As a Nigerian, I deh see people drag food for events weh them go. E no even matter whether na burial or child dedication self. Na wedding own worse pass. The part weh deh surprise me pass be say even young people in their 30s and 40s weh get jobs and deh work too don join for this thing.
Before na old people weh I deh see do am. The old people own na to pack party food go house. And thereby deh disgrace their children weh no go too like the thing. Now young people don follow dey do am too. People weh go talk say na hunger in the land, but why people weh also get jobs and they earn salaries come deh do am too? I shock yesterday for burial event weh I attend and na this type of thing happen there too.
Abeg make una put mouth for this matter as it is getting serious by the day.
See mk I tell u, u see this our beloved country, u see anything food, dem no dey carry am play, anywhere free food dey come from whether wedding, burial o, naming ceremony etc, as far as say free food dey come out from, dem no dey shame to dey drag am o, wen dem don see say that day food don dey sure for and u come want mk dey come dey Shame because say dem dey for occasion, although I no too blame people wey dey drag food for events o because this country wey be things dey cost steady and to dey see beta thing wey go give u better money to dey buy food no easy, some self to see food na war for dem, so if dey see that opportunity dem dey grab am well, some dey even fight for because e no easy o for this country but the one wey dey pain me pass na that ones wey be dem get better work and food no be their problem but yet u go still dey see dem dey drag food, maybe dem dey get joy to dey argue with people or maybe dem won add more to the ones wey dem get.