Author

Topic: Guber Elections: Did Nigerians decide, or INEC decided? (Read 64 times)

member
Activity: 212
Merit: 12
My dear, I like this your question so much, whether na we the mases decided or na INEC decide?

This election wey pass so we be think say time don reach make we decide who go lead us,but after our efforts and support na INEC come select the leader so that is to say na INEC they decide oooh no be mases ooh..

So they thing be mases decide and INEC select, and the thing dey pain us well well because e no supposed to be so because INEC is just a few persons but mases are in the large numbers so it's very very unfortunate that this kind of thing is happening in this country..
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Nigerians no dey decide o, na inec dey decide, people go vote for who Dem want to represent Dem, inec go carry mandate give who Dem want and like or who Dem don collect money from, the matter sef come make people no dey gree come out to vote again, e don really discourage people, Even me too I feel so discouraged to come out and vote because e just be like say we dey waste our time.
Okay make we just check the past presidential and governorship elections na,
Peter obi win elections but inec chairman rig the election come carry mandate give tinubu,
Okay check rivers State governorship elections, it was rigged because you no go tell me Sim Fubara go win for all the 23 local governments in rivers State na, omoh it's not possible na, it's pure rigging abeg...
Na God go help us oo...
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
This now a day's election just get as E be, we just dey think say na we dey vote but person wey go win Don already know say him go win before the election, as I'm talking now my state guber election just be like magic, because no be person people dey support very well win the election, person wey win na APC, as he stands now the matter dey court now, this year election just be like say them Don plan am since say na waiting them go do because na APC put that INEC chairman for that him sit.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
The way things are currently going, many people are beginning to lose faith in INEC, and the numbers that were reported for the presidential election were different from the numbers that responded during the governorship election. The numbers have decreased so much that it has had an impact on the results, and it is only a matter of time before people will go to any lengths to ensure that their candidates win. Seriously, INEC is too corrupt to even override the interest of the people.
full member
Activity: 301
Merit: 132
Cashback 15%
Nigerians don't decide no more. What we do is we waste our time and energy going to the poll units and after the stress, then inec will now decide for us. It is a bad and painful thing that we the Nigerians voice can't be heard again, our opinion doesn't matter no more. Whatever they do, i still believe in Nigeria and will be proud of it. One day God almighty will bring us a leader who will listen to our opinion and our votes will count.
member
Activity: 308
Merit: 26
The long awaited and rescheduled guber Elections done come and go, results done already they ready for some States, many persons done table their opinions about the just concluded elections some say e dey fair done say violence full am, so even call for the cancellation,

Most Nigerians feel say Inec dey work for APC and Jagaban , and yesterday one politician cone out talk day Inec chairman dey work for Gov wike for rivers state , so mixed reactions done dey, people done die, dem kidnap some even bvas lost but surely the election done come and go but how we wan score Inec for this election wey dem conduct so.
Jump to: