You see dat side wey I reason so, dat's just how Bitcoin benefits d common man. Satoshi reason how things dey go come know say if him no interval dis government people go kill the common man finished, make we leave the currency aspect of Bitcoin focus on the investment aspect small. If no be Bitcoin wey open way for people to fit dey invest from anywhere without having to pass through all those hard steps to be accredited as an investor, plenty people no for fit dey see food chop from online investment. All this elite man dem dey get first hand information on which stock or shares go do well pass come buy am but the common man no dey get anybody wey go show dem way and when we dey buy na wey this first elite investors dey sell and cashout for our head but Bitcoin come change everything, even to trade now you no need brokers again, you fit do direct trading for decentralized exchange all because of Bitcoin introducing the industry to us.
Na when we enter the currency aspect, we go see say the common man no need to pass through all the banks wahala wey dem go always favour the elite men dem over us. Now you fit dey your house dey run oyinbo transaction without waiting on an approval from any bank wey go take more than 1-3 working days. Bitcoin dun make am the common man fit dey enjoy all those privilege wey na only elite people dey enjoy before and while e dey do all this one, the transaction come still decentralized on top wey mean say your transaction wouldn't be reversed just as bank transaction dey reversed. The main reason the government hate Bitcoin na because say dem dun see am say the cryptocurrency no be for dem but for the common man.