I tell you that, 8 years is too small, we get chance now to help our dear nation Nigeria, if by any chance, we get it wrong again this time, I tell you say, in the next 40 years, we go still dey suffer wetin go happen for this country, I no dey talk this thing say I feel like to talk, this na pure revelation I dey share with una so..
Among all the presidential candidates, anybody wey dey in his or her right senses and truthful to him or her self, know say na Peter Obi na im be the most qualified, me no dey hide my own, i no dey fear anybody, as e be me, na so I go talk am.
No go vote for Tinubu, Tinubu no get anything to offer Nigeria, he just won be president because he feels day na him turn to be president - as to him, ruling Nigeria na turn by turn thing.
No go vote Atiku, Atiku is not a Nigerian, this man no dey live for Nigeria, he no know wetin Nigerians dey go through, if he become president of this country, na Dubai him go go relax dey Chop Nigeria money, he no go ever know or care about wetin dey happen for this country or the sufferness wey we as citizens dey face.
Abeg, vote Peter Obi, na this man na him be the only person wey fit help us rescue this country, forget whether you be igbo, hausa or yoruba, Nigeria na all of us get am, if e good, e go good for all of us, if e bad, na still all of us e bad for ooh, nothing concern tribe concern this one ooh.
I stand with you, no body too righteous but among everybody way come out for this presidential seat nah still Obi be the best option, nah only who no care about in family and generation to come fit go vote for Tinibu or Atiku to come rule diz country again.
Diz time around no be party or religion something nah who go deliver we stand out for, nah just few hours to the main day and my vote don already set for Mr. Peter Obi