Author

Topic: Forget all the hate, nija still de try for so many sectors. (Read 95 times)

jr. member
Activity: 67
Merit: 7
naija dey try na for the citizens effort no be government I think say as u dey write you go talk about the areas were by we dey improve Nigeria no ever get any plan for em citizens na why things dey hard us in many ways

1, Technology for this aspect me and you know say we dey almost zero for this aspect we no even get better satellite 🛰️ our network sef dey very poor no improvement even common light wey we use dey brag say we dey give Ghana we no get am so how our technology come take dey improve na only Nigerians wey dey into some technological field dey try both home and abroad so no give the credit to Nigeria government but to it's citizens.

2,for the aspect of professionals Nigerians to me na Nigerians get brain pass for this world because any thing we decide to learn or do we be the best Nigerians dey do exploit in the medical field outside naija but we country one frustrate them na why them dey one japa abroad Nigerian doctors na the most sourced in the world but look back to this our beloved mother land nothing to write home about.

3,Nigerians dey really try for entertainment aspect.

4,this religious aspect na be our weakness oyibo wey being religion still dey believe on research and technological advancement while we dey here dey believe only in religion wey be say our hearts no even pure oyibo Just use religion deceive us and we dey m*mu follow Dem imagine just last week Dem sack nurse wey Dem employ to treat person just because e pray instead of to do em job e think say na Nigeria e dey.

5,I believe say we no dey do more on our culture as a country we no dey promote am enough westernization dey take over us.

so my brother naija as a country itself never improve na the citizens dey they place the country for higher place.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
On a serious note, Nigerians are blessed with so many abilities wey be say others they try imitate and even dey wish say dey fit belong here. Just say na our government dey fuck us up if not the kind level wey Nigerians suppose don reach for done pass where we dey so. But even with wetin we dey face Nigerians still dey beat the chart, come for the Music industry, choi... See our Davido wey perform for world cup no be say other white musicians no dey but base on the kind talents and uniqueness wey we get na we still perform.

I sure say come for brain as even my fellow brothers don talk am, Nigerians no dey carry last. Most of our Nigerian brothers wey go that side go further their education dem no dey gree dem come back base on their capability to do much better than even them the whites.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Normally Nigeria naim get one of the hard working individuals wey fit go the extreme level to prove success, if you talk about tech we get so many technicians both locally and international level, if you call music I go say na er be the best. But all this na individual benefits no be say na for the whole country, this achievement outside the country just dey make our country get good name for outside but for inside na die we dey. And that thing no good at all, because even for the holy book Jesus make emphasis on am, when e been dey talk say the Pharisees dem be like grave wey for the outside dem design am but the inside dey full with dead dry bones. Our citizens dey try but our government nor dey do wattin go justify say dem dey appreciate our efforts.
full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
Nor b say Naija people no dey do well any were dem dey, but d bad leaders for our country Naija na dem dey make Naija no dey do well which u no it very well and, d tin dey affect our people anywhere dem go and, before our Naija local board leaders succeeded to create dis local board, it make dem pass through so many things before it was approved for dem to make it a reality today for me and u to enjoy. Can u tell people here say Naija dey try for dis hardship economy wey dey take people life and e dey push some young men and women to do some bad tins in d country just to get money to survive from d land.

I agree with u say Naija people get Brain wey dey work well which, are part of some of d tins  dey make others oyebo people dey respect Naija people anywhere dey see Naija people because, our eye dey focus everywhere in dat particular sector and if u give Naija person to run such sector just a year, u go see new improvement in dat sector.
full member
Activity: 560
Merit: 161
I
1. We de do very well for the Technology space
2. We de get one of the best brains for most professional areas outside we country like medicine and engineering
3. Our entertainment industry na one of the best for the world. Nollywood and our music industry de deliver us wetin no nice
4. Even for this forum, nija follow for one of the most active boards when de get quality conversation going on.
5. Religion nko? You self you know the matter na.
6. Our culture go well wetin no nice and if no be say we done de trowe some of them eh, Nija get amazing cultural lifestyle on a normal.

So many areas de when we de do very well and I just want talk say make we try de talk good about our country sometimes. If others reject and speak evil of our mother land, we go follow then deny nija?

Make we try de show the world say we be nija and say we no de ever carry last.
All this thing wey you just mentioned na wey dey do well for naija and e dey do well because na the effort wey common Nigerians put to make sure say e go far. No doubt if you check a common Nigerian dem deytry very well and we can see that in our music industry and our film acting, in academics abroad and so many things. But if we say make we look how the government don performance for this country,  nothing come out oo, for the government side e come be like say naija dey they go backward, where they government don take us reach the truth be say some years back was better than our present right now.
sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
Wetting you talk really sweet my Belle. At least i don see who don talk good about our country 9ja this year. Our country 9ja no dey carry last true true, but na just our leaders come make am be like say naso the country bad reach. One funny thing be  say the more the economy they bad, the more our youths dey discover there tarlent. If you check every thing we happen for we country Naija na Cruse, wetting no make sense Dem must turn am to joke by content creation or comedians go use am crack jokes even the thing go come sweet you. Just like wetting happen recently for kizz Daniel bouncer when them go show wey him push person down, and also carry him boss from who wan take pix with am. Now kizz Daniel bouncer dey trend and with that singular act, him don blow and many upcoming content creator don use that thing come to land light.

Then for music in African, Nigeria na top for music we get swag. Before foregn musicians them been no dey like future Nigerian musicians, but check now Naija music dey trend for any music station be it mtv base or for some gotv channels even DStv etc. Everywhere Dem dey most African countries dey come Lagos now sothat Dem fit future Davido, Wizkid, burna boy and the rest of them make them blow. If you check the last show wey Asake do for O2 arena for London you go confirm wetting I dey talk. London girls no dey even mind say na pidgin language again self, e dey even sweet them. Bado wey be Asake oga self never even go show for O2 arena but him boy Asake don go dere. That is say the youth dey push Sha.

Even for Nollywood wet you dey talk too. Dem Don dey try expecialy for Netflix. If you watch the standard of films dem dey promote there you go confirm say we dey try. E no be like all those nomarl once we dey regularly watch.

Then for Doctor and engineering Nigerians all over the world dey try. For some countries Nigerians wey be engineer or doctor, them no dey gree make we come back again because of our hard work and smartness.

Just take a look at wetting happen to Nigerians for South African zenophobia attack on Nigeria At 2021. From a report from a southern African lady that year show say Nija dey try. Wetting she talk wey cause that attack dey as follows:
1) Nigerian Sabi dressing
2)Dem dey caring for women and romatic
3) Dem dey hard working, Dem fit dey do 4works at a time
4) Dem Sabi satisfy woman for bed, and them get big gbola
5) Almost all the business wey dey south African na Naija people get am.

So all this things come make south African women come dey choose Nigerian guys over there own men. Because there men dey lazy and depends on there women for survive where as ba vise versa for were 9ja man dey.

As I also dey navigate through this forum I see say 9ja dey dey active pass so many local board. And we dey grow.for Some country local board no body dey give merits. Activities go reach 2000 Merit na 5 but for Naija activities go dey 500 merit don reach 700. Naija no dey carry last.
member
Activity: 64
Merit: 63
I know say na as a result of wetin most Nigerian de go through na him de make us para whenever we are giving the platform to air our view about the country but make we no forget say Nigerian de do extremely well in so many areas like;
1. We de do very well for the Technology space
2. We de get one of the best brains for most professional areas outside we country like medicine and engineering
3. Our entertainment industry na one of the best for the world. Nollywood and our music industry de deliver us wetin no nice
4. Even for this forum, nija follow for one of the most active boards when de get quality conversation going on.
5. Religion nko? You self you know the matter na.
6. Our culture go well wetin no nice and if no be say we done de trowe some of them eh, Nija get amazing cultural lifestyle on a normal.

So many areas de when we de do very well and I just want talk say make we try de talk good about our country sometimes. If others reject and speak evil of our mother land, we go follow then deny nija?

Make we try de show the world say we be nija and say we no de ever carry last.

From your analogy, it is the people who should be applauded. It is Nigerians who are trying and not the country not minding the fact that you cannot talk about a country without it's people since it is the people who make the country. But then, when you assess a country you look at different areas like health, security, education, employment etc. These sectors have suffered and it is appalling.

In the area of entertainment, Nigeria is in the limelight because it is individuals who run the sector. I put it to you that any day the government decides to control the entertainment sector, the sector will suffer because the concern will no longer be on bringing growth but on how to accumulate wealth.

In the area of excellent performance of Nigerians in medicine and engineering, I think on the one hand, credit should be given to the countries that create the enabling learning environment for Nigerians studying outside to excel but the implication is that these countries retain them and Nigeria don't get to benefit from the knowledge.

In the area of culture, it will be difficult for our culture to erode completely because the locals still cherish their heritage.

In the area of technology, Nigeria has done nothing. Even the locally-produced cars by Innoson Company, the government still doesn't patronize the company. Innoson should have been used as government official car but it is not because we don't even trust our own so I disagree with you in the area of technology   
full member
Activity: 490
Merit: 225
I  know say lately, if people wan talk about nija matter eh, e de always be the negative side when we de easily talk about. Even for this forum, if you check well you go notice say almost 70% of the threads we de get for the board when relate with our country, e de mostly be regarding things when we no de do well and most times, e de blind us to the so many areas when we de do well for both the local and global stage.

I know say na as a result of wetin most Nigerian de go through na him de make us para whenever we are giving the platform to air our view about the country but make we no forget say Nigerian de do extremely well in so many areas like;
1. We de do very well for the Technology space
2. We de get one of the best brains for most professional areas outside we country like medicine and engineering
3. Our entertainment industry na one of the best for the world. Nollywood and our music industry de deliver us wetin no nice
4. Even for this forum, nija follow for one of the most active boards when de get quality conversation going on.
5. Religion nko? You self you know the matter na.
6. Our culture go well wetin no nice and if no be say we done de trowe some of them eh, Nija get amazing cultural lifestyle on a normal.

So many areas de when we de do very well and I just want talk say make we try de talk good about our country sometimes. If others reject and speak evil of our mother land, we go follow then deny nija?

Make we try de show the world say we be nija and say we no de ever carry last.
Jump to: