnaboy call am "trabaye". If you no they leave this kind life you no fit, get best  freind again for the country. everybody wan go club, party they want feel among. As long as dey dey benefit one or two things from you from all these angle nah so they dey call you blood. E hard to actually there around all this peer influence but if you go fit withstand am then you go far for life.

I feel like say people no care again, they just wan live the life untill death call their name. The life no easy and any money way dem get they want use am enjoy. But nah the wrong thing to do in my own opinion. The way i see life nah say as long as you they live make you they make plans just the same way you they enjoy yourself cos its a very big world and you need to prepare for the unexpected.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 21, 2023, 03:24:13 PM
#2
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

make i shock you say some persons no be say dem dey form, na just their normal lifestyle to dey select food even though say them never eat anything, dem prefer to stay hungry than to eat wattin dem no like, but the one wey pain me pass na those people wey their ogah give them car to go wash but dem go come end up using the car go flex and most times this flexing dey sabi purge dem, maybe the car go come get issue or get scratch and before you go know dem don loss the job wey dem dey manage. then concerning the cloths own i get one friend wey sabi live this kind of fake life, em go fit borrow both top and trouser like 5 from different persons take do fine boy. but i wan still clear your doubt say no be only naija this kind of things dey go on, na every where e dey most especially for this part of Africa.
jr. member
Activity: 135
Merit: 6
November 21, 2023, 01:59:42 PM
#1

Jump to: