Original Topic: [Guide] How to create your customized Bitcoin-Address (vanitygen) – step by stepAuthor:1miau
Maybe you don ever see a Bitcoin address wey the first letters na word, similar like this:
1
fudCz15sHGR8L2YQnaG4JVMjMQpaDo37
1
BTCTUnYLskK7N9nXb17wf6oVYMYrX5WHG
1
DogemNVw8AZnMf3cB4L1wijGnr9DVKzia
1
Fomo7V86nWrjdv6JzU7yavtp5hfzZWsZr
1
NewbornSeatQVC9vegVHnxVseNAhhxewb
(1)Na dis kind address Dem dey call vanity addresses and dey relate to theory part, E fit even de possible to de do am small small maybe na just chikini words na em no go dey, but e get the number of words wey you fit select. The reason be say you fit use am as tool and you fit also use am take create plenty address wey you like until you don see one wey be say you like how the letters take put together. The more wey the ones wey you wan use take long, E go dey hard make dem fit get am. E dey easy make dem find words wey dem use capital letter do dan the one wey Dem use small letters. For example now the word wey you wan use take start make e be 1Bitmover e go take like 2 months before you go even fit get 50% chance e mean say half of the chance. If na small letter you wan use take start am 1bitmover dis one go get 58 times e no fit dey possible.
(2)Dem go commot some letters because say Dem no dey part of Bitcoin addresses make e no con cause confusions:
l (letter lower L)
I (letter upper I)
O (letter upper O)
0 (number 0)
as well as all umlauts
Dem get plenty ways wey you fit use take do better Bitcoin address. But I go talk say make una use the obonge one wey dey with vanitygen, wey na samr7 for GitHub na em upload am. They still get plenty ways wey Dem dey give you for their website to take create vanity address, but I no go advice make una use that kind address for website. If another person join hand follow you create the address this one mean say (the website), dey get possibility say another person fit dey follow you use your own private keys. Matter like this been don dey before wey be say dem go steal Bitcoin from dat kind vanity address wey dem create for website because say
if another person Sabi your personal keys he fit go thief your Bitcoin from your wallet.
Abeg this one mean say make una dey use the original version wey you fit find for GitHub and you fit run am without Internet. Any website wey dey tell you say you fit create vanity address without key wey Dem split dey dangerous.
Na so e dey works:
1. Download vanitygen:You go first need go Github download the original files the real one from samr7 then you go con follow this link:
https://github.com/samr7/vanitygenYou go fit download the latest version:
vanitygen-0.22-win.zip
The latest version dey available here:
https://github.com/downloads/samr7/vanitygen/vanitygen-0.22-win.zip
2. Turn off internet connection while generating your Bitcoin addressYou fit still create vanity address when your Internet connection dey active, but for security matter you no need your Internet connection. E go even dey better and safe if you fit run am for computer wey you never connect to Internet before, but you fit choose for yourself how you take want make your security matter go take tight and how e go take dey high .E go de good make your security tight wella make dem no con get kasala sake of say dem hack am because e dey possible make your device dey under pressure.
If you want make your security tight wella you fit use this link take create your vanity address via
split-key.
3. Open the Command Prompt / PowerShellTo take start the command prompt you go need right click for your window screen for the left corner of your screen you go con select command prompt (administrator) or you go just use this key combination Windows+R
orIf you do am like that you fit skip #4 if you open the Command prompt directly from where you store your vanity files:
1. Go the folder wey you store your vanitygen/oclvanity.
2. Use Command prompt :press
CTRL +SHIFT+Right click for any empty space wey de within the folder (no be for the one wey you wan use or files oo),you go con click"open command window for here". The command prompt go con opens.
[1]3. Using Power Shell: Press SHIFT+Right click for any empty space wey de within the folder (no be the one wey you wan use ooo or files ), click" Open power shell window here".Now power shell (command prompt) opens.
[2]4. you fit start to dey enter the details wey you want directly with the way dey don take describe am for step 5.
(source: nc50lc [1], nc50lc [2])
4. Enter pathsThis one go make may the Command prompt window open and e go start to dey ready e self to take create Bitcoin address.
The paths go depend on where you don been store your vanitygen files .I don save am for
C:\ for the folder
BTC, subfolder
vgen. I go need enter this code to take find the vanitygen.exe file:
C:\WINDOWS\system32>cd/
C:\ >cd/
BTC/
vgenC:\
BTC\
vgen>
vanitygen.exeFolder BTCSubfolder vgenFile name vanitygen.exeYou fit try vanitygen.exe or you you go use the file oclvanitygen.exe, E Kuma dey your hand which one you wan use. The difference wey de between them be say vanitygen na CPU-based and oclvanitygen na GPU-based. For the 4-digit combine no matter weda e dey case-sensitive abi e no dey case-sensitive ,vanitygen dey enough for normal PC, oclvanitygen just dey faster if e dey work. For their technical background you go see more koko informate for their original article from 2011:
https://bitcointalksearch.org/topic/vanitygen-vanity-bitcoin-address-generatorminer-v022-25804.
Now e go look like this (with the paths wey match am for where you don been save your subfolders and files):
When you don enter the file name for the
.exe file wey de command prompt, you go con press Enter.
5. Creation of the addressNow you go dey see list wey dey show you plenty plenty ways of how you fit take do your own personal address:
They get plenty plenty comments, if you get time you fit try am but for this our test small commands go do. See this example now, I go show you how you go fit create Bitcoin address with this first letters "test", everything we dem write for small letter to take create Bitcoin address go start with
1test.
E get somethings wey you suppose put for mind: the more wey the beginning long and how e go take long to take search for am but e no fit dey possible if you use 4-digits, but e go take time more if e get plenty digits. For this matter now if you want make e get capital letter and small letter (case sensitive), e go take time pass if you do am wey e be e no need capital letter and small letter (case insensitive).
If e dey okay for you to use capital letter and small letter (TeSt, teST…), then you go add this ine to take change the command
-i (case insensitive).
To create the
1test address you go need follow this command:
-o C:\BTC\vgen\test.txt (saving the found private and public keys in a text file)
1test (the beginning wey you want)
Na weytin your command suppose look like be this now:
C:\BTC\vgen>vanitygen.exe -o C:\BTC\vgen\test.txt 1testIf you don ready wey you don do all this things wey dey up so then you go press Enter.
Now the tool go dey search for your public key wey dey correspond with the beginning wey you use (rate: 1.17 million keys per second). 50% for 2.4 minutes mean say e 50% possible to take find public key with
1test for the next 2.4 minutes. The 5.1% mean say de get possibility say de go fit find a hit fit the keys we de don be calculate.
If dey get hit ego show and e go stop to dey search. Another time you fit still add the comment
-k, to take search for plenty hits till you close your vanitygen.
Abeg still dey careful and no go overdo am. Dem fit go overtax your PC or laptop if e performance no dey high and e fit damage or destroy am. The example for this 4-digits beginning no suppose to be problem is, but the more wey you digit plenty the higher e go be to find your address.
And surprise surprise after small time now (around dah kind 2 minutes) vanitygen go dey successful and e go don find address:
1testgTQyiDMvtN67kj1w6R6J9dbo6bwd
Then follow the private key wey join:
5K9qCsz17Bd1UxtS7HQWc2rKz6ssNaBHMzK8pJvYiDGVYvUSEWg
The result go store as .txt file for our folder BTC:
Eeehhn me I no go use this
1test address because everybody don know the private key and dey fit steal Bitcoin from am. E mean say no go publish your key for anywhere.
6. Save your key wey you generate publicly and privatelySecurity always dey very important when e come Bitcoin matter. keep the private key wey you create safe because e just dey like password to your Bitcoins. you fit write am down for shit of paper, store am for place wey safe and save am too for USB wey you dey only use for your private keys.
7. Done! Now wey you don create your Bitcoin address successfully. If you wan enter am (like via Electrum) you fit look
here. make sure say you test the address before you send big Bitcoin to am. They no get way to take find your private keys back if you do mistake.
To add to this one I don create another vanity address but I no go tell Una the private key:
1miau7e4tFSAGR4TkAJ8n32UMm2yLB9EH
If you like you fit post your own personal vanity address for here (but Abeg
no do am with your private key if you dey plan to use am).
© 1miau
11.01.2019
Additional links:
Security advice from LoyceVVanitygen: Vanity bitcoin address generator/miner release 2011 [v0.22]Rare address hall of fame
(1) generated by LoyceV(2) on hardware of LoyceV
Update 04/04/2019:
Member
Jean_Luc been developed another vanity-address-generator con published am for GitHub:
https://github.com/JeanLucPons/VanitySearchE dey very very fast pass vanitygen and e dey supports besides P2PKH legacy addresses (1..) also SegWit addresses P2SH (3...) and bech32 (bc1q...).
You fit go check he do announcement on Bitcointalk here:
https://bitcointalksearch.org/topic/vanitysearch-yet-another-address-prefix-finder-5112311.