Author

Topic: GOOD NEWS: CBN DIRECT BANKS TO LIFT RESTRICTIONS ON CRYPTO RELATED ACCOUNTS (Read 128 times)

newbie
Activity: 59
Merit: 0
After a long wait, I'm just concerned for those that their account were suspended and funds withheld, i hope they get to recover their funds back, is it still possible if i may ask?
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
Hmmm,great relief so finally our prayer don answer. This na the best news wey I don hear today and as I dey type this message my belle dey sweet me say crypto go soon get ground for Naija and we go fit use am overcome poverty legally based on the area of our involvement for the crypto business. Tinubu try for this one honestly,when we see good thing make we also talk say e good. This na big shame to that Emefiele wey think say him na God. I just hope say na more good news we go dey hear.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Now some people way be our fellow 9ja brothers way no too sabi trading they carry watin the government bring as bad new they chop, as nah them they be the major buyers and sellers for P2P platforms, those small small change way they enter for them, them they also chop from their.. and many other peti-peti tinx way that their ban don carry open person eye.. me i no see that their ban like anything way draw crypto growth back for 9ja instead eh even bring more people inside am, if u check the record of piple way been dy inside crypto then and now u go see say now people don join more pass that time.

Those brothers wey dey rely on P2P sells, the government unbanning of bank account linked with binance no go still worry them because their business go still dey go on. Those people wey dey trade with them before fit still dey continue if them don make Dem good customer or worse worse Dem fit reduce price and instead wey dem go want go through binance, dem fit still continue with them. In fact them fit even no go back to the account again unto say naija government no dey straight forward. However, the advise be say we no need to dey rely on one business, we need to dey also put hand for other source for income.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
My people, una don hear say CBN don direct all banks to lift all the restrictions wey them sama give some accounts wey dey do business in cryptocurrency and other finTech. To me. This na better news for us wey dey for the crypto industry.

Make una no forget say, the action of CBN be slow down cryptocurrency businesses and activities for our country as many people who for dey use crypto come dey comot body to avoid wahala from our government. Even GTB been carry the matter for head come dey close account of people wey them notice say na crypto or forex them dey do.   But as e be say them don give greenlight say people dey free to use crypto, we go dey expect say crypto will have greater penetration for our country and that na good thing.

This na the article for people wey wan read the full gist:
https://www.primebusiness.africa/cbn-orders-nigerian-banks-to-lift-restriction-on-accounts-of-crypto-other-firms/

My people how una see the matter?

We can now directly buy and sell bitcoin from our bank accounts. This na one of the good news wey I don hear for this year. And this go make things easy for sellers but the price nai go make persons to use some other exchange platforms. Because those banks are not reliable.
hero member
Activity: 574
Merit: 627
Make una no forget say, the action of CBN be slow down cryptocurrency businesses and activities for our country as many people who for dey use crypto come dey comot body to avoid wahala from our government.

Eh work for both ways.. as them announce the thing for that week people been stop come they fear make dem no fall enter government trap, but after that time, people come even discover say that direct withdrawal way we been dy do 4 doz platform way allow us withdraw to our account, dem been they thief us small, but now if u watch well Nigerians don wise up well well now as most people don they even fine means of doing their things off the government track, P2P platforms now don plenty full everywhere both the one way dy inside exchange and the one way dy for dex exchange, almost every big exchange now don they add p2p option now for their side so that dem fit pull Nigeria crowd come their side.

Now some people way be our fellow 9ja brothers way no too sabi trading they carry watin the government bring as bad new they chop, as nah them they be the major buyers and sellers for P2P platforms, those small small change way they enter for them, them they also chop from their.. and many other peti-peti tinx way that their ban don carry open person eye.. me i no see that their ban like anything way draw crypto growth back for 9ja instead eh even bring more people inside am, if u check the record of piple way been dy inside crypto then and now u go see say now people don join more pass that time.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
If this news Is real , congratulations to us in this house because we have been praying for it to come so that we will start purchasing goods in the country and pay with BTC. I believe that this new government will not joke with CBN banned on crypto and BTC in the country  because the new president is a someone that has idea on decentralized business and he has use it to build Lagos when he was a governor. And during his campaign he made mention of cryptocurrency that made me to believe that crypto users will breath in this new government.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
Even though am not a doubting Thomas but not until i see more people and banks back to using crypto and making payments from the financial institutions, i may not believe anything about this, i also expected the news to have circulated more than this because it's something that should attract more discussion on since everyone into bitcoin is involved, if truly the ban is lifted then we should also see other news channels taking this up for trending because am not trusting the source alone here, don't know if other members have more confirmations on this approval to be true.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Play Bitcoin PVP Prediction Game
In other words what do I mean, since this restrictions are being lifted from their users there is every tendency that any account that involves themselves with cryptocurrency trading there must be a specific fee or percentages to be withdrawn to keep milking her citizens and I know the person on seat as a task collector who doesn't do anything without attaching values to it.
This is Africa so there's nothing to be over joy of since they can't simply acts straight without attaching value to it.
This is done in other develop countries, this will basically be a tax if its done this way and its nothing bad because the government have to find a way to earn from it ( its mainly for the economy)
Quote
How much is crypto taxed in the USA? You'll pay up to 37% tax on short-term capital gains and crypto income and between 0% to 20% tax on long-term capital gains - although NFTs deemed collectibles may be taxed at 28%
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
Well this is a good news but no longer good news to interest people anymore since they can't do anything without attaching values to it, why from experience as a Nigerian Lady, our government does what will only favour them. In other words what do I mean, since this restrictions are being lifted from their users there is every tendency that any account that involves themselves with cryptocurrency trading there must be a specific fee or percentages to be withdrawn to keep milking her citizens and I know the person on seat as a task collector who doesn't do anything without attaching values to it.
This is Africa so there's nothing to be over joy of since they can't simply acts straight without attaching value to it.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335

Jump to: