Author

Topic: FAQ; Everytin way u need to no about forum activity, ranks dem and merit. (Read 98 times)

sr. member
Activity: 476
Merit: 337
OP since e be say na @hilariousandco thread you carry come translate for local board so, i go also like to give my own Opinion for pidgin because as the forum be like this no body sabi everything because as days dey go na so person dey discover one or two things for the forum so you try as you carry this thread come translate for local board because some of us for the forum just join the forum based on the little knowledge wey we don get but the inside of the things wey we suppose know we no dey too pay attention unto say most of us as we just come online na to begin dey make post without trying to glance through some important boards for the forum to know what's up, just like this board wey you carry this thread come from (META BOARD), na only few people or high profile members dey mostly enter that side they view things and things but for some low members dem no dey too reason to go dat side so as you carry dis thread come local board like this e go help a lot of persons and not only the newbies or low ranked members.

Just like in the calculation of activity, when i join newly as i dey make posts na so e dey tally with the activity so e come reach one time wey my activity no come dey move again as i dey make posts i come begin dey fear whether i don commit one offense wey make my activity no come dey move again, na so i begin do research o till i come jam dis particular thread by @hilariousandco for meta say na when person make like 14 or more posts in 14 days naim the activity go top by 14 count, i just laugh and as e just complete that 14 days na so my activity top o from there naim i take understand how the system dey work.

But e get question wey i wan ask because i discover say na mostly on wednesdays of that 14 days naim the activity dey top up but i wan ask whether na all the profiles wey meet up 14 posts or more than within that 14 days interval naim their activity dey increase like dat abi e get some profiles wey their activities to add up for different days wey no be on wednesdays?
The truth of the whole matter be say, no matter the rank way many bitcointalkers dey, them no still know some of things about post, activities and merits. The worse of them be say some people know Sabi the board way them supposed to post some threads way dey related to their discussions, and because of this, many boards no dey organized. Just like our board before we get moderator, both political discussions, Bitcoin discussion, off topics, plus some gambling dissections been dey go on for the board (although we still try our best to keep the board clean sha).
So, to conclude this talk, OP try to translate this thread for our local board, because this Nigerian board nah one of the board way dey get newbies almost everyday.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
But e get question wey i wan ask because i discover say na mostly on wednesdays of that 14 days naim the activity dey top up but i wan ask whether na all the profiles wey meet up 14 posts or more than within that 14 days interval naim their activity dey increase like dat abi e get some profiles wey their activities to add up for different days wey no be on wednesdays?
Next time please quote me when asking any question so I'll be aware I don't actually track all the threads I create I just happen to stumble upon your reply just now.

Anyways the answer to your question is in the OP already

Noted, though e just be like general question wey i ask so anybody fit answer am sha naim make i no quote you

Quote
Na because say you fit only get 14 activity inside every two weeks . You go need to wait until the next period don start to take get another 14.

These two answers your questions partially. The Idea is if your activity adds on Wednesdays like other people too then it means you guys likely joined the forum in the same activity period. If you joined the forum just before that Wednesday activity period then you will get both the activity for the period you registered and the next one too since you registered like in the middle. So not everyone has their activity adding on Wednesday.

Thank you as you come explain the thing well for me like dis now naim be dat tin wey i talk na say person no dey know everything finish for forum because i dey see so many people activity dey increase mostly on wednesdays so i come dey assume say na so e be for every bodi.

Quote
Mine adds up on Thursday I ranked up to hero today.

Wow congratulations to you on your newly achieved rank, you just gather enough merit like this come dey wait for activity for you to be confirmed as a hero member. You do well for your immense contribution to the forum and i must say i admire your intellectual capacity a lot. I go like be like you when i grow up o lol Cool
sr. member
Activity: 448
Merit: 560
Crypto Casino and Sportsbook
But e get question wey i wan ask because i discover say na mostly on wednesdays of that 14 days naim the activity dey top up but i wan ask whether na all the profiles wey meet up 14 posts or more than within that 14 days interval naim their activity dey increase like dat abi e get some profiles wey their activities to add up for different days wey no be on wednesdays?
Next time please quote me when asking any question so I'll be aware I don't actually track all the threads I create I just happen to stumble upon your reply just now.

Anyways the answer to your question is in the OP already

Quote
No. But, you fit some how  get pass 14 activity inside one fortnight if you sign up inside center of periods, but you no fit  get pass 14 activity inside one fortnight. For instance, if the period start for Wednesday and you come sign up on Tuesday you fit get 14 points on Tuesday com sti get another 14 on Wednesday as long as sat the period don start. You go come get 28 activity points but you no go fit  get any one join until two weeks' time when new period don start.

Quote
Na because say you fit only get 14 activity inside every two weeks . You go need to wait until the next period don start to take get another 14.

These two answers your questions partially. The Idea is if your activity adds on Wednesdays like other people too then it means you guys likely joined the forum in the same activity period. If you joined the forum just before that Wednesday activity period then you will get both the activity for the period you registered and the next one too since you registered like in the middle. So not everyone has their activity adding on Wednesday. Mine adds up on Thursday I ranked up to hero today.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
OP since e be say na @hilariousandco thread you carry come translate for local board so, i go also like to give my own Opinion for pidgin because as the forum be like this no body sabi everything because as days dey go na so person dey discover one or two things for the forum so you try as you carry this thread come translate for local board because some of us for the forum just join the forum based on the little knowledge wey we don get but the inside of the things wey we suppose know we no dey too pay attention unto say most of us as we just come online na to begin dey make post without trying to glance through some important boards for the forum to know what's up, just like this board wey you carry this thread come from (META BOARD), na only few people or high profile members dey mostly enter that side they view things and things but for some low members dem no dey too reason to go dat side so as you carry dis thread come local board like this e go help a lot of persons and not only the newbies or low ranked members.

Just like in the calculation of activity, when i join newly as i dey make posts na so e dey tally with the activity so e come reach one time wey my activity no come dey move again as i dey make posts i come begin dey fear whether i don commit one offense wey make my activity no come dey move again, na so i begin do research o till i come jam dis particular thread by @hilariousandco for meta say na when person make like 14 or more posts in 14 days naim the activity go top by 14 count, i just laugh and as e just complete that 14 days na so my activity top o from there naim i take understand how the system dey work.

But e get question wey i wan ask because i discover say na mostly on wednesdays of that 14 days naim the activity dey top up but i wan ask whether na all the profiles wey meet up 14 posts or more than within that 14 days interval naim their activity dey increase like dat abi e get some profiles wey their activities to add up for different days wey no be on wednesdays?
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
This is a very good translation you've done here and bringing it to the local board will help newbies that are finding it hard to get some basics understand these key and vital information that will help them build a solid foundation in the forum as a starter.
Watin b Merit?

Merit is a new system created in order to reward quality contributions to the forum. Now to rise through ranks you will also need to acquire Merit in addition to Activity.

I just want to point this area out, I don't know if you skipped it while translating it but it seems you forgot to translate this explanation of "what a merit is" into pidgin.

If that's the case then you can just edit and translet this part to pidgin like the other part of the thread.

sr. member
Activity: 448
Merit: 560
Crypto Casino and Sportsbook
ORIGINAL TOPIC: FAQ: Everything you need to know about forum 'activity, account ranks and merit
TRANSLATED TOPIC: Everytin way u need to no about forum activity, ranks dem and merit.
AUTHOR: hilariousandco



The way dem take de calculate activity de somehow  hard to take understand, but we fit just talk say  you fit only get 14 activity points inside every two week time.. This one na the main thing  way u need to know but I go still explain the thing way  make am b like say e hard to understand and technical part of d matter way the system de use for  under so. Dis na to to avoid any tin way go confuse u:

★ You fit only get 14 activity point inside every two two weeks.
★ The two weeks period way activity takes de add no de change and e no de start from when you take sign up join forum.
★ u fit see d list way get all the date of the activity period for inside this spreadsheet (big hailing give jambola2 for am say him Arrange am).
★ You fit still get pass 14 activity inside 2 weeks if you join forum for inside center of two activity period.
★ You go only need to make one post if at all inside each activity period for you to take collect the activity for another date way pass am. For instance na, you U go fit make 1 post na inside three different period and you go come get 3 post and 3 activity join, but normal you suppose get activity way reach 42. That one mean say oonce u don make the 42 post you go get the 42 activity but u no fit get pass that 42. If you make one post inside 35 different period, you go get 35 post and 35 activity but normally e suppose reach 480 activity. That one mean say because of your activity you go de junior member but if you come make 480 post you go turn hero member sharp sharp.
★ If your post count come pass your activity by 14 or more then you go only need to make one post inside  the new period to take get the full 14 activity. For instance, say your post count na 200 but your activity na only 28. To take get another 14 activity you go only need to make one post inside the new period and you go come get the complete 42 activity.

Rank  and activity:

Brand New: 0 posts
Newbie: 1-29 activity
Jr. Member: 30-59 activity
Member:   60-119 activity
Full Member: 120-239 activity
Sr. Member: 240-479 activity
Hero Member: 480 activity
Legendary: Around that kind 775 and 1030 activity

Merit:

To take add join your activity you go come need merit to take de gain rank. The merit way u go need de down :

Brand new: 0
Newbie:   0
Jr Member: 1
Member: 10
Full Member: 100
Sr. Member: 250
Hero Member: 500
Legendary: 1000

for here na table of the activity period and the time way e go take u to take reach each rank:
Code:
1 X 14 = 14
2 X 14 = 28
3 X 14 = 42  ---  Junior. Member (1.5 month)
4 X 14 = 56
5 X 14 = 70  ---  Member (2.5 month)
6 X 14 = 84
7 X 14 = 98
8 X 14 = 112
9 X 14 = 126  --- Full Member (4.5 month)
10 X 14 = 140
11 X 14 = 154
12 X 14 = 168
13 X 14 = 182
14 X 14 = 196
15 X 14 = 210
16 X 14 = 224
17 X 14 = 238
18 X 14 = 252 --- Senior Member (8.5 month)
19 X 14 = 266
20 X 14 = 280
21 X 14 = 294
22 X 14 = 308
23 X 14 = 322
24 X 14 = 336
25 X 14 = 350
26 X 14 = 364
27 X 14 = 378
28 X 14 = 392
29 X 14 = 406
30 X 14 = 420
31 X 14 = 434
32 X 14 = 448
33 X 14 = 462
34 X 14 = 476
35 X 14 = 490  ----  Hero Member (1.3 years)
36 X 14 = 504
37 X 14 = 518
38 X 14 = 532
39 X 14 = 546
40 X 14 = 560
41 X 14 = 574
42 X 14 = 588
43 X 14 = 602
44 X 14 = 616
45 X 14 = 630
46 X 14 = 644
47 X 14 = 658
48 X 14 = 672
49 X 14 = 686
50 X 14 = 700
51 X 14 = 714
52 X 14 = 728
53 X 14 = 742
54 X 14 = 756
55 X 14 = 770
56 X 14 = 784  --- Legendary rank (2 years)

-------------------

Activity FAQ:

Why e b say my activity de one place / enormous de move?

Na because say you fit only get 14 activity inside every two weeks . You go need to wait until the next period don start to take get another 14.

Why my rank/activity never gree change or update?

E fit take reach one hour to take update. Just de patient.

My rank or activity fit reduce?

Yes. E fit reduce if dem or you delete all the post or thread way you make for inside one particular period or watin u post dem move am go trash. If you do am e de  possible to reduce rank until u don get enough activity again.

I fit get pass 14 activity inside two week period?

No. But, you fit some how  get pass 14 activity inside one fortnight if you sign up inside center of periods, but you no fit  get pass 14 activity inside one fortnight. For instance, if the period start for Wednesday and you come sign up on Tuesday you fit get 14 points on Tuesday com sti get another 14 on Wednesday as long as sat the period don start. You go come get 28 activity points but you no go fit  get any one join until two weeks' time when new period don start.

Watin go  happen if I miss one period?

Nothing go sup . Only say you nor go  just get that activity and you don miss that activity forever. Just make sure say you make post inside the next period to take get another 14.

Why I not fit change my avatar?

You go need to be  Full Member or pass am sef before you fit get your avatar.

When I go take become Legendary?

You go become Legendary anytime but na somewhere inside that kind  775 and 1030 activity.

Time way we de spend online de add join activity?

No. E not de count join anything and e no get  meaning if you de calculate  am.

E get special board or minimum character length way go count join activity?

No. All boards and posts of all length de count towards the two of dem.

If I create account com leave am for some time , e rank go increase Wen I don come back?

No. You go still be newbie. Activity de measure how you take de active for the forum and na to prevent against lazy account farming. If you nor make at least one post inside each period then you nor go  get that activity.  

Why I no fit post image?

Because you go need to de Junior Member to fit do am . To take become Junior Member you go need to don  post inside  three activity periods and you go get  at least 28 activity. But , you fit pass all dis tins if you buy Copper Membership for small money here.

-------------------

Merit FAQ:

Watin b Merit?

Merit na new system way dem create to take de reward better better contributions for the forum. Now to take de increase  for rank you go sti need  need to de earn Merit join Activity way u get.

How I go take de receive merit?

People way find say Ur post carry load and e de helpful fit give you merit.

How I go take send Merit?

+Merit button de on top for edge of every post. To take give merit click on am den follow the instructions way De.

Watin b d  difference betwen Merit and sMerit?

Two type of Merit na him de. You nor fit  send your merits, na only sMerit you fit send. For every Merit way you receive you go get 0.5 merit way you fit spend to take reward post way you  feel say worth am.

I fit ask for merit?

No need to de ask for merit as dem go even see d matter as 'merit begging' and d community no like am at all and e fit cause de make dem give you negative feedback. Continue to de make quality and better better post you go surely see merit.

I fit sell merit?

To de sell merit no de allowed for here.

I fit give my alt accounts dem merit?

No, the forum no de gree for dis one and dem fit give you negative feedback if dem catch you

dem fit demerit me/ I fit lost merit?

No, as e de b now . Even if say your post dem  remove am d  merit go still de.

Watin b merit source?

Dem get particular number of special  Merit source who fit  receive extra amount of merit to take give away. The list of dis people no de public  but Staff for forum no dem

How I fit take be merit source?

From watin theymos' talk:

If you wan be merit source:

 1. Be a some what established  member.
 2. Collect TEN posts written in the last couple of months that have not received nearly enough merit for how good they are, and post quotes for them all in a new Meta thread.
 3. We will take a look at your history and maybe make you a source.

Limit de to how many merit I fit send?

Yes. You no fit give pass 50 merit give any user inside every 30 days.

Merit stats: https://bitcointalk.org/index.php?action=merit;stats

Note: Abeg nor make useless 'thanks for the info' kind post for here because dem go remove am, d same tin go happen to any question way dem don already answer or explain. If something no clear or dem need to add am den dat one de ok and I go add am join the op.

Abeg report any thread way De ask questions way dem don  already answer for here because  dem don de unnecessary and dem go remove am . Una Thank you oo.
Jump to: