I agree with some of the things wey you say but I go just commen on some because some mentality don dey change as people don begin understand one or two things differently.
(4) When you get rich,people say you have a secret bedroom where noone enters.
This one don dey change as people don dey see say no be really say na secret room for juju stuff but either for comfort and relaxation, study room and room to do some other legit business online.
(5) When you become old you are suspected to be a witch.
This don begin change
(6) When you take a bath,they will ask you if you are going somewhere.
This one too don begin change with the rate of fine boy and girls wey dey baff up stay back home doing legit things, if you know you know.
(9) No natural death occurs in Africa.Your enemy is always the cause.
People don begin change here too because of the rate of terminal diseases now and organ failure. People outside the family even know certain disease or sickness wey other people dey carry waka because dem dey meet dem for hospital, so person no go just come lie say person no sick just die. People outside and on internet get information wey we no even sabi.
(10) Counting money after withdrawing from the ATM.
Na mostly old people fit still dey do this one. Majority of the young people understand better.
(12) Removing shoes when walking in the mud and entering the house.
So you want carry portorportor enter house abi.
(13) There are some special parts of the chicken meat that are reserved for the husband e.g gizzard.
Some house no dey do am again especially enlightened homes wey still understand say children need egg more than adult. That reminds me, you fit add this egg stuff join.
(14) Buying new clothes when there is a festival
This is changing with the rate of poverty too, some families no dey send again.
(15) When one is given a microphone,they first blow air into it or tap it with a finger to test whether it is working despite the previous user having used the same microphone.
Ha... Guys wey dey handle mic now don plenty so that is fading off because DJ self go don taste mic for your front before you collect am.
(17)Looking left and right when crossing one way road.
Na who want die like that. No be even for one way self, even for better express. You know for naija everything possible.
(19) Reserving a special chair in the house for the husband.
Na like chair wey go face visitors mostly. I know say some house still dey do am especially where the father is seen as demigod
(20).Feeling proud when sitting next to a white person in a bus.
Back then, oyibo no even dey again for naija. Na we dey go meet dem for their country home.