Author

Topic: Hot News on Bitcoin 🔥 (Read 69 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 541
Top Crypto Casino
December 21, 2023, 07:43:48 AM
#9
~~~

He don finally edit him post out reference link.

I nor know how or Watin him Dey reason sha, why he nor just put the link the first time? Why he be say nah after dem don report he account nah him kon know say he wan go put the link for he tread,,, hopefully they don’t ban his account make we observe whether he go change his way or whether he go still continue for him lazy behavior.

Wetin nor be your own if you wan use an for public, make sure you put something(source link) wey dem go fit take recognize easily say truly nor be you get and you nor hide am from people to know. If you Dey claim knowledge wey you nor get, he go add you to grow for this forum @Op and if then mistakenly ban your account he go hard you to come back to the forum because no one should show you mercy if they discovered that you’re evading a ban.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 21, 2023, 02:50:42 AM
#8
Bitcoin is becoming something else now
Bitcoin Will Climb 30% After ETF Approval, Then Drop To 37K Afterward – Analysts
The potential of Bitcoin for a significant price shift is under scrutiny as Jon Najarian, a seasoned options trader, shares insights on the market. He specifically looked into the possible impact of a spot Bitcoin ETF.
He believes that the introduction of such an ETF could trigger a substantial surge in the top crypto, estimating a noteworthy 25% to 30% increase within a brief two-day period. Do you all think this is a good idea
Op, most people dey aware say the approval of the ETF will make Bitcoin increase in price because na big adoption for Bitcoin. We no too need thread like for here because we are not day traders. We are all here to learn about Bitcoin and also invest in Bitcoin for the long term if we have the money to invest in Bitcoin.
Quote
I go still feel say we sopoz easy pressure. This guy nah person wey dey anxious to feel among for here nai make you dey see am dey drop updates wey get comma.
 I no dey side the guy but you get proof say nah ban evasion be this?
Yes, e don plagiarize which is intolerable but way dey to PM the guy tell am wetin to do...
Brother, next time if you see something like this no go advise say make them pity the person before people go think say na your alternative account or say you dey support bad thing for the forum. You don use your eye to see say the guy don fall the law wey be plagiarism, and for here once you are caught plagiarizing there is no forgiveness and only one thing will happen to the person's account which is ban. What if people for here pity the guy as you advised? and other people from other countries who are top-ranked members come see the proof of the plagiarizing, and the guy's account in question come still dey active, that one go put our local board for trouble say we dey see people wey dey plagiarism they cover them up.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
December 21, 2023, 02:19:12 AM
#7
Yes, e don plagiarize which is intolerable but way dey to PM the guy tell am wetin to do...

I be wan chill, for d guy o boss. But I con see say Dem don first report d guy for plagarism thread https://bitcointalksearch.org/topic/m.63310360 . So dis wan no be e 1,2,3 plagarism and I sure say if we check he post history, plagarism go many put. I know say e good to show mercy o but if we continue to dey hide dem for here, Dem no go learn anything but continue dis act and think say na so e dey be nothing dey sub.

 
I no dey side the guy but you get proof say nah ban evasion be this?

E no VA evade ban, but we no say no be new thing for people Dem to create new account after Dem don collect ban. So I just dey tell am say if e don create new wan, make e use e head.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
December 21, 2023, 01:56:24 AM
#6

I guess all members will agree now why he should have been reported at first glance?

Omo, for this mata, I hands off. Nai be the thing wey we dey tok for here na; you go see newbie go introduce dis sef finish, ask for guidance on how to role for this place yet them go end up falling theire hands. Yes, @Teamsherry do fail law, and it's left for the big guns to take action but I go still feel say we sopoz easy pressure. This guy nah person wey dey anxious to feel among for here nai make you dey see am dey drop updates wey get comma.
 I no dey side the guy but you get proof say nah ban evasion be this?
Yes, e don plagiarize which is intolerable but way dey to PM the guy tell am wetin to do...
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
December 21, 2023, 01:46:49 AM
#5
So far, after the warning from your previous threadhere on the local board, which was termed plagarism and the local board members showed pity on you and decided to cover up. You still decide to plagarise ones more.

https://bitcoinist.com/bitcoin-will-climb-30-after-etf-approval-analyst/

Well I guess you won't be having a third chance mate as it has already been reported for plagarism which is the official rule 33 of Bitcointalk. You actually already broke rule 12 and might also break rule 25 but when you do, you will then make sure to obey some of the rest rules of Bitcointalk.


12. No duplicate posting in multiple boards (except for re-posting topics in the local language boards if they're translated and re-posting marketplace topics in the altcoin boards if altcoins are accepted).

25. Ban evasion (using or creating accounts while one of your accounts is banned) is not allowed.[e]

33. Posting plagiarized content is not allowed.[e]

Maybe next time you will have to read the rules of the forum pretty well to avoid plagarising the local board.

I guess all members will agree now why he should have been reported at first glance?



full member
Activity: 504
Merit: 198
My privacy, my right.
December 20, 2023, 07:21:18 PM
#4
This one no be idea nah speculation and normally for this bitcoin space everybody get right to speculate the price of bitcoin as him feel am or abi I go say onto him analysis.No be news again say ETF approval to lead t a surge in bitcoin price but for person to say the price go fall back to $37k nah just how I no wan comprehend cos with the institutions wey go enter bitcoin market as per this ETF addition to the halving next year wey we don already see am as bullrun year I no see anytin way go make this man analysis or speculation hold water at all.. Even say bitcoin price go drop afterwards, inno go drop so drastically or significantly below this current ATH that's after the next ATH go don take place.
jr. member
Activity: 76
Merit: 3
December 20, 2023, 07:01:57 PM
#3
Bitcoin is becoming something else now
Bitcoin Will Climb 30% After ETF Approval, Then Drop To 37K Afterward – Analysts
The potential of Bitcoin for a significant price shift is under scrutiny as Jon Najarian, a seasoned options trader, shares insights on the market. He specifically looked into the possible impact of a spot Bitcoin ETF.
He believes that the introduction of such an ETF could trigger a substantial surge in the top crypto, estimating a noteworthy 25% to 30% increase within a brief two-day period. Do you all think this is a good idea

Wetin you dea post like dis don many for this platform abeg make we try dea create better thing come board, because this always repeating same thing e dey tire us oo
We need some thing new special at list.

All this kind news, we dey see all the time, shabi the people wey make that prediction na human being like us, the news by right no suppose to be wattin go influence our decision to buy or sell,

Naso oo because na bitcoin matter we need make him de come board at list that one go dea guide us as newbie if we dea see different stuffs wey go help by buying and selling rate

full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 20, 2023, 08:58:34 AM
#2
All this kind news, we dey see all the time, shabi the people wey make that prediction na human being like us, the news by right no suppose to be wattin go influence our decision to buy or sell, if na news dey influence person e just mean say that person na still baby investors, though the news na positive one but we nor be trader wey dey follow after news for any stock wey wan get better spike of skyrocket. Wattin I dey try talk na be say Bitcoin na investment wey na long term be the main Koko, and when you dey into long term you nor need news again or prediction from human being wey be like you wey fit make errors for em predictions.

However I nor shock me say Bitcoin go still increase because na wattin everybody dey expect now, as we don dey very close to the halving.
member
Activity: 168
Merit: 50
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 20, 2023, 05:57:52 AM
#1
Bitcoin is becoming something else now
Bitcoin Will Climb 30% After ETF Approval, Then Drop To 37K Afterward – Analysts
The potential of Bitcoin for a significant price shift is under scrutiny as Jon Najarian, a seasoned options trader, shares insights on the market. He specifically looked into the possible impact of a spot Bitcoin ETF.
He believes that the introduction of such an ETF could trigger a substantial surge in the top crypto, estimating a noteworthy 25% to 30% increase within a brief two-day period. Do you all think this is a good idea. 

https://bitcoinist.com/bitcoin-will-climb-30-after-etf-approval-analyst/
https://bitcoinist.com/bitcoin-will-climb-30-after-etf-approval-analyst/
Jump to: